50 children wey gunmen kidnap from Catholic School for Niger State escape?

Wia dis foto come from, Abdullahi Kabir/BBC
Fifty children among di ova 300 children gunmen kidnap from one Catholic school for Niger state, north-central Nigeria don return from dia captors, di Christian Association of Nigeria announce.
One statement wey dey attributed to Bulus Dauwa Yohanna, chairman of di Niger state chapter of di association, wey e issue on Sunday, 23 November, few days afta di kidnap, reveal say di children "don reunite wit dia parents."
"We don receive some good news as fifty pupils escape and don reunite wit dia parents," Daniel Atori, di media aide to CAN Chairman for Niger State, Most Rev Bulus Dauwa Yohanna, wey also be di Catholic Bishop of Kontagora Diocese tok.
"Di pupils escape between Friday and Saturday and don reunite wit dia parents as dem no fit return to di school afta dem escaped. We dey sure of dis wen we decide to contact and visit some parents," di statement read.
Wetin BBC see for ground on visit to Papiri show say di 50 children actually escape during di capture on Friday and return on dia own.
On Friday, gunmen bin storm St Mary's School for Niger state, capture 315 students and teachers.
Shortly afta di incident, govment deploy security forces to comb di forests and rescue di abducted children and staff members.
Niger state govnor for one statement explain say based on di Google imagery being reviewed, di incident na "more of a scare and missing of pipo instead of a kidnapping.
"Yes, scare dey, sporadic gunshots, and di children run bicos dem dey targeted. And from di Google imagery, mass movement of pipo no dey, but pipo wey dey run up and down", e tok.
E tok say dem don see some of di children and dem don reunite wit dia families, and add say dem dey intensify efforts to find di rest soon.
CAN say gunmen kidnap 315 students, staff of St Mary's primary and secondary school Niger state
On Saturday, 22 November, authorities for Niger state northern Nigeria bin confam di kidnap of 315 school children for Saint Mary's School, wey be Catholic school for Papiri community for Agwara Local Government Area of Niger State.
Tori be say di gunmen attack di school for early mor-mor on Friday and kidnap 303 students, 12 teachers and staff.
Di Christians Association of Nigeria (CAN) na dem confam di number on di evening of Friday 21 November.
Earlier, SP Abiodun, tok-tok pesin of di Niger State police command say di incident happun around 2am wen di students suppose to dey sleep.
Police say dem don do heavy deployment wit military components to di area and dey comb di forests dey search for di victims.
For anoda statement govment say dem bin don order make construction stop for di area and make all Boarding schools close down, but say di management of di affected school go ahead to reopen without notifying di authorities.
Govment say dem bin don get intelligence of security threats in recent weeks across parts of Niger North Senatorial District.

St Mary's school na private boarding school for primary and secondary.
Di school dey mixed wit boys and girls.
Tori be say di attackers carri plenty motorbikes and vans.
Management of di school say di attackers shoot one of di security personnel for di school.
Dis latest incident dey happun just days afta gunmen abduct students for Kebbi state and worshippers for Kwara state.
One Mrs Sunday wey narrate di incident to di BBC say "two of my sister children follow for pipo wey dem abduct for di school. She get four children for di school, dem abduct dem for midnight. One dey primary six, di oda one dey nursery three, six years and thirteen years."
She say di children mama dey bush since morning dey cry, say soldiers bin get opportunity to go rescue di children for road wen di motor wey carri dem spoil for road.
"Na majorly di primary school girls dem carri, di secondary students manage to escape. dem dey trek, small small children six years, four years, 10 years, 13 years. Soldiers come here early morning, pipo from di bush tell dem say dem dey close, make dem go rescue dem" na so she tok.
Dis latest attack for Awara local govment inside Niger State happun about 140 kilometres from wen di Kebbi school kidnap take place for Wasagu Local Govment Area.
Friday attack don add to di long list of killings and abductions wey don happen for Nigeria in recent times, wey leave di citizens of di most populous African kontri in fear.
Wetin Nigeria govment dey do about di matter
Nigeria president Bola Tinubu for statement earlier in di week tok say im dey cancel him foreign trip to South Africa and Angola dis week to coordinate response to di security situation in di kontri.
Di president bin send di vice president Kashim Shettima to Kebbi to see wetin dey ground and give full security report, so im go know wetin to do next.
Adviser to di president on policy communication Daniel Bwala tell BBC say di president order security agencies to go down to di locations wia bandits dey operate.
E say di President bin don increase budgetary allocations for defense to help terrorism and oda security issues.
Bwala also add say di president change di security chiefs in di kontri to ensure say dem work very well.
Nigeria security personnel also recently arrest leader of terrorist group Ansaru.
Oda major security incidents dis week

Wia dis foto come from, Getty Images
Within di past week plenti bloody security situations don happen from Kebbi State to Kwara State and now Niger State.
Bandits suspected to be members of ISWAP kill senior Nigeria Army general Sani Uba for undisclosed location. For video wey go viral e show moment bandits shoot di army general and e fall for ground.
Kebbi State bin grab dia own share of terror within di week wen gunmen enter one Government Girls Comprehensive Secondary School kidnapp 25 students.
Di local authority later tok say di 25 students wey di jaguda pipo kidnap all of na Muslims.
For Kwara State, gunmen enter church wia worshipers dey do gathering, kill some and kidnap many. Di incident for Kwara state lead to shutdown of schools for di area by govment.
For 2021, gunmen kidnapp dozens of students and staff from Government Science College Kagara, Rafi Local Government Niger State, Nigeria on February 18, 2021
Govment still dey battle how to solve di Kebbi kidnap incident, now dis one don happun.










