Wetin we know about bandit attack on Church for Kwara

Foto of di Church bus
Read am in 5 mins

Police for Kwara State, for north-central region of Nigeria don confam deadly attack for one church for di town of Eruku, wia jaguda pipo bin open fire on top pipo wey gada to pray for Tuesday evening.

Two pipo die for di attack and some odas wunjure - di attackers also kidnap several pipo from di worshippers.

Di attack happun for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, for Ekiti Local Government Are, Kwara state during di church evening programme.

Di bandits shoot di pastor of di church bifor dem round up di worshippers at gunpoint.

For dia statement, di police tok say: "As we search di area, we discover one male victim wey dem shoot die inside di Christ Apostolic Church, Oke Isegun, while we also find anoda victim of fatal gunshot for di bush.

"One local vigilante person also sustain gunshot injury and we rush am immediately go ECWA Hospital, Eruku, for medical treatment."

Police say dia men and di local vigilante pipo don start to search for di attackers wey run enta bush afta dia attack.

Foto and short videos of di attack - wey come from di Church livestream - don go viral on top social media and e show as di worshippers bin try to hide wen di gunmen enta di church.

Di video also show one elderly woman as she dey try desperately to escape di gunmen.

Tension still dey high for Eruku town wey dey close to Kogi State as pipo dey fear say di attackers fit come back.

'Di bandits kidnap worshippers' - Eyewitness tok how e happun

Inside di CAC Church wey bandits attack

Eyewitnesses say na three pipo die for di attack wey happun for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, contrary to wetin police tok.

Di eyewitness wey be member of di Church also say di bandits carry over 30 of dia members enta bush. E say dem no fit account for 35 of dia worshipers. Police neva comment on di number of pipo wey di bandits kidnap.

"E happun around 6:00 pm wen dem enta through di fence, dem start to dey shoot guns. Di security man wey dey for di Church dem pursue am, shoot am and e shoot dem back. Dem later kill am.

"Di pipo wey dem kidnap pass 35 pipo, blood stain dey everywia for inside di church.

"We no see security operatives yesterday, even di hunters no fit come becos di gunmen fire teargas.

"Police officers come dis morning but dem no do anything na only foto dem take for di place. Dem carry both male and female, young and old enta di bush."

"Hunters don go search for di pipo wey dem kidnap inside forest,

"Di gunmen use dia leg waka come inside di church wit guns and loot pipo properties wit di bags wey dem bring come."

Anoda source tok say dem pick over 100 bullets shells afta di attack.

Empty seats inside di Church wey bandits attack afta di attack

Nigeria terror attacks inside one week

Dis attack dey happun about 24 hours afta bandits bin attack one govment girls secondary school for Maga community for Kebbi State, northwest Nigeria, and kidnap 25 school girls from dia school hostel.

Dem kill di Vice Principal and di security pesin for di school bifor dem pack di girls enta bush witout any confrontation from security pipo.

Tori later come out say two of di girls later escape, and by Wednesday morning tori also tok say anoda school girl return home but she get injury.

Meanwhile, more dan 20 of di schoolgirls still dey for di hand of di bandits.

Also inside dis week, Boko Haram terrorists bin capture and kill one big oga for di Nigerian army, Brigadier General Musa Uba for Borno State.

Di tori about di killing of di army oga bin still dey fly like rumour until President Bola Tinubu imsef confam am for one statement late on Tuesday.

"As di Commander-in-Chief of di Armed Forces, I dey depressed wit di tragic death of our soldiers and officers on active duty. May God comfort di families of Brigadier General Musa Uba and oda fallen heroes," Tinubu tok.

Alleged christian genocide narrative

Dis recent attack for di CAC church for Kwara State dey come for a very bad period for Nigeria as President Donald Trump of di United States bin don accuse di Nigeria govment say dem no dey do anything to stop "di Christian genocide" we dey go on for di kontri.

Di US govment recently add Nigeria to di list of kontris of particular concern wia pipo dey face persecution and death sake of dia Christian beliefs.

Trump even threaten say im fit send US military to come into Nigeria "guns ablazing" to wipe out di radical Islamisc extremists we wan wipe out di Christian population for di kontri.

However, President Tinubu and di Nigeria guvment reject dis accuse as dem tok say di insecurity for di kontri dey affect evribodi no mata dia religious standing.