Wetin be Trump Gaza plan wey di UN Security Council don adopt to end di Isreal-Gaza kasala

Wetin we call dis Video, Watch: UN Security Council vote to adopt Trump Gaza peace plan
    • Author, Nada Tawfik
    • Role, North America correspondent,
    • Author, Dearbail Jordan
  • Read am in 7 mins

Di UN Security Council don vote yes to one US drafted resolution wey don stamp di US President Donald Trump, im 20 point plan for Gaza.

Part of di plan include di establishment of one international Stabilisation Force (ISF) wey US say some unamed kontris don offer say dem go contrubute inside.

Di resolution get di support of 13 kontris like di UK, France and Somalia. But Russia and China abstain from di vote even though no kontris bin vote against di proposal.

Tok-tok pesin for di UN Secretary-General Antonio Gutteres tok say to adopt dis plan na "important step for di consolidation of di ceasefire". But Hamas don reject di resolution say e no meet di needs and demands of Palestinians.

Di Palestinian armed group bin write for Telegram afta di resolution pass say di plan "force international guardianship mechanism for di Gaza Strip, wey our pipo and dia factions reject".

Dem add say, "dem give di international foce wit tasks and roles for inside di Gaza Strip wey include to scata di resistance, comot dia neutrality and turn am to part for inside di kasala wey go favour di occupation".

For inside di resolution, di ISF go work wit Israel and Egypt to geda wit a newly trainned and vetted Palestinian police force, to help secure border area and start di process to permanently disarm high-state armed groups, wey include Hamas.

Mike Waltz, di US ambassador to di UN tell di council say di ISF go get "di work of securing di area, support di demilitarisation of Gaza, scata di terrorist infrastructure, remove weapons nad ensure di safetyy of Palestinian civillians".

Di security Council bin also approve di creation of transitional governance bodi wey dem call di Board of Peace (BoP), wey go supervise governance of Palestinian technocratic, apolitical committee and go oversee di rebuilding of Gaza and di delivery of humanitarian aid.

To finance di reconstruction of Gaza afta two years of war go come from trust fund wey di World Bank dey back according to di resolution.

For di resolution, both di ISF and di BoP go work togeda wit Palestinian committee and police force.

Trump call di Security Council vote say e dey "historic" and tok say na way to "acknowledge and endorse" di BoP wey dem go announce dia final membership soon.

Trymp dey expected to be di oga of di board.

E write for Truth Social say, "dis go go down as one of di biggest approvals for di history of di United Nations, wey go lead to more Peace all ova di World and na moment of true historic proportion".

Unlike oda drafts, dis resolution tok about credible way to Palestinian self-determination and statehood. Dis na wetin plenti council members bin dey fight for.

Israel dey strongly against creation of Palestinian state, wey go cause beta blockage for di road to future statehood. Key Arab States don ginger drafters of di resolution make dem put Palestinian self-determination for inside di text.

Di US, Palestinian Authority and plenti oda Arab and Muslim-majority kontris dey include Egypt, Saudi Arabia and Turkey don dey ginger for di quick adoption of di resolution.

Di Palestinian Authority (PA) tok for statement say di resolutions terms need to dey implemented "urgently and immediately".

Russia and China no use di veto wey dem get instead dem abstain di vote mostly bicos di PA and eight oda Arab and Muslim kontris don alreadi back am.

But dem don come for di resolution say e no clear for di key mechanism composition, say e no ensure di participation of di UN, and say e no really tok am outside of di commitment for di two-state solution.

Di first phase of di plan wey be ceasefire between Israel and Hamas and handover of hostages and detainees bin happun for 10 October. Waltz call am say na "fragile, fragile first step".

Wetin be di full 20 point plan wey Trump get for Gaza

  • Gaza go be deradicalized terror-free zone wey no go pose threat to im neighbours.
  • Gaza go dey redeveloped for di benefit of di pipo of Gaza, wey don too suffer.
  • If both sides gree to dis proposal, di war go end immediately. Israel forces go withdraw to agreed lines to prepare for hostage release. For dis time all military operations like air and artillery bombardment go dey suspended and battle lines go stay frozen till di conditions dey met for full withdrawal.
  • Within 72 hours wey Israel publicly accept dis agreement, all hostages, weda dem still dey or don die go dey returned.
  • Once all hostages dey released, Israel go release 250 life sentence prisoners plus di 1,700 Gazans wey dey detained afta 7 October, 2023 including women and pikin. For evri Israeli hostage deadbodi wey dey released, Israel go release 15 Gazans deadbodi.
  • Once all hostages dey returned, Hamas members wey go gree to peaceful co-existence and decommission dia wide weapons go get amnesty. Hamas members wey wan comot Gaza go get safe passage to di kontris wey go accept dem.
  • Wen dis agreement dey accepted, full aid go enta Gaza Strip. Di minimum aid quantities na according to wetin dey di 19 January 2025 agreement tok about humanitarian aid, wey include rehabilitation of infrastructure (water, electricity, sewage), rehabilitation of hospitals and bakeries, and entry of necessary equipment to remove rubble and open roads.
  • None of di two parties go disturb entry and distribution of aid for di Gaza Strip wey go come through di United Nations and dia agencies and di Red Crescent. Opening di Rafah crossing for both directions go dey subject to di same mechanism wey bin dey implemented for di 19 January 2025 agreement.
  • Gaza go dey governed under di temporary transitional governance of technocratic, apolitical Palestinian committee, wey go dey responsible for delivering di day-to-day running of public services and municipalities of di people in Gaza. Na qualified Palestinians and international experts go make up di committee and dem go dey supervised by new international transitional body, di "Board of Peace" wey President Donald J. Trump go dey lead and go get oda members and heads of state go dey announced wey go include Former Prime Minister Tony Blair.
  • One Trump economic development plan to rebuild and energise Gaza go dey created by panel of sabi pipo wey don create some of di modern miracle cities for di Middle East.
  • Special economic zone go dey established wit preferred tariff and access rates go dey negotiated wit participating kontris.
  • No one go dey forced to comot Gaza, and anyone wey wan comot go fit do so and go dey free to come back. We go ginger pipo to stay and give opportunity to build beta Gaza.
  • Hamas and oda factions go gree to no get any role for di governance of Gaza in any way. All military, terror, and offensive infrastructure, including tunnels and weapon production facilities go dey destroyed. Process for di demilitarisation of Gaza wit supervision from independent monitors wey go place weapons permanently for beyond use wit agreed process of decommissioning and go dey supported by internationally funded buy back and reintegration programme wey go dey verified by independent monitors go start. New Gaza go dey fully committed to building prosperous economy and to peaceful coexistence wit dia neighbours.
  • Guarantee from regional partners to make sure say Hamas and di factions do wetin dia obligations tok and make sure say New Gaza no pose threat to dia neighbours or dia pipo.
  • Di United States go work wit Arab and international partners to create for now International Stabilisation Force (ISF) wey go immediately deploy to Gaza. Di ISF go train and provide support to di approved Palestinian police forces for Gaza and go consult wit Jordan and Egypt wey get extensive experience for dis field. Dis force go dey as di long-term internal security solution. Di ISF go work wit Israel and Egypt to secure di border areas wit di newly trained Palestinian police forces. E dey important to prevent weapons to enta Gaza and ginger di safe and sharp-sharp move of goods to rebuild Gaza.
  • Israel no go occupy or annex Gaza. As di ISF go establish control and stability, di Israel Defense Forces (IDF) go comot based on standards, milestones, and timeframes linked to demilitarization wey di IDF, ISF, guarantors and di US gree to. Small-small di IDF go start dey give di Gaza territory wey dem dey occupy to di ISF according to agreement wey dem go make wit di transitional authority until dem don comot from Gaza fully except for security perimeter presence wey go dey rill Gaza dey well secure from any resurgent terror threat.
  • If Hamas delay or reject dis proposal, wetin dey up plus di increased aid operation go kontinu for di terror-free areas wey IDF go give di ISF.
  • Interfaith tok-tok go start based on values of tolerance and peaceful co-existence to try and change di mindset of Palestinians and Israelis by say dem torchlight di benefits of peace.
  • Even as Gaza dey re-develop and wen di PA reform programme dey well done, di conditions go come dey for credible road to Palestinian self-determination and statehood wey we know say na wetin di Palesinian pipo want.
  • Di US go create tok-tok between Israel and Palestinians to gree on political horizon for peaceful and prosperous co-existence.