Rules for passengers inside plane or airport for Nigeria

Pesin stand in front of Ibom Air

Wia dis foto come from, Ibom Air/X

Read am in 5 mins

Di Federal Airports Authority of Nigeria (Faan) don advise pipo wey wan travel by air to obey all established airport and airline regulations, as di safety, security and comfort of all airport users na dia top priority.

Faan also advise passengers to familiarise themselves wit di Passengers' Rights and Responsibilities, and Airlines Obligations wey di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) publish plus di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) Bye Laws.

Dis advisory dey come afta one video wey go viral show one incident wey involve one female passenger - Comfort Emmanson or Comfort Bob and Ibom Air hostess and airport security.

Ibom Air wey later address di issue for statement confam say di incident happun on Sunday, 10 August, and di passenger wey dem identify as Ms Comfort Emmanson bin board dia Uyo–Lagos and her conduct bin pose serious threat to di safety of dia crew, passengers, and aircraft.

Dem say Ms Emmanson bin attack dia hostess sake of say dem instruct her to switch off her mobile phone wey dey in line wit standard aviation safety procedures, wey she no gree do until di Pilot-in-Command make di announcement, afta which one fellow passenger wey sidon beside her collect di phone and switch am off. Action wey lead to gbasgbos from Ms. Emmanson.

Authorities later detain her and charge her to court after di incident.

Comfort Bob never tok her own side of di tori.

Faan for dia reaction, condemn di action of Ms Emmanson and say di Faan Aviation Security (AVSEC) team don since intervene and don hand am ova to di Nigerian Police Force for further investigation and prosecution.

"Di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) don note wit concern di increasing frequency of unruly behaviour by some passengers at our airports. We wish to categorically state say dat kain behaviour dey entirely unacceptable within di framework of civil aviation and no go dey tolerated.

Faan also add say dem dey review dia protocols around restraining and prosecuting of passengers in line wit di Airport Approved Security Programme and relevant laws.

Also, di Minister for Aviation, Festus Keyamo wey condemn wetin Ms Emmanson do tok say di police don arraign her on Monday morning for di Ikeja Magistrates Courts for criminal offences and dem don keep her for Kirikiri Prisons as she no fit provide adequate sureties for court.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Rules for passengers for airport according to NCAA regulations

For genuinely aggrieved passengers, Keyamo say clearly laid-down remedies dey to address dem as trying to take laws into pesin hand fit lead to consequences.

BBC News Pidgin reach out to di Director, Public Affairs & Consumer Protection for di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA), Michael Achimugu on wetin be di aviation regulations wey dey guide airline passengers, and e list di offences wey include but no dey limited to di following;

  • Smoking for inside plane or for non-smoking area of di terminal building na offence.
  • Use of mobile phones and/or oda communication/electronics gadgets inside plane without di approval of di aircraft Commander na offence.
  • Fighting or oda disorderly conduct for inside plane or for di terminal building na offence.
  • Any conduct/act wey constitute nuisance to oda passengers na offence.
  • Disobedience of lawful instructions issued by di aircraft commander, flight crew, cabin attendants, check-in staff and/or security screening staff na offence.
  • Any conduct wey endanger or wey dey likely to endanger di safety of flight operations na crime.
  • Tampering wit smoke detectors and oda aircraft equipment na crime.
  • No pesin dey allowed to carry, or attempt to carry, weapons, prohibited items or oda dangerous devices for body, or for inside im load for plane unless e dey authorized for transport.
  • No pesin go dey allowed to enta security restricted area or sterile area unless di aviation security officer don screen and clear am for entry.
  • Na crime to take pictures or videos for restricted areas for di airport terminal
  • Carry Prohibited Items:
  • Items like sharp objects, flammable liquids, or certain electronics dey restricted and security go seize am.

Di Nigeria Civil Aviation Authority regulations allow di aircraft commander or airport authority to take di necessary measures wey include restraint wia necessary wen dem see any passenger wey dey misbehave on board or for di terminal building.

Air traveller offences and dia penalty

NCAA also list offences and di penalty for inside airplane or for terminal area.

  • Operating a portable electronic device in violation of crew directives go attract - Maximum civil penalty
  • Drinking alcoholic beverages wey no be di operator serve - Maximum civil penalty
  • Interference wit crew member go attract - Maximum civil penalty
  • Physical assault or threat to physically assault a flight or cabin crewmember go attract - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral
  • Physical assault or threat to physically assault an individual wey no be crewmember - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
  • Traveller wey act in a manner wey pose imminent threat to di safety of aircraft or oda individuals on di aircraft go face - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
  • Smoking for area wia dem write or put "No Smoking' sign - Maximum civil penalty.
  • Smoking for aircraft lavatory - Maximum civil penalty.
  • Tampering wit smoke detector - Minimum to maximum civil penalty and/or criminal referral.
  • Refusal to fasten seat belt for wia seat belt sign dey - Minimum to moderate civil penalty.