Why Inec dey do Continuous Voter Registration exercise, all you need sabi about CVR

Inec adhoc worker dey try verify identity of voter during by-election

Wia dis foto come from, INEC

Read am in 4 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) for Nigeria don begin di Continuous Voter Registration exercise across di kontri.

Dis exercise start wit di pre-registration phase on Monday 18 August 2025, wey begin online for di Inec portal and e go last for just six days.

All online registrants go den proceed to any of di designated local goment Inec offices and State Office to complete dia physical, in person registration from Monday 25 August 2025.

Inec say those wey no fit register online fit visit any of di designated centres and join di physical, in person registration.

Dia dem go also attend to complaints wey relate to defects, lost or damaged cards, transfer cases and incidents of change of names, date of birth, residential address, age disparities and such tins.

To ensure a seamless process, di commission launch a feature on di CVR portal wia voters fit check di status of dia voter cards, find di location of dia designated pickup center, and for those wey never register bifor, dem fit locate di nearest registration centres wey dey close to dem.

According to figures for Inec website, Nigeria get over 93 million registered voters for di 176,846 polling units across di kontri

Chairman of Inec, Prof Mahmood Yakubu as e encourage pipo to participate for di CVR for dia website say, "your PVC na your key to make your voice to dey heard in our democratic process. We urge evri eligible voter, in di states, to seize dis opportunity to register, update dia information, collect dia PVCs and actively participate in shaping dia future."

Prof Yakubu add say during dis period, registered voters for Anambra State, wey neva collect dia PVCs, fit conveniently obtain dem for di designated collection centres.

CVR and di chance to choose well for 2027 elections

Obinna Egbogidi, wey be electoral advocate dey ginger young pipo wey don reach 18 years to take advantage of di CVR exercise and register so dem fit actively participate for di 2027 general election.

Egbogidi wey be di convener of di Rivers Peace Initiative say dis CVR dey mark di beginning of activities for di 2027 general elections and evri pesin wey don be victim of bad governance or beneficiary of good governance suppose take dis exercise serious.

E encourage evri pesin wey never register bifor to register now and get dia voters card so dem fit decide who go lead dem in di coming elections wey go hold for 2027.

"I go advise evribodi to take dis continuous voters registration serious, especially young pipo wey don attain di age of 18 years make dem go get dia voters card," e tok.

How to register for di CVR

Inec create different buttons for di Continuous Voter Registration portal wia pipo fit do different tins and dis na im we break down so.

1. For pipo wey neva register bifor, make dem go on di Inec portal and click on di New voters pre-registration button and start di process by filling di necessary information. Den, proceed to di designated centre close to you to complete di physical, in person registration.

2. If you don register and you neva review your information by providing your photo online on di platform (or at any registration centre since June 28, 2021), click di Voter Information Review button to begin di revalidation process.

3. If you wish to visit a Registration Centre to complete your application or registration, e get centres wey dey INEC State and Local goment Offices and many oda locations. Click di Locate Registration Centre button to find centres wey dey closest to you.

4. If you be a duly registered voter and you wish to change your voting location, click di Transfer button to begin di transfer request.

5. If you na a duly registered voter and you wish to update di information on your Voter's Card , click di Information Update button to start di update request.

6. If you don register bifor but you never get your Permanent Voters Card (PVC), click di Uncollected PVC button to find out wia you fit pick your PVC.

7. If you don misplace your PVC or if your PVC dey damaged and you go like a replacement, click Lost or Damaged PVC button to apply for a re-issue.