No sacrifice dey too much for me to make for peace - Govnor Fubara

Wia dis foto come from, Rivers state Government Press
River state Govnor Siminalayi Fubara tok say no sacrifice dey too much for am to make to restore peace and stability for di state.
Di govnor tok dis one afta di kasala wey burst for di state earlier dis week on top im impeachment saga.
Oga Fubara for inside one statement say im dey willing and ready to embrace di path to lasting peace and anytin wey go quench di political crisis for di state.
“Make I clear am say my actions na to restore peace and stability for our state. I be man of peace and as govrnor, di advancement of our state na my primary concern. consequently, no sacrifice dey too much for me to make to achieve dis objective.”
Dis dey come afta some members of di Rivers State House of Assembly bin attempt to impeach di Governor Siminialayi Fubara afta some jaguda pipo go burn di main chambers of lawmakers for di Assembly complex and dis result to protests and demonstrations for di State.
Di political crises many say dey come from a battle for supremacy between di FCT Minister and di state Governor Siminalayi Fubara as e be like say dem don fall out over some unknown reasons.
Di Rivers state leader also beg di pipo of di state say make dem no vex sake of di political crisis wey dey happun, say everytin go soon settle as im, di former govnor, Nyesom Wike and oga ogbonge pipo go work to bring peace and security come di state.
Meanwhile, FCT Minister and former Governor of Rivers State Nyesom Wike don react to di political crises wey dey happen for Rivers State say na family matter wey dem go settle internally.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nyesom Wike tok dis one wen e receive some South South leaders for im office for Abuja.
On Monday 30 October 2023, some members of di Rivers State House of Assembly bin attempt to impeach di Governor Siminialayi Fubara after some jaguda pipo go burn di main chambers of lawmakers for di Assembly complex and dis result to protests and demonstrations for di State.
Wike say di crises na party affair and not ethnic affair as pipo dey tok.
"We suppose ask questions to know wetin happen wey make us get to dis point. Dat go put you for position to now know di truth. Our party dey look into di mata, dat na all I go tok about am but make we know say all of us na one."
Di political crises many say dey come from a battle for supremacy between di FCT Minister and di state Governor Siminalayi Fubara as e be like say dem don fall out over some unknown reasons.
Many pipo like Niger Delta elder statesman, Chief Edwin Clark don point finger to di FCT Minister say e get hand for di attempt to impeach di governor of Rivers state wey come from di riverine area of di state, but Wike say dat wan no be true as wetin dey happen no get any ethnic colouration at all.
"Wen e favour us we dey right but wen e no favour us we bad. In politics a lot of internal wrangling dey happen but dat wan no mean say dem no go settle within di family but to come out to say dem wan do dis tin against Ijaw, dat wan dey very wrong. Na me be di instrument, I get evri power den to say na so e go be so wen tins go wrong, e good to ask questions."
Wike also address some speculations about di real reason why di crises dey happen, "Dem say becos pesin no give me N20billion, say I wan award contracts by myself, all dat na politics. But nobody tok dis wan wen I bin dey fight. So if you like accuse me from now till tomorrow I no go get sleepless night becos as far as I dey concerned, di right tin must be done."
E explain say e dey important for am to hold im political base as no politician go wan lose im political relevance at any time.
"Evribodi get political structure, abi you go let anybodi to just cut you out immediately? Evribodi get base no be so? If you take my base I no go dey politically irrelevant? Call am anytin you like but at di appropriate time we go know who dey right and who dey wrong."
Earlier, di former Presidential Amnesty Programme Coordinator, Kingsley Kuku bin read di speech on behalf of di South-South leaders wey go vist am.
Kingsley Kuku say injury to one na injury to all and so dem no happy with wetin happen for Rivers State, na im make dem join Pan Niger Delta Forum PANDEF, Ijaw Youth Congress IYC, MOSIEND, MOSOP, Ogbakor Ikwerre and all da responsible bodies for di Niger Delta to condemn di attempt to impeach di Rivers state governor.
"We condemn di attempt to impeach di Rivers state governor by di House of Assembly as e dey quite unacceptable to us and to di entire Niger Delta. We advise any pesin, authority or group of pesins wey dey involved dey ginger dis fire to stop immediately and allow peace to reign.
You [Wike] be di political leader of Rivers State. Both di executive and legislators na your political protégé. Dis na your political family sir and dem go listen to you. Dat na why we dey call on you to tok to dem. All eyes dey on you sir as di peacemaker wey you be." E tok.
Before dis time, Bauchi State Governor Bala Mohammed bin don confam say President Bola Tinubu bin don intervene for di mata.
Bala Mohammed say di president bin don meet with Rivers state Governor Siminialayi Fubara and FCT Minister Nyesom Wike for closed session during di meeting of di Nigerian Police Council for di Presidential villa Abuja.












