Justice for Uwa: Rape & murder case of Uwavera Omozuwa lead to oda justice movement for victims in Nigeria - See wetin we sabi

Barakat, Uwa and Tina
    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 4 mins

Plenti - plenti justice movement plus call for justice na im don dey trend for Nigeria since Monday 1 June sake of di rape and murder cases wey happun recently to different women.

Na at least seven hashtags don flood social media to call for justice from Nigerian authorities to mostly cases of Rape and sexual violence wey don happun.

Some of di hashtags include #JusticeForUwa, #JusticeForTina, #justiceforjennifer, #justiceforelizabeth, #JusticeforAda and di recent one on Wednesday na #JusticeForBarakat plus odas.

Dis movement to call for justice don also lead to oda movement for call to action like; #SayNoToRapist, #NoToRape, #EndRapeCulture, #JusticeForOurGirls and plenti odas.

BBC Pidgin torchlight some of di story behind di hash tags:

#JusticeForBarakat

Barakat

Today, Nigerians wake up to di shocking news of one young girl, Barakat Bello wey attackers rape and kill for her own house for Ibadan, Oyo state south west Nigeria.

Her family tell BBC say dis incident happun yesterday afternoon for Ibadan..

Barakat Bello wey be 18-year-old, na 100 level student of Federal College of Animal health and production (FCAHPT), Ibadan.

Wetin we call dis Video, JusticeforBarakat: Her loved ones share dia pain

Barakat bin come back home from school afta di lockdown as e school don close, Her family tell BBC Yoruba .

Di parent bin comot and leave her for house with her younger brother. Di younger brother come comot from house go buy sometin and wen e come back, e see Barakat for pool of blood for dia bathroom. E come shout out for help.

#JusticeForTina

Ezekwe Tina

Wia dis foto come from, OworoTV

Tina Ezekwe na di 16 year old girl wey one police officer shoot for Iyana Oworo area of Lagos State, South West Nigeria.

Tina come later die four days afta. Report say di officer mistakenly shoot her as im dey try arrest driver wey break lockdown curfew rules.

#JusticeForUwa

Uwavera Omozuwa

Wia dis foto come from, uwavera omozuwa/facebook

Uwavera Omozuwa na di 22-year-old Microbiology student of University of Benin wey some bad pipo attack and rape inside one Redeemed Christian Church of God for Ikpoba Hill, Edo state, Nigeria.

Report say Uwa bin go read inside di church, wen di attack happun and three days later she come die for hospital.

#justiceforjennifer

For April, one a gang of five men attack and rape 18-year-old girl wey dem call Jennifer for Kaduna, northern Nigeria.

Di case come public afta relatives of Jennifer wey dey fear say di men go escape justice, release one video online as family members dey comfort her and pipo share di video plenti plenti times times.

Police later say dem arrest two men for rape and dem dey look for three oda suspects, Aljazera report.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

#justiceforelizabeth

#JusticeforOchanya

Elizabeth Ochanya Ogbanje na di small girl wey one papa and im pikin sleep wit from wen she dey 9 years all di way till di girl reach 13 years before di girl come get Vesicovaginal fistula (VVF), die.

Elizabeth die for Benue State Teaching Hospital on Thursday 18 October, 2018 as she no survive di serious VVF and oda complications wey happun to her.

Nigeria activists, students, women groups, International Federation of Women Lawyers (FIDA) and right groups do serious protest on top Elizabeth Ochanya mata so dat she go get justice.

Court for Makurdi dey hold two men wey dem accuse say na dem rape di 13-year-old girl right from wen she dey 9 years old.

#JusticeforAda

Many Nigerians still dey call for justice for one 13-year-old girl, Ada wey dem say one 33 years old man rape and give belle for Enugu state, South East Nigeria.

One pesin for Twitter share di story and call on Nigerians to help save di girl and add say she still dey alive.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Oda pipo for twitter reply to di tweet while some odas still continue to tweet wetin dem sabi about di tori of di 13 years old and call for justice.

Wetin we call dis Video, Justice for Tina: 'She be 17 going on 18 and bin get many dreams'

Nigeria police, President Buhari, plus some state goment don promise to investigates some of dis rape and murder cases and fish out pipo wey dey responsible for am.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Civil societies groups, human right group, activist and feminist group don also hala and call for justice to all dis attacks.

Di movement still dey go on strong for social media as dis women neva still get di kain justice wey pipo dey look for. Although Police tok say dem don arrest one suspect on top Uwa case, while Lagos State police tok-tok pesin, Bala Elkanah say dem don arrest di officer wey kill Tina Ezekwe and detain am for di Headquarters.

For now, di kontri police don give out phone numbers wey victims of sexual abuse fit call to complain; 08039397951, 08057000001 and 07056792065.