Ochanya: See as pipo enta road to protest for justice for di 13-year-old rape victim

Court for Makurdi dey hold two men wey dem accuse say na dem rape di 13-year-old girl.

Protesters dey hold sign
Wetin we call dis foto, Plenti pipo for Nigeria capital, Abuja enta road on Thursday 25 October to shout say dem want justice for 13-year-old Ochanya Ogbaje wey just die.
Protesters
Wetin we call dis foto, Di girl die for Benue State Teaching Hospital as she no survive di serious Vesicovaginal fistula (VVF) and oda complications wey happun to her. One Upper Area Court for Benue don hold two men wey dem accuse say na di rape wey dem dey rape di girl since 9-years-old na im cause di condition wey come kill her so.
protesters dey tok say we must hand the rapists
Wetin we call dis foto, Na di body of women lawyers (FIDA) and di girl mama carri di mata go police station. Afta investigation, police arrest di man and im son wey dem say na dem dey molest di girl.
Sack the Lecturer
Wetin we call dis foto, Ochanya Ogbaje die for hospital on Thursday 18 October for di teaching hospital for Makurdi
Women with signs
Wetin we call dis foto, Many pipo, especially women and old students of Federal Government Girls’ College Gboko, cari vex go Abuja say dem no go gree if goment no do justice to di mata
Women dey wear plack for di protest
Wetin we call dis foto, As dem dey shout 'Hang the rapist', di women say make goment put mouth for di mata