Rivers political crisis - Wetin don happun since Tinubu intervene for Wike, Fubara fight

Nigeria president intervene for Rivers political crisis

"No amount dey too big to pay for peace."

Na wetin Rivers State Governor Siminialayi Fubara tok about di political crises wey dey go on for di State.

E tok dis one shortly after tori of '8-point' resolution come out based on President Bola Ahmed Tinubu intervention for di crises and call for meeting between di govnor and di FCT minister Nyesom Wike for Abuja.

Many reactions don follow di eigth-point resolution and one of dem na from di Rivers elders forum wey condemn di entirety of di directives for di resolution of di political crisis in Rivers State.

For di communique wey twelve of di elders forum members sign including former govnor Rufus Ada George and former deputy govnor, Sir Gabriel Toby, say dem no know weda di intervention by di president don help or worsen di crises.

Dem observe say, "di directives contravene di constitution of di Federal Republic of Nigeria, wey Mr President swear to uphold at all times. Di directives unilaterally suspend di constitution of di Federal Republic of Nigeria by virtue of an attempt to reverse a court order wey recognise Edison Ehie as di speaker and direct say di remaining members of di House of Assembly constitute a quorum for legislative business."

Dem add say di directive also contravene di hallowed doctrine and practice of separation of powers, particularly as e affect di responsibility of di judiciary and dem come ask weda "Mr President or di Executive arm of Goment fit overrule di decisions of courts of competent jurisdictions?

"Dis na executive rascality wey dey undermine our constitutional democracy, rule of law, and good governance."

Di elders add say di directives dey one-sided in favour of oga Wike and say e no make sense for di Governor, Siminialayi Fubara and di good pipo of Rivers State and in di eyes of di law and due process.

Two factions of Rivers state House of Assembly

Wia dis foto come from, RSHA Media

Wetin we call dis foto, Martins Amawhule and Edison Ehie

’Di resolution no dey acceptable’ - Chief E. K. Clark

Anoda reaction come from elder statesman fo Niger Delta, Chief Dr E. K Clark and e observe say, "di terms of settlement as e dey for di communique issued at di end of di reconciliatory meeting dey "baffling, appalling and unacceptable to di pipo, especially, di Ijaw ethnic nationality."

Chief Clark observe say e dey obvious say dem ambush and intimidate govnor Fubara into submission and by President Tinubu actions and directives, e don overrule di constitution of di kontri kontri and shake di foundation of di kontri democracy wey pipo die for.

E also note say Governor Siminialayi Fubara, wey get di mandate of di pipo of Rivers State to govern dem for di next four years, show weakness of character, by agreeing and signing im signature on a document wey contain such "absurdity".

"We go go to court to resist dis oppressive action using all available constitutional and legal means," chief Clark tok.

‘No remedy for 25 former Rivers lawmakers’ - PDP

Meanwhile di National Working Committee (NWC) of di Peoples Democratic Party (PDP) say no remedy dey for di 25 former Rivers Assembly members.

For statement wey di PDP acting national chairman, Umar Damagum sign at di end of one emergency meeting on di political developments for Rivers State, e tell di former lawmakers to prepare for fresh election.

E emphasize say e no get any division wey dey di PDP at di national or any oda level for dat matter to justify di defection of di 25 former members of di Rivers State House of Assembly from di Party.

So dem don vacate dia seats for reasons best known to dem and dem no fit return to di House of Assembly without passing through a fresh electoral process in accordance with di provisions of di 1999 Constitution (as amended) and di Electoral Act, 2022.

Di PDP come tell Inec to take action in line with Section 109 (1) (g) of di 1999 Constitution (as amended) and Section 84 (15) of di Electoral Act, 2022, and fix a date for conduct of fresh election into di 25 State constituencies for Rivers State.

Pro-Wike lawmakers

Wia dis foto come from, RSHA Media

Wetin we call dis foto, 25 pro-Wike lawmakers

One group comply wit resolution

About 48 hours afta di agreement to pursue peace di two parties wey involve for di figh-fight don begin implement wetin dem agree.

Di lawmakers wey bin dey plan to remove di govnor on Wednesday announce say dem don stop di impeachment proceedings.

Di lawmakers wey pipo say dem don lose dia seats for meeting wey dem hold tok say dem don withdraw di notice of impeachment against di govnor.

Martin Amaewhule, wey tok on behalf of di lawmakers say dem withdraw di notice based on di resolution wey dem reach for di meeting wit president Tinubu.

Also, tori come out say di 25 lawmakers don withdraw dia interest to kontinu di one case for court wit govnor Fubara.

Di case dey before Justice O. Ben-Whyte of di Rivers state High court for Isiokpo.

Ferdinand Orbih SAN, lawyer to di lawmakers say im clients tell am to comot hand for di case.

Meanwhile, D. O Okoro SAN, wey dey represent di govnor say im neva get instruction to withdraw di matter. E say im gatz tok to di govnor first bifor dem take action.

So far, na di pipo wey dey loyal to di Wike di FCT minister dey make all di moves for settlement.

E neva clear wetin di govnor go do next afta all di interventions.