BBC News Pidgin don join TikTok

TikTok logo

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

BBC News Pidgin don officially launch dia TikTok channel.

Di ogbonge news platform launch dia new social handle on Tuesday 19 August 2025.

You fit now get di important breaking news, analysis and special features by BBC News Pidgin directly on TikTok (@bbcnewspidgin).

Di channel aim na to deliver high-quality journalism to Pidgin-speaking audiences across Africa and beyond, by providing news wey you fit trust through engaging formats wey audiences fit relate wit.

BBC News Pidgin Editor, Moseph Ekine say: "Launching our TikTok channel na exciting step for BBC News Pidgin as we kontinu to meet our audiences wia dem dey, making complex news stories accessible to all.

"Using short-form video to explain di news and highlight local stories in Pidgin allow di BBC to celebrate di richness of di language wey plenti pipo for West Africa dey speak.

"Dis new channel go help di BBC World Service ability to provide journalism wey you fit trust wey dey speak directly to our audience for dia own language."

Now readers for Nigeria, Ghana, Cameroon, Sierra Leone, Liberia, Kenya, South Africa among odas, fit also get di best BBC content in Pidgin on TikTok.

Click here to subscribe to our TikTok handle if you dey use your mobile phone or browse for computer.

Wetin we call dis Video, BBC News Pidgin launch