Justice for Tina: 'She suppose write WAEC dis year but now dem don kill am'

Wia dis foto come from, OworoTV
Nigeria police say dem don arrest di police officer wey shoot one 16-year- old girl die for Iyana Oworo area of Lagos State, South West of di kontri.
Tina Ezekwe wey be 16 year old die on Thursday, four days afta di officer mistakenly shoot her as im dey try arrest driver wey break lockdown curfew rules according to tori.
One local tori blog, OworoTV bin post di video of Tina on Monday, where she lie down for ground after di alleged shooting.
For di video, we hear pipo dey shout her name, Tina as dem carry am from ground dey run. E be like say dem dey rush her go hospital.
For tweets on Thursday, dem later share screenshots of whatsappchat wey confam say Tina don die as her family no fit afford moni for treatment.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
How Tina take die
One eyewitness tell BBC say, di policeman wey shoot di girl "don drink and e dey demand for 200 naira to free di bus driver."
E add say, as di driver no gree give dem di moni, dem shoot di driver, come arrest di conductor.
"As we gather to harass di police say why dem shoot di driver, he come begin shoot at di crowd, na dat time one bullet come hit Tina." di eyewitness tok
End of Di one wey oda users dey read well well
Ezekwe King wey be Tina brother follow BBC Pidgin tok wetin happun on Monday night, di night wey police shoot Tina.
He say around 9pm Nigerian time, one police man bin dey try arrest bus driver wey break lockdown curfew rules.
"Dem shoot di driver come arrest di conductor, but we no know if di driver die, dem carry am comot,
Tina na di last pesin to run comot because she bin dey our mama shop where she dey sell pepper and fruits.
"Dem shoot my sister, I tell di police man say im don shoot my sister but dem no answer me."
"I quickly rush Tina go hospital dat night, dem give us first aid but dem tell us say she don lose too much blood, na di hospital she later die on Thursday."
King say Tina dey outside wia she dey sell market for dia mother. "Tina na gentle pesin, she no dey find anybody trouble"
"We be six before, now we don turn five."
"Tina suppose write her WAEC dis year but now dem don kill am." King tok as im dey almost cry.
"My sister get big dreams but she never tell me wetin she wan do for future but I sabi say she get big dreams.
Na only five of us come remain now wey she don go plus my papa and mama." King add
One eyewitness, Ruka, tok say di police wey shoot Tina fit don dey drunk because he bin threaten to shoot her again and shoot himself.
Wetin police tok
Di Public Relations officer of di Lagos State police command, Bala Elkanah tok say dem don identify di 'killer cop' arrest am and detain am for di Headquarters.
"He go face di full weight of di law. Justice go surely prevail. We go update members of di public on di outcome of di investigation." he add.
Dis no be di first time wey members of public don demand justice for di killing of citizens by di Nigerian Police.











