Why #JusticeforOchanya dey trend for social media

Wia dis foto come from, Supplied
Di death of 13 years old Ochanya Ogbanje don spark anoda rising anger among Nigerians wey dey demand justice about seven years afta she die.
Her tori don begin dey cause serious tok-tok for social media since she die for October 2018, afta di tori say dem rape her.
Plenti Nigerians don take to social media to start di hashtag #JusticeForOchanya to demand justice for di small girl.
Ochanya bin go live for her aunty house, Felicia Ogbuja wia she bin also dey go school.
She be five years old wen she start to dey live wit di Ogbuja family for Benue State, north central Nigeria.
Di plan why she go live for dat house na to go school, according to one interview wey she grant tori pipo bifor she die.
Na for dia Ochanya bin later die sake of di several rape wey di culprits do to her. For 2021, three years afta her pikin die, di mother of Ochanya Ogbanje tok di kain justice wey she want for her pikin.
"I know say pikin dey die for pipo, but di way she take die, if I tink am, e dey too pain me."
Wen di mata happun dat time, Ochanya family rush her go Benue Teaching hospital, wia dem confam say she get Vesico Vagina Fistula (VVF) and problem wit how to urinate as a result of wetin she pass through.
Ochanya later die for October 2018 afta she first complain of fever, later she no fit move her leg, her waist and hand again.
Why Justice for Ochanya dey trend again
Bifor 2021, di Benue state goment bin cari di mata go court and dem bin promise di family say justice go dey for di mata.
Afta plenti request and petition, di police bin arrest Andrew Ogbuja for April 2018 on allegation of rape but dem no find im pikin, Victor dat time.
Andrew Ogbuja (husband to Ochanya aunty) bin face trial since 2019 for di Benue State High Court on charges wey surround alleged rape and culpable homicide. E say im no dey guilty.
Meanwhile, for anoda case against Felicia Ogbuja (Ochanya aunty), she bin face charges for negligence sake of say she allegedly fail to take action to stop the alleged sexual exploitation of di minor by her husband, and son, Victor.
Seven years afta di mata bin go viral for 2018, di mata don come up again.
Now for 2025, dem find di videos of one of di key suspects wey allegedly rape Ochanya wey police no arrest.
Victor Ogbuja na di son of Felicia Ogbuja (Ochanya aunty) wey allegedly rape her dat time, but police no arrest am or carry am go court.
Na as im video come dey show for social media wia e dey flaunt wealth, na from dia di fresh demand for justice for di death of Ochanya bin start again.
Plenti Nigerians including politicians and celebrities don chook mouth ontop dis mata.
Senator Natasha Akpoti Uduaghan wey dey represent Kogi Central for di National Assembly don request say make di family of Ochanya write petition come as she stand wit dem.
Also, popular Lagos-based pastor Iren Emmanuel don ask make lawyers wey sabi di case show face make dem take am up.
Who be Ochanya Ogbanje and how she take die?
Young and promising Ochanya dey veri young wen she bin comot for her parent house.
Na school Ochanya find reach her aunty Felicia Ogbuja house and evritin first dey go on well for about four years until di mata begin take anoda turn.
Ochanya live wit di Ogbujas (Aunty Felicia plus her husband Andrew and five of dia pikin) for di same house for four years.
"Na for 2012, Ochanya sickness start. We carry am go hospital for Okpoga. Na for dia we stay reach about six days and she get medical attention. As time pass, she begin dey feel well na im we waka go house. Later, di same sickness come back," na so Ochanya mama tok.
Dem born Ochanya Ogbanje for 2005 and she bin dey live wit her parents and oda family members for Ogene-Amejo inside Benue state.
She bi di last born of 11 children wey her parents born. She be five-years-old wen her mama, Rose and her papa Michael Ogbanje agree say e good make she go beta school- wey make her go stay wit her aunty.
Ochanya mama na farmer and her papa don retire.
How Ochanya take die
"I dey her bedside her wen I see say she wan die. I no fit bear am again - My heart dey break and my life dey pieces, I no fit hold myself. I run go one toilet for di ward make I no see am as she dey breathe for di last time", na so Rose Ochanya tok as she dey cry for di interview wit BBC News Pidgin.
Ochanya mama, Rose tok say her pikin die of Vesicovaginal Fistula (VVF) for October 17, 2018.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3










