Wetin we know about Trump new sanctions on Russia
- Author, Bernd Debusmann Jr
- Role, at the White House
- Author, Max Matza
- Author, Ian Aikman
- Read am in 6 mins
Di US govment don announce new sanctions wey go target Russia two biggest oil companies, as dem wan use am put pressure make Moscow agree peace tok for Ukraine.
Di announcement come just one day afta President Donald Trump tok say di planned meeting between am and Vladimir Putin for Budapest don cancel till further notice.
"Evri time I tok to Vladimir, di tok dey go well but e no dey lead anywia" Trump tok.
Even though di sanctions no go shake Russia economy too much, e still mark big change for Trump govment foreign policy bicos bifor now, dem don always tok say dem no go sanction Russia until European kontris stop dey buy Russian oil.
Trump don dey threaten Russia wit stronger action plenty times bifor, but e neva take am till now sake say e dey hope say e fit broker peace for di three and half year war.
Im govment don dey try make US look like neutral mediator between di two fighting kontris different from Joe Biden wey support Ukraine fully wen e be president.
But now, Trump don tire for Kremlin sake say dem no wan move forward wit peace toks.
Di sanctions na wetin Ukraine president, Volodymyr Zelensky, don dey beg for since. E call am "better signal" from US, and tok say ceasefire fit happun if oda kontris join pressure Russia.
On Wednesday, Trump blast Putin, say di man no serious about peace, and e hope say di sanctions go force am to reason well.
"I feel say time don reach. We don wait too long" Trump tok.
E call di sanctions package "tremendous" and tok say e go like make dem remove am quick if Russia stop di war.
US Treasury Secretary Scott Bessent still tok say di sanctions necessary sake of say "Putin refusal to end dis senseless war."
E add say di oil companies wey e affect na Rosneft and Lukoil na dem dey fund Kremlin "war machine."

Wia dis foto come from, Getty Images
Oil and gas na di biggest export wey Russia get. Di two big oil companies for Russia dey export about 3.1 million barrels of oil eviri day. Rosneft alone dey produce almost half of all di oil wey Russia dey sell, wey be like 6% of di world oil, according to wetin UK govment tok.
Russia main customers na China, India and Turkey. Trump don beg dis kontris make dem stop dey buy Russian oil so e go fit put economic pressure for Kremlin.
For some months now, Ukraine don dey target Russian oil refineries and energy buildings to weaken Russia economy.
Zelensky visit White House on Friday to ask for long-range Tomahawk missiles wey fit reach deep inside Russia, but e no succeed collect am.
One day before dat visit, Trump don already announce say e wan meet Putin for Hungary afta Putin call am unexpectedly.
But afta US Secretary of State Marco Rubio tok wit im Russian partner Sergei Lavrov, dem cancel di meeting plan. Trump come tok say e no wan waste meeting.
Later, Trump explain say e no gree give Ukraine di missiles bicos di tin "hard to use" and e go take one year of serious training bifor dem fit operate am. Zelensky tok say just like di sanctions, Trump fit still change im mind later.
Fighting for ground still dey kontinu overnight. Air strikes for Kyiv kill at least two pipo according to govment officials. Earlier on Wednesday, Russia bomb di area heavily, kill at least seven pipo, including pikins.

Last week, UK govment put di same sanctions on Rosneft and Lukoil. Chancellor Rachel Reeves tok say "No space dey for Russian oil for global market."
Russia embassy for London tok say di move to target dia big energy companies go scatter fuel supply for di world and make price go high. Dem still add say, "Pressure no dey bring peace tok, e dey only make wahala worse."
Since Russia start full invasion for Ukraine, Europe don reduce how dem dey depend on Russian oil and gas. But Russian gas still make up around 13% of EU import, even though EU don promise say dem go stop am totally soon.
Bifor now, Trump don tok say e no go put new sanctions on Moscow unless Europe stop to buy Russian energy completely.
EU Commission President Ursula Von der Leyen praise di new sanctions package wey EU approve on Wednesday. Di new rule include ban of Russian liquefied natural gas import by 2028.
She tok say dis one, plus the US sanctions, na "clear message from both sides of di Atlantic say we go kontinu to press di aggressor."
Earlier dis year, UK and US don already sanction two oda big Russian energy companies Gazprom Neft and Surgutneftegas.

Wia dis foto come from, EPA
Nato Secretary General Mark Rutte dey White House wen dem announce di new sanctions, and e praise di move say e go "add more pressure" on Putin.
E been dey expected say him go discuss one 12-point plan wey European allies and Ukraine don prepare. Di plan go make front line stay where e dey, return all children wey Russia deport, and arrange prisoner exchange.
Di plan still include war recovery fund for Ukraine, security guarantee, and clear road for Ukraine to join European Union.
Trump don tok say one of di main wahala na bicos Russia no gree stop fight for di current front line - something wey Zelensky support.
But Russia no gree that idea. Kremlin spokesperson Dmitry Peskov tok say Russia still stand by dia demand make Ukrainian soldiers comot from di parts of eastern Donbas wey dem still hold.










