Air Peace, Senator Oshiomole kwanta - Wetin Aviation minister tok

Fotos of Senator Adams Oshiomole, Festus Keyamo and Air Peace aircraft

Wia dis foto come from, Adams Oshiomole/Facebook/BBC/Getty Images

Read am in 5 mins

Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don order aviation agencies make dem conduct investigation in di argument wey happun between Air Peace and Senator Adams Oshiomhole.

Di minister ask di avaiation agencies make dem no react but instead make dem try to hear from both sides.

Keyamo tok say im don dey in contact wit both parties and e don ask dem make dem stop di public accusations.

"I don further direct di relevant aviation agencies make dem thoroughly look into di issue, collect all available evidence and revert to my office so we fit deal wit di issue in such a way as to guide future conducts in similar situations," di minister tok for im X page on Friday.

On Wednesday, tori bin break say di politician forcefully block di entrance to di Zulu Terminal of di General Aviation Terminal (GAT) afta e come late for di terminal afta di scheduled departure time of im flight.

While reacting to di allegation, Senator Adams Oshiomole deny di information say im barricade di check-in entrance of di Murtala Muhammed Airport Terminal 1 (Zulu Hall).

Di Senator later deny di allegations for post on im Facebook page say im check-in online but dem tell am say di counter do close even though im enta 6:05 on Wednesday.

"I get dia about five minutes past six. Dem tell me say dem don close di counter. I tell dem, 'No, I don already check in.' I show dem di evidence of my online check-in. Even bifor den, dem don ask if I don check in, and I tell dem yes, and I no get luggage. dem look am but still dem tok say dem don close di gate. Meanwhile, I notice say dem still dey take in oda pipo," e tok.

"So I ask, 'How you fit close boarding for 6:30 flight at 6:05? Wetin be di purpose of online check-in, den?' If I know go through anoda check-in process, den wetin be di point of checking in online?"

Inside one trending video on Wednesday, Oshiomole call for di intervention of top officials from di airline. Although, di video no dey audible but di politician follow one official tok for di check-in entrance about im experience

While di entrance to di check-in remain closed and travellers remain stagnant on di queue, dem no fit move forward for dia boarding.

According to Air Peace statement on Wednesday, di airline tok say one prominent Nigerian politician disrupt dia airport operations afta im miss di flight scheduled for 6:30 am on Wednesday morning.

Di management of Air Peace tok say di politician arrive around 6:10 am for im boarding but di boarding process don close and di flight don dey set to fly.

Di airline tok say di politician allegedly resort to violence and physically assault dia staff and e even go as far as stopping dia passenger from gaining access to di terminal.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Di airline tok say dem swiftly seek oda alternatives to board affected passengers for dia flight.

Air Peace tok say dem go kontinu to stand for discipline, integrity, and respect for due process and "no individual, no matter how influential, dey above dis values."

Di Senator wey dey represent Edo North for di Nigerian Senate don explain say e no stop anytin.

"I no disrupt anytin. I refuse to let dem 'sort me out' while others bin dey stranded. Dem offer to help me once dem recognise me. I say, no help me, enforce my rights like every other Nigerian".

E also tok say di airline dey sell tickets on di spot for betweenn 200,000 and 300,000 naira and di airline dey do am to take advantage of di situation to discourage pipo wey don buy online and sell to pipo wey dey willing to pay more.

Senator Oshiomole tok say many pipo dey stranded except pipo wey fit afford anoda ticket.

'We no sell any ticket afta di closure of check-in' - Airpeace

Air Peace tok say na "deliberate falsehood" and im "lie blantantly" wen e accuse di airline say dem dey extort passengers.

Dem challenge Oshiomole make im provide evidence say dem dey extort passenger and none of dia staff extort any passenger for di airport.

Di arline tok say dem no sell any ticket afta dem close di check-in for dat flight and pipo wey fly wit dem on Wednesday don already buy dia ticket bifor di flight closure.

"In fact, no ticket was sold after the closure of check-in on that flight. Everyone wey fly buy dia ticket bifor di flight closure," e tok.

Airpeace tok say additional 30 seats dey empty for inside di plane, and e go dey in dia interest to carry Oshiomole and oda passengers wey miss dia flights but instead dem fly empty.

Di airline tok say Oshiomole start trouble and prevent di check-in process of oda flights while im also "deliberately instigate oda passengers against di airline."

"Again, our flight was neva overbook as some of im videos alleged. In fact, di aircraft take off wit ova thirty (30) empty seats. E dey in our interest to carry Oshiomhole and pipo wey miss dia flights for lateness on dis flight, instead of flying many empty seats; but we no go sacrifice our strict on-time performance for monetary gains," e tok.

"Na absolutely false say im offer preferential treatment and e dey fight for odas. Senator Oshiomole no dey fight for anyone. E enta di airport late and dem tell am say e come late.

"E den begin to start trouble. E jump on di baggage conveyor belt prevent di check-in process of oda flights. E also barricade di entrance gate and prevent access to di terminal. While e dey do all dis, e also deliberately instigate oda passengers against di Airline.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4