Di proposed UK asylum system reforms wey Home Secretary Shabana Mahmood announce

One police officer escort one group of pipo dem reason to be migrants ashore from di Dungeness lifeboat for Dungeness, Kent

Wia dis foto come from, PA Media

    • Author, Sam Francis
    • Role, Political reporter
  • Read am in 5 mins

United Kingdom Home Secretary Shabana Mahmood don unveil wetin dem dey reason to be di biggest changes to tackle illegal migration "for modern times".

Di package, follow di stricter approach wey di Denmark centre-left govment bring wey make refugee status temporary.

UK don narrow di appeal process and threaten visa bans on countries wey block return attempt of dia nationals.

Dis na wetin we know:

Refugee status go become temporary

Pipo wey UK grant asylum go only dey allowed to stay for di country temporarily, dem go dey review dia status every 30 months.

Dis one mean say, dem go fit return pipo go dia home country if dem see say e dey "safe".

Dis scheme na di same wit di approach for Denmark, wia refugees get two-year permit and must reapply wen e expire.

Refugees go also need to be resident for UK for 20 years bifor dem go fit apply for permanent residence or indefinite leave to remain – dis one go up from di current five years.

Di govment go also create one new "work and study" visa route and encourage refugees to find employment or begin education in order to switch enta dis route and earn settlement more quickly.

Only those wey dey dis work and study route go fit sponsor family members to join dem for UK.

Human rights law reform

Di home secretary dey also plan to end di process wey dey allow multiple appeals for di cases of asylum cases and replace am wit one single, consolidated appeal wia dem must raise all grounds once.

Dem go create one new independent appeals body, staffed by trained adjudicators and supported by early legal advice.

To do dis, di govment go introduce one law wey go change how dem dey apply for right to family life under Article 8 of di European Convention on Human Rights (ECHR) for migration court cases.

Only those wey get immediate relatives, like children or parents, go fit remain for UK for future.

Dem go remove foreign offenders and pipo wey enta di country illegally.

Di govment go also narrow di application of Article 3 of di ECHR, wey ban inhuman or degrading treatment.

Ministers say di current interpretation of di law dey allow multiple appeals against refusals for asylum – wey include serious criminals wey don block dia deportation sake of healthcare issues.

Dem go tighten di Modern Slavery Act to stop last minute trafficking claims wey dem dey use stop removals by requiring asylum seekers to disclose all relevant information early. Dem go treat any information wey dey disclosed later as less credible.

Ending housing and financial support

Mahmood go cancel di legal duty to provide asylum seekers wit support, and dat go end guaranteed housing and weekly pay.

Support go still dey available for "those wey dey very helpless" but dem no go support pipo wey get permission to work but no gree work, and from pipo wey break di law or disobey removal directions.

Dem go also deny support for those wey "deliberately make themselves destitute".

Asylum seekers wey get assets go dey required to contribute to di cost of dia accommodation.

Dis one dey similar to Denmark approach wia asylum seekers must use dia savings to pay for dia accommodation and authorities fit seize dia assets for border.

UK Home Office sources don rule out seizing sentimental items like wedding rings, but Home Office Minister Alex Norris don suggest say cars and e-bikes fit dey targeted.

Di govment bin previously promise to end di use of hotels to hold asylum seekers by 2029, official figures show say e cost di govment £5.77m per day last year.

Di govment also dey plan to end di current system wia families wey dem deny dia asylum claims still dey receive housing and financial support until dia youngest child turn 18.

Ministers say di current system don create one kain encouragement to remain for di UK without status. Instead, dem go offer families financial assistance to return voluntarily, but if dem refuse, enforced removal go follow.

Alongside tightening access to refugee status, UK go create new legal routes to di di country, wit annual cap on numbers.

Under di changes, volunteers and community groups go fit sponsor individual refugees, wey be like di "Homes for Ukraine" scheme wia Britons bin host Ukrainians wey bin dey run from war.

Govment go also expand di work of di Displaced Talent Mobility pilot, wey dem set up for 2021, to encourage businesses to sponsor at-risk pipo from around di world to come UK to help fill skills gaps.

Di home secretary go set annual cap on arrivals via dis routes, based on local capacity.

But those wey dey come di country on legal routes go be on a streamlined ten-year route to settlement.

Visa bans

Di Home Secretary say UK go apply Visa penalties to countries wey fail to co-operate wit di returns policies, wey include one "emergency brake" on visas for countries wit high asylum claims until dem take back dia citizens wey dey for UK illegally.

UK don already identify three African countries wey dem get plans to penalise if dia govments no improve co-operation on removals.

Di govments of Angola, Namibia plus Democratic Republic of Congo get one month to start co-operating before dem impose sanctions, Home Office tok on Monday.

Increased use of technology

Di govment dey also plan to roll out new technologies to strengthen enforcement.

Trials of AI-driven technology to verify di age of asylum seekers, particularly those wey dey claim to be children.

Alongside dis, di govment dey plan to introduce one digital ID by di end of Parliament.

Dis go allow more accurate right-to-work checks by employers and e go make am harder for illegal workers to use fraudulent documents, di govment argue.