Rivers political crisis - ‘Conduct fresh election’ PDP tell INEC

Rivers political crisis Wike and Fubara

Wia dis foto come from, Wike/PDP/Fubar Facebook

Peoples Democratic Party don ask di Independent National Electoral Commission to conduct fresh elections for 27 State Constituencies for Rivers State.

PDP tok dey come afta di lawmakers defect on Monday for di Oil rich state to All Progressives Congress.

Dia defection come about two weeks afta di former govnor of di state wey now be di Minister of di FCT, Nyesom Wike tell tori pipo say 27 lawmakers for di state dey oppose di state governor, Siminalayi Fubara.

‘’By defecting from PDP, di political Party platform wia dem elect dem for Rivers State House of Assembly, di seats of di 27 former lawmakers don dey vacant’’ PDP statement tok.

PDP ask di Speaker of di Rivers State House Assembly to immediately comply wit di law and declare di seats of di 27 former lawmakers vacant.

Di party also warn di former lawmakers make dem stop to parade themselves as members of di Rivers State House of Assembly.

Dem say if dem kotinu e go turn impersonation mata and dat na serious criminal offence.

Majority lawmakers for Rivers state defect from PDP to APC

Wia dis foto come from, RSHA Press

Na for October kasala burst for di politics of Rivers state wey dey South South Nigeria.

All di wahala start wen tori come out say plan dey to impeach Siminialayi Fubara as govnor of Rivers state.

Wetin don happun so far;

  • 29 October: Burning of di main shambers of di state Assembly for night.
  • 30 October: 24 Members hold sitting inside di auditorium of di Assembly wey dem burn. Dem also Edison Ehie as leader of di House and three oda lawmakers wey include Sokari Goodboy Sokari Ahoada West constituency, Victor Oko Jumbo wey dey represent Bonny constituency, and Adolphus Oruibienimigha wey dey represent Opobo/Nkoro constituency.
  • Same day, anoda faction of di Aseembly elect Edison Ehie as Speaker of di 10th Assembly and suspend some erring lawmakers
  • 31 October: Some youths and groups do solidarity demonstration for support of govrnor Fubara for Port Harcourt.
  • 1 November: State High Court for Isiokpo grant restraining order on Impeachment of Rivers state govnor. Di court grant interim order restraining di Rivers state house of assembly, di speaker of di House, deputy dpeaker, clerk of di House and di chief judge of di state from carrying out any action wit respect to di impeachment of di govnor of pending di determination of di Motion on Notice.
  • Fubara say di political crisis involving im and im predecessor, Nyesom Wike, go soon dey resolved as "nothing dey wrong for a father and a son to get problems."
  • 7 November: Fededal High Court for Port Harcourt issue order make all di factions of di Aseembly no take any action until di mata wey dey before di cour dey resolved. Na Edison Ehie carry di mata go court.
  • 20 November: Alleged assassination attempt on Edison, by police officers but Commissioner of Police Rivers State Olatunji Disu say na routine patrol of police officers not assassination attempt.
  • 20 November: 25 lawmakers of hold sitting for di assembly complex wia dem ask di Police to prosecute those wey dey behind di burning of di chambers of di Assembly on 30 October 2023.
  • 24 November: Federal High Court for Port Harcourt issue Form 48 against Martins Amaewhule and im Deputy Dumle Maol for Contempt of Court becos dem violate di order of court for all parties to maintain status quo by holding a sitting for Assemby Complex on Monday 20 November 2023 and deliberating on some matters.
  • Official circular come out for di transfer of di clerk and deputy clerk of di House out of di Assembly in line with Civil service rules but Martins Amaewhule also issue statement to counter di circular of transfer say di officers na Legislative staff.
  • Minister of Federal Capital Territory FCT Abuja, Nyesom Wike accuse dFubara say e dey behind di burning of di State Assembly complex.
Men and women

Wia dis foto come from, RSHA PRESS

Wetin we call dis foto, Sime lawmakers fork Rivers State House if Assembly wey defect from PDP to APC
  • 4 December: State High Court for Isiopko adjourn to 20 December to hear di case Fubara against di Rivers State House of Assembly, di Speaker, Deputy Speaker, di clerk and di Chief Judge of di State.
  • 7 December: Federal High Court Abuja grant order wey empower di Rivers State House of Assembly to perform dia constitutional functions witout any restrictions.
  • Monday 11 December 2023: Majority lawmakers led by Martin Amaewhule defect from di PDP to di APC.