Wetin be di next tin for UK Prince Andrew, wit di sex scandal - e fit hold im remaining royal title?

Britain Prince Andrew leave di coronations of King Charles III and Queen Camilla, for Westminster Abbey, in central London, on 6 May 2023. Andrew wear a ceremonial jacket embroidered wit gold symbols. E get some raindrops on di window of di car.

Wia dis foto come from, Toby Melville / Getty Images

Read am in 11 mins

Further details of di alleged sexual assault by UK Prince Andrew dey published for one book by Virginia Giuffre, wey kill herself earlier dis year.

Four days bifor di book release, di prince, 65, announce - afta e tok to im elder brother, King Charles III - say e dey give up im royal title of di Duke of York, honour wey im mother, di late Queen Elizabeth II, give am.

Virginia Giuffre, a woman wit blonde hair dem tie for back, she wear white blouse and hold one foto of herself as a teenager.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Virginia Giuffre say she bin dey forced to have sex with Prince Andrew on three separate occasions

Ms Giuffre for see dis "as a victory", di book ghostwriter, Amy Wallace, don tell di BBC.

Wetin be di accusations Virginia Giuffre make against Prince Andrew?

Prince Andrew wear blue shirt wit black trousers, stand next to Virginia Giuffre, wit im hand around her waist. Ms Guiffre wear a tight tank top, wey reveal her lower belle and multicoloured trousers wit purple and pink patterns on dem. Ghislaine Maxwell dey stand behind dem, leaning backwards a little. She wear a white top with a large circular collar wey reveal her arms from her shoulders. All three dey smile.

Wia dis foto come from, US Department of Justice

Wetin we call dis foto, Prince Andrew, Virginia Giuffre (centre) and Ghislaine Maxwell, wey later go prison for arranging under-age girls for financier Jeffrey Epstein

For one 2021 US civil case, Ms Giuffre accuse Prince Andrew, wey remain eighth in line to di throne, of sexually assaulting her.

For court documents, she say she be victim of sex trafficking and abuse by financier Jeffrey Epstein from di age of 16 - and dis include say dem dey "lend" her to oda powerful men such as Prince Andrew, wey sexually assault her on three separate occasions bifor she turn 18.

A side shot of Prince Andrew dey tok to Emily Maitlis during di recording of di 2019 BBC Newsnight interview wey dem show worldwide.

Wia dis foto come from, Mark Harrison / BBC

Wetin we call dis foto, Prince Andrew tell Emily Maitlis e no remember of ever meeting Ms Giuffre, on di BBC Newsnight programme in 2019

Di prince don consistently deny Ms Giuffre allegations against am and, in 2019, e tell di BBC Newsnight programme say e no remember ever meeting her.

Di two parties bin reach out-of-court settlement, in 2022, wit di prince paying Ms Giuffre an undisclosed sum, without admitting liability.

Lawyer David Boies waka down di street wit Virginia Giuffre on 27 August 2019.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Virginia Giuffre arrive for one New York court wit her lawyer, David Boies, for a hearing following di death of Jeffrey Epstein

Wetin Virginia Giuffre book tok?

Ms Giuffre fear say she go "die a sex slave" for di hand of Epstein and im circle, na so her posthumous autobiography, Nobody's Girl, reveal.

Also at di centre of di abuse na Epstein former girlfriend Ghislaine Maxwell, wey currently dey serve a 20-year prison sentence for child sex trafficking.

Decades later, Ms Giuffre remember how much she bin fear two of dem. And much of di book makes for extremely harrowing reading, as she detail Epstein sadistic sexual abuse, wey cause her "so much pain so tay I pray say I go black out".

Wetin Virginia Giuffre book tok about Prince Andrew?

In March 2001, Maxwell allegedly wake her up and tell her say na a "special day" and "just like Cinderella" she dey go meet a "handsome prince", Ms Giuffre write.

Wen dem meet, she recount say Maxwell bin ask Prince Andrew, den 41, to guess her age.

E "guess correctly - 17", Ms Giuffre tok, adding: "My daughters [Princess Beatrice and Princess Eugenie] dey just a little younger dan you."

Ghislaine Maxwell and Jeffrey Epstein on board a plane.

Wia dis foto come from, US Department of Justice / PA Media

Wetin we call dis foto, Ghislaine Maxwell dey found guilty of trafficking girls for sex wit Jeffrey Epstein

Dat night, she, Epstein and Maxwell go London Tramp nightclub wit di prince, wey im dey "sweat profusely", Ms Giuffre tok.

Den, as di four dey drive back to Maxwell house, Maxwell allegedly tell her: "Wen we reach house, you go do for am wetin you do for Jeffrey."

"Im bin dey friendly enof, but still entitled - as if e believe say having sex wit me na im birthright," Ms Giuffre tok.

"Di next morning, e dey clear say Maxwell den confer wit her royal chum becos she tell me, 'You do well. Di prince had fun.'"

Ms Giuffre, meanwhile, "no feel so great", she write, adding: "Soon, Epstein go give me $15,000 for servicing di man wey di tabloids call 'Randy Andy' - plenty money."

About a month later, she say, she sleep wit di prince for di second time, for Epstein townhouse in New York.

VIctoria Guiffre stand by di sea, wearing a pink dress wit splashes on di lower part.

Wia dis foto come from, Family via Penguin Random House

Wetin we call dis foto, A family photo of Victoria Guiffre, wey pipo bin sabi as Victoria Roberts

Di third alleged occasion na on Epstein island, as part of wetin Ms Giuffre describe as "orgy".

"Epstein, Andy and approximately eight oda young girls and me do kerewa togeda," she tok.

"Di oda girls all appear to dey under di age of 18 and no really speak English.

"Epstein laugh about how dem no really fit communicate, say dem be di easiest girls to get along wit."

Virginia Giuffre dey tok for podium outdoors, surrounded by a number of pipo .

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, "So much pain sotay I pray make I black out", Ms Giuffrie write in her posthumous autobiography, referring to Epstein sadistic sexual abuse

Referring to di 2022 out-of-court settlement, Ms Giuffre write: "I agree to a one-year gag order, wey bin dey important to di prince becos e ensure say im mother Platinum Jubilee no go dey tarnished any more dan e already dey."

A Buckingham Palace source tell di BBC say royal officials accept say di book publication fit mean "more days of pain ahead".

Wetin Prince Andrew tok for im 2019 BBC Newsnight interview?

Emily Maitlis dey waka with Prince Andrew through Buckingham Palace. Dem dey on a red carpet wit marble walls and statues.
Wetin we call dis foto, Emily Matlis 2019 interview wit Prince Andrew, on di BBC Newsnight programme, dey reported around di world

Prince Andrew use di 2019 BBC Newsnight interview to emphatically deny say e sleep wit Ms Giuffre, say e bin carry Princess Beatrice to a Pizza Express restaurant on di evening wey di mata happun.

E also insist say e no fit be di man Ms Giuffre describe as "profusely sweating".

"I no sweat at di time, becos I bin suffer wetin I go describe as overdose of adrenaline in di Falklands War, wen dem shoot me," Prince Andrew tell Newsnight.

"E almost dey impossible for me to sweat."

Newspapers later publish pictures dem take in di same period of di prince wey dem say show say e appear to sweat, however.

Foto of Jeffrey Epstein dey hold im hand to im face as dem project am on to a tower at Windsor Castle, near London, on 16 September 2025.

Wia dis foto come from, Mark Kerrison / Getty Images

Wetin we call dis foto, Political campaign group led By Donkeys bin project an image of convicted child sex abuser Jeffrey Epstein on to Windsor Castle as US President Donald Trump second state visit to di UK begin, in September

Who be Jeffrey Epstein and wetin be im relationship with Prince Andrew?

Epstein na former hedge-fund manager wey die in 2019 wen e dey prison dey face sex-trafficking and conspiracy charges. Di New York medical examiner rule im death as suicide.

In 2005, parents of a 14-year-old tell Florida police Epstein bin don molest dia daughter for im Palm Beach home. A police search find photos of girls throughout di house.

Epstein bin dey sentenced to 18 months in prison and released on probation afta 13 months.

Undated handout photo wey di New York State Division of Criminal Justice make available dey show, Jeffrey Epstein, issue on 25 July 2019.

Wia dis foto come from, New York State Division of Criminal Justice Services / EPA

Wetin we call dis foto, Epstein kill imsef for im cell for New York Metropolitan Correctional Center, wia im bin dey await federal trial

In July 2019, Epstein bin dey arrested in New York, after returning from Paris on im private jet

In August, dem find am dead for im cell for New York Metropolitan Correctional Center, wia im bin dey held awaiting federal trial.

Epstein bin dey accused of paying girls under di age of 18 to perform sex acts for im Manhattan and Florida mansions between 2002 and 2005.

E bin deny any wrongdoing and plead not guilty to di charges against am.

Prince Andrew tok to Jeffrey Epstein as dem dey waka. Both dey wear dark coats. Andrew left hand dey gesture as e tok to Epstein.

Wia dis foto come from, News Syndication

Wetin we call dis foto, Dem snap Prince Andrew and Jeffrey Epstein (right) as dem dey waka for New York Central Park in December 2010

Prince Andrew tell Newsnight say e don cut off all contact wit im former friend in December 2010, afta dem bin meet for New York Central Park.

But emails don since emerge wey show say di prince privately contact Epstein months later, wit a promise to "play some more soon".

Prince Andrew wear top hat and grey suit, dey laugh. Oda men wit top hats dey beside am and a woman wit a brown hat and long brown hair dey di background.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di prince fit become Mr Andrew Windsor – but only on di order of d King

Wetin British police investigate?

London Metropolitan Police dey "actively look into" a newspaper report wia Prince Andrew ask an officer assigned to am as a bodyguard "to dig up dirt" on Ms Giuffre in 2011.

Di report, for di Mail on Sunday, say di prince give di bodyguard her date of birth and US Social Security number to try to reveal weda she get a criminal record or any oda potentially damaging information about her.

Royal sources say dem dey treat di accusations against Andrew with "very great concern and e go dey examined in di appropriate ways to di fullest extent".

Prince Andrew stop to be a working royal in 2019 - and becos of day Buckingham Palace no dey accountable for am in recent years.

Prince Andrew wear finery in front of a royal guard. Di prince get a black hat wit a white feathery design.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, As di son of a monarch, Prince Andrew automatically become prince di moment dem born am

Prince Andrew fit dey stripped of im remaining royal title?

As di son of a monarch, Prince Andrew automatically become a prince as soon as dem born am.

Dis status fit dey removed, wey fit leave am as Mr Andrew Windsor, but only if di King issue a legal document wey dem call letters patent.

An act of parliament fit change dis law.

But di UK govment don indicate say dem no go introduce legislation to strip Prince Andrew of im remaining royal title unless di King want am.

Women and Equalities Minister Bridget Phillipson tell di BBC: "We go dey guided by di Royal Family in dis and I imagine say di Royal Family go want Parliament to kontinu to dedicate our time to our wider legislative programme - but we go dey guided by di monarch."

Prince Andrew wear naval uniform alongside Sarah Ferguson in a white wedding dress dey ride in open-topped carriage. Ms Ferguson dey wave.
Wetin we call dis foto, Prince Andrew bin marry Sarah Ferguson from 1986 to 1996

Calls for di prince and ex-wife Sarah Ferguson to move out of di 30-room Royal Lodge, near Windsor Castle also dey.

View of di Royal Lodge from di air on 21 October 2025.
Wetin we call dis foto, Prince Andrew dey lease di Royal Lodge, wey dey on di Crown Estate, in southern England
A chapel wit a spire, pitched roof and arched entrance. A path and neat lawns dey in front of am wit small trees growing on di lawns.

Wia dis foto come from, BBC / Picturepoint

Wetin we call dis foto, Di Royal Lodge get im own chapel

Any oda member of di Royal Family don lose dia title?

Descendants of Queen Victoria and Prince Albert wey support di German side in World War One bin dey stripped of titles through legislation.

Dis law still exist - but e refer specifically to WW1 and e fit prove to be a matter of legal opinion as to weda dem fit use am today.

Prince Albert sits next to Queen Victoria, holding a scroll in his right hand. His left arm is stretched out behind the Queen. He is wearing a dark jacket with bow tie. She is wearing a long, light, floral dress. Albert is looking towards Victoria, who is looking away from him to the right of the camera.

Wia dis foto come from, Roger Fenton / Getty Images

Wetin we call dis foto, Queen Victoria and Prince Albert, in 1854, five years after dia wedding

Waetin again don contribute to Prince Andrew downfall?

Secret documents wey reveal Prince Andrew links wit an alleged Chinese spy bin dey disclosed in April 2025, after di BBC and oda media outlets push for di courts to release dem.

Dem reveal how Prince Andrew believe say e fit salvage a prominent public position by pursuing business opportunities in China wit di help of Chinese businessman Yang Tengbo, wey im former adviser Dominic Hampshire consider to be di prince "only light at di end of di tunnel" afta im 2019 Newsnight interview.

Di documents also reveal details of Prince Andrew "communication channel" wit China President, Xi Jinping, wey include to send annual birthday letter, and how di UK security service, MI5, intervene to warn against any contact wit Mr Yang.

A close-up of Prince Andrew looking downwards, with a green background. E dey wear a grey jacket and white shirt.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, To avoid press attention, Prince Andrew bin dey smuggled into Windsor Castle for a meeting with di King

Mr Hampshire witness statement also reveal say:

  • Prince Andrew relationship wit oga Yang bin dey discussed at two meetings wit Mr Hampshire and di King, wey make dem smuggle di prince into Windsor Castle to avoid press attention
  • Tension among di prince aides lead to im private secretary to dey excluded from some meetings regarding im business plans

Di prince say e don "cease all contact" wit Mr Yang aft e get advice from di govment. All meetings bin happun "through official channels", wit "nothing of a sensitive nature ever discussed".

Mr Yang say di description of am as a spy na "pure lie".