Meet Nigerian female pilot wey also be shoemaker

Wetin we call dis Video,
Meet Nigerian female pilot wey also be shoemaker
    • Author, Helen Oyibo
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Lagos

Nigerian pilot and shoemaker Tracy Olushola Atobatele dey inspire women say dem fit achieve anytin dem dream of.

For interview wit BBC News Pidgin, Tracy wey her friends dey call Captain Shoemaker, say na her neighbour teach am shoemaking.

About her piloting, she say a lot of pipo bin doubt am.

"Di way I dey treat flying be say if my papa and mama dey dis plane as I dey carry am go, how I go fly am?" she tok.

"If I know say I no feel alright, I no go go."

Filmed and edited by Monday Idara