Nigerian man wey rape teenager for UK go spend 10 years in prison

Mugshot of Chiemka Okoronta. Im wear grey sweatshirt and get short black hair and beard.

Wia dis foto come from, West Yorkshire Police

Wetin we call dis foto, Bradford Crown Court sentence Chiemka Okoronta, wey dey 29 years to 10 years in prison
Read am in 3 mins

One "dangerous sexual predator" wey rape one stranded teenage bus passenger for West Yorkshire dey go jail for 10 years.

Chiemka Okoronta and di girl wey dey 17 years bin dey one night service wey unexpectedly stop for Morley, Leeds, and both of dem need to transport diasef home to Bradford on 25 March.

Di 29-year-old postgraduate student bin trick her to share di taxi wit am bifor e lure her enta im house.

Im attack her inside di toilet wey bin dey locked, na wetin dem tell di Bradford Crown Court.

Di court tell Okoronta, wey dem convict of multiple rape offences, say im dey likely to face deportation sake of di sentence.

Okoronta, wey originally from Nigeria, must also serve three years on extended licence and register as sex offender for di rest of im life.

Dem tell court say di teenager phone bin die afta she come down from di bus, and Okoronta bin offer to share di taxi to Bradford Interchange wit her.

Prosecutor Graham O'Sullivan tok say instead of di taxi to go dia destination, di vehicle instead go di defendant flat, and e convince di teenager to enta inside and e kon lock her inside toilet.

Sake of di attack, di girl stop pipo wey dey waka pass for outside and use dia phone to call police.

For di victim impact statement wey dem read out for court, di girl tok say: "Dis incident don turn my life upside down.

"I dey get flashbacks of wetin bin hapun to me, I dey get nightmares - one minute I go feel fine and di next minute evrtytin go come back."

Judge Sophie McKone tell Okoronta: "I dey satisfied say wen you bin ask if she bin wan share your taxi to Bradford you bin formulate plan wey go get her back to your flat wia you fit rape her.

"You forge reason for her to come into your flat."

She add: "I dey clear, you be, dangerous sexual predator."

Det Con Sue Sutcliffe, of West Yorkshire Police, say: "I go like to commend di victim for dis case for her strong bravery to come forward sharp-sharp to report dis horrific crime.

"I go beg anybody wey don be victim of sexual offence, to report am to us so we fit take action."