Why new political parties dey appear for Nigeria two years ahead of election

Ballot paper of Nigeria election wey show logo of political parties

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Na two years remain for di 2027 general elections to happun but political association and politicians don begin prepare.

One of di ways wey dem dey prepare na by forming associations wey fit later become political parties.

On Wednesday June 26, di Independent National Electoral Commission confam say ova 100 associations don show interest to register as political parties ahead of 2027.

"As of Monday, 23rd June 2025, di Commission don receive letters of intent from 110 associations wey wish to register as political parties. We dey take our time to process di requests in line wit di procedure outlined in law as well as our regulations and guidelines. We don acknowledge all requests wey we receive.

"So far, we don acknowledge all applications we don receive, except for six, wey dem submit recently. We go acknowledge dem bifor di end of di week," Oga Mahmood Yakubu tok.

Political parties na one of di pillars of democracy for any goment, and witout am elections no go fit happun to sustain democracy.

Since Nigeria comot from military regime enta democratic rule fully for 1999 till now, di kontri don witness different political parties inside di multi-party system wey dem dey run.

Why political parties full evriwia

According to Inec, na 19 political parties bin officially dey dia register to contest for positions for di 2023 general elections.

But wit di trend wey dey follow registration of political parties evri election year, e no go surprise pipo if by 2027 di political parties for Nigeria double.

But why pipo wan register new parties evri time even wen dem no get any chance to survive di political terrain of Nigeria.

Political analyst, Sani Bala tell BBC Pidgin why political parties dey full evriwia.

Im tok say dis trend dey since and no be today e start - some of di reasons wey im give include na:

Financial benefit: According to Mr Bala, bifor now, federal goment bin dey give political parties money during election time, especially di small-small ones wey no too strong.

Di money na to encourage and support dem for dia expenses.

"To run political party, you need some requirements, one of dem be say di political party gatz get office for Abuja, di Nigeria capital, and to get a place for office you need money.

Di party need money for elections, campaigns, travels, even to print forms, so to support dem wit dis expenses na why goment bin dey give dem money.

But some political parties just dey wait for dis money to come, afta election di parties go vanish, di good tin be say goment stop to dey give dem money since, na why di number no dey plenti like bifor again."

Oga Bala add say dis political parties dey also make money from selling of expression of interest forms to candidates wey wan contest for different positions for election.

Underground work for big parties: Di political analyst say most of dis small-small parties dey do underground work for di big parties.

"E go surprise you to know say na some of dis big parties dey register di small political parties wey go do underground work for dem during elections".

Dis small-small parties get agents for elections wey dey work for di big parties to secure votes."

Political ideologies and negotiations: Mr Bala tell BBC Pidgin say anoda reason wey political parties dey full evriwia na sake of political ideologies and negotiations.

Im explain say wen di big political parties fail to meet di ideologies of some big members dem go comot to create di one wey go fit dia political ideologies.

Im also tok about di negotiation wey dey go on wit di small political parties about who go get ticket for which position.

"Sometimes di pipo for di big political parties know say dem no go get ticket for di position wey dem wan run for, so dem gatz do bargain or merger wit dis small parties for future benefit".

Political parties for Nigeria

From di Third Republic, wey former military Head of State Ibrahim Babangida bin establish, na two political parties bin dey officially recognised.

Dem be di National Republican Convention (NRC) and di Social Democratic Party (SDP).

Sabi pipo tok say dis two-party system bin dey good well-well for Nigeria history and na during di transition time di parties bin come.

Di fourth republic start from 1999. Between 1999 and 2015 Nigeria don get plenti political parties like di Peoples Democratic Party (PDP), di All Nigeria Peoples Party (ANPP), di Alliance for Democracy (AD).

Since PDP come from 1999, dem still be one of di big political parties for Nigeria.

Oda parties wey bin dey dat time na di United Nigeria Peoples Party (UNPP), di All Progressive Grand Alliance (APGA), di National Democratic Party (NDP), di All Peoples Party (APP), Action Congress of Nigeria (ACN), Congress for Progressive Change (CPC) and many more wey pipo no fit remember again.

For more dan 25 years of democracy, di Peoples Democratic Party na one of di political parties wey don stand gidigba even as dem dey for opposition.

Di ruling All Progressives Congress (APC) na coalition of oda parties wey join togeda for 2015.