Wetin Nasir El-Rufa’i want for politics?

Wia dis foto come from, EL-RUFA'I/X
Former govnor of Kaduna State, Nasir El-Rufa'i resurface for media afta a very long time.
Dis na di first-time e dey appear for media interview afta e leave office since 2023 for di Northern Nigerian state.
Dis interview wey pipo dey take time to break down, get plenty strong mata inside.
Since e no fit pass Senate screening to become minister for President Bola Tinubu goment, pipo and political analysts dey reason wetin dey El-Rufa'i mind, since e dey always cause kasala for Nigerian politics, just like im latest interview.
But Nigerians neva still sabi wetin former Kaduna govnor wan achieve for politics.
Before e comot as governor, Nasir El-Rufa'i tok say afta e finish im eight-year tenure as govnor, e go waka go one side to focus on e academics and personal business.
E even tok say e no go do goment work for state or national level again, and e no go collect any political appointment.
Even wen dem dey do 2023 presidential campaign, APC candidate, Bola Tinubu, beg El-Rufa'i make e change im mind about say e no wan do politics again.
But even afta all di support wey e give to put dis goment for power, di journey no dey go as e plan am.
Last last, for im interview wit Arise Television, El-Rufa'i tok all di secret wey remain between am and im political friends.
Na dis one make pipo dey wonder wetin El-Rufa'i really wan find for politics.
'E no sure say El-Rufa’i go run for election again'
Even though e tok say e neva ready comot for politics, one former worker wey follow Nasir El-Rufa'i work before, wey no wan make we call im name, tell BBC say e no believe say di former govnor go contest for election again.
"Di real truth be say Malam Nasiru na sharp and ambitious pesin wey like to control how tins dey go. So, if you sabi di kain pesin wey Malam Nasiru be, you go understand say e no too sure say e go run for election.
"Wetin I feel say e wan do na to help arrange goment wey e go fit get power inside and fit control tins. All dis wey e dey do now no be sake of e wan contest, but na to support one politician wey if e win, e go fit give El-Rufa'i space to get control for di goment," na wetin di former El-Rufa'i worker tell BBC.
E still explain why El-Rufa'i no fit get appointment for Tinubu government.
"Im sharp brain, ambition, and im way of doing tins make some pipo dey fear am say if e enta goment, e fit affect dem. Na dis reason, plus security wahala, dem tok say na wetin make dem no give am position for Tinubu goment," di former worker tok.

Wia dis foto come from, EL-RUFA'I/X
'El-Rufa'i wan unite oppositions Togeda'
Professor Tukur Abdulkadir wey be political science expert and lecturer for state university Kaduna tok say e no surprise am at all sake of say Malam Nasir El-Rufa'i bin dey get issues wit APC goment since di time e no get political appointment for Tinubu goment.
"Di way El-Rufa'i dey waka-waka go visit different politicians and also di way e dey tok recently show say e dey try to unite di oppositions togeda so dem go fit stand against di APC goment well well," Professor Tukur Abdulkadir
But e still add say na next year pipo go sabi weda El-Rufa'i plan go strong or not, becos na dat time politics go hot well-well.

Wia dis foto come from, El Rufa'i/X
Wetin El-Rufa'i fit do for di oppositions?
Professor Tukur Abdulkadir tok say wetin El-Rufa'i fit do for di opposition depend on which kain strong pipo e get wey fit stand against di current APC goment.
"E fit be say opposition fit strong later, but make we no forget say APC goment no go just sidon dey look dem grow," e tok.
Di professor point out say dem fit face wahala to get pesin wey pipo dey respect and love like Buhari.
"Anoda tin wey fit be challenge and dey veri hard for di opposition na to get somebodi wey pipo go love and respect like former president Muhammadu Buhari"
El-Rufa'i neva leave APC
Even though El-Rufa'i still dey for APC e tok say evritin e dey do na for di party to correct di wrong but pipo dey see am wit big opposition pipo like Atiku Abubakar for PDP, Peter Obi for LP and Rabi'u Kwankwaso for NNPP.
Last week, El-Rufa'i follow Atiku Abubakar go pay condolence visit to Edwin Clark wey die. For dia, El-Rufa'i beg pipo from South-South make dem join hand wit Northern pipo to help save Nigeria.
Recently di former govnor bin dey host some big opposition pipo like Hajiya Naja'atu Muhammad wey dey against and dey also blast Tinubu goment.
But for interview wey El-Rufa'i do wit Arise TV, e tok say di waka-waka wey e dey do to oppositions no mean say e wan join opposition party. E still tok say make nobodi expect am to join di opposition party PDP at all.
I no go join issue wit Nasir El-Rufa'i - Ribadu

Wia dis foto come from, Nuhu Ribadu/Facebook
Di di national security adviser for Nigerian president don react for El-Rufa'i interview wit Arise TV wia e tok say e no get time to do media fight wit di former Kaduna State govnor.
"My ear don hear wetin Mallam Nasir El-Rufai, di former govnor of Kaduna State, tok for im interview on Monday evening".
"If no be say my silence fit make pipo think say I don agree wit am, I for just no tok about di whole matter. Sake of I dey too busy wit my current work to dey drag media kasala wit El-Rufai or anybody" im tok.
Ribadu add say e still dey respect di relationship wey dey between dia families. So e no go start any fight wit am.
"Even wit all the plenty provocation and attacks, I neva tok bad about El-Rufai any wia before. I dey respect di relationship wey we don get bifor and our families. I no go start now."
For im statement e beg di public make dem no believe wetin El-Rufai tok about am.
"Make I clear am well, I neva discuss anytin about running for president in 2031 wit anybody."










