Why plane crash for Toronto, and how everybody survive?
- Author, James FitzGerald
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
Authorities no report any deaths for di plane wey travel from United States wey turn upside down for Toronto airport and catch fireafta e slide along di runway.
E no dey clear wetin cause di incident, analysts dey suggest say weather fit don played a role, or di aircraft hit something.
Investigation still dey go on.
Wetin happun when di plane crash?
Di incident happun shortly bifor 15:00 local time on Monday (20:00 GMT).
E involve a model CRJ-900 plane, wey dey operate as Delta Air Lines flight DL4819.
Di aircraft arrive Toronto from US city of Minneapolis e bin dey carry 76 passengers and four crew members.
Dan Ronan, one journalist and pilot wey dey licensed by US Federal Aviation Administration (FAA) wey bin tok to BBC News say im observe as e land e be like say di plane hit di runway, den slide for some distance and den turn upside down.

Footage wey TMZ get show part of di aircraft wey catch fire as di landing happun. Firefighters rush to quench am.
Passenger Pete Carlson tell broadcaster CBC say na " very forceful event", as im remember di sound of "concrete and metal" for di moment of impact.
Im and odas on board bin dey suspended upside down for dia seats, wia dem release demsefs for di cabin ceiling bifor dem leave di aircraft.
All 80 pipo on board survive. 18 wunjure, out of dat number only small number of those wey wunjure dey serious.
Delta don promise to give more updates.
How plane dey turn upside down?
Di right wing fit don hit di runway or item, like light, Oga Ronan suggest.
Di weather fit also be issue. Di airport fire chief say di runway bin dey dry at di time of di incident.
Although airport authorities bin tok earlier say di recent heavy snow don stop, "frigid temperatures and high winds [bin dey] move in".
As di plane come in to land, air traffic controllers tell di pilots of 38mph (61km/h) gusts and the possibility of a "slight bump for di glide path", CNN report.
Di pilots appear to attempt wetin dey known as a crab manoeuvre, Oga Ronan tok. Dis involve to turn plane to face di wind, and den directly onto di runway at di last moment.
Marco Chan, a former pilot and a senior lecturer for Buckinghamshire New University for UK, agree say di aircraft bin dey bank to di right, and appear to make a hard landing – e mean a high rate of descent.
E be like e touch down wit one wheel first, Oga Chan tell BBC, wey fit don cause di landing gear to collapse on impact. Dis fit don make di right wing to hit di runway and cause di plane to roll.
How everybody inside di plane survive?
"Di koko of dis survivial of dis dey really amazing," Oga Ronan tell BBC, e point out say di aeroplane fuselage (body) stay intact.
Im also highlight di importance of di plane high-impact 16G seats, wia im say e dey" designed to absorb a great deal of punishment".
Oda commentators hail di importance of safety features. CNN analyst and former FAA inspector David Soucie say di plane bin break apart as e suppose to, wit di detachment of at least one wing stopping di fuselage from tearing apart.
Graham Braithwaite, professor of safety and accident investigation for di UK Cranfield University, say planes also dey designed so dat air passengers wey dey involve for di accident no go hit things we go likely cause injury.
"Even di design of di seat back or di tray table dey all part of wetin we consider to make di survivable space," Im tell BBC. "Di seatbelt wey pipo get dey so important – dat na di ultimate tin wey dey stop pipo from flying around di cabin like dis," im add.

Many pipo praise di flight attendants for di sharp -sharp way wey dem take comot everybody for di flipped aeroplane.
Airport chief call di emergency crews for di ground "heroes" sake of how dem reach di crash site in a matter of minutes.
Oga Carlson say di passengers demselves bin work togeda very effectively. "Wetin I see be say evri body for di plane suddenly become very close in terms of how to help one anoda, how to console one anoda," im tok.
Which oda plane crash wey don happun recently?
Dis mark di fourth major air crash for North America in less dan a month, and oda recent incidents dey under investigation.
- All 67 pipo on board one passenger aeroplane and military helicopter die afta di two aircraft collide for mid-air near Washington DC on 29 January
- Seven pipo die on 1 February wen one medical transportation plane wey carry six pipo crash for Philadelphia. Anoda pesin die for ground
- All 10 pipo die wen one small plane come down for Alaska on 6 February
Those incidents follow anoda high-profile crash for South Korea for December, wey 179 pipo die.
Despite dis, experts say air travel still remain safe - and increasingly so.
Di US National Transportation Safety Board (NTSB) say for 2024 na 257 fatal accidents happun for US, compared wit 362 for 2014.
Additional reporting by Tom Joyner and Josh Cheetham












