One of di boys inside di Ghana gang rape video don chop 7 years for prison

Wia dis foto come from, Reuters
Court for Ghana don sentence one of di five boys wey dey inside di viral gang rape video to seven years for prison.
Dem bin post di video for social media for December, 2017.
Inside di video, one boy hold di lady for di bed as im paddies dey take turn rape am.
But di oda boys wey dey inside di video collect dia own sentence from lower court as dem bin no reach di age for di senior Ghana court.
But di court sha find dem say dem guilty for di mata.
Pipo vex well-well afta di video start to spread for WhatsApp and Facebook. E reach sotay police start to warn say make pipo no dey share di video.
Rape cases no strange for Ghana but na how pipo don start to dey film and post am for social media dey shock pipo.









