Vatican give update on Pope condition night after e ask Catholics to pray for am

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Sarah Rainsford
- Role, BBC correspondent
- Reporting from, Rome
- Author, Anna Lamche
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Pope Francis dey rest, but remain "critical" wit respiratory and kidney problems, more dan one week afta e dey admitted to hospital, di Vatican don tok.
"Di night bin go well, di Pope bin sleep and dey rest," Monday morning statement tok.
Vatican sources say di Pope dey in good mood and dey eat normally - dis na a slightly more upbeat message dan dem bin don dey give over di weekend, following im sudden breathing difficulties on Saturday.
Di Pope dey admitted to Rome Gemelli Hospital on 14 February afta e experience breathing problem for some days, wia dem bin first treat am for bronchitis bifor dem diagnose am wit pneumonia for both lungs.
On Sunday, di Pope thrombocytopenia - condition wey dey occur wen di platelet count for di blood dey too low - bin dey stable, di statement tok.
Dat morning, di Pope "participate for di Holy Mass, togeda with those wey dey take care of am during dis days", di statement continue.
Di Vatican no give prediction, sake of di "complexity of di clinical picture".
On Saturday, di Vatican bin tok say di Pope experience respiratory crisis and bin dey "critical" condition, but later on Sunday, dem release update say e "no show any further respiratory crises".
Earlier on Sunday, di Pope bin drop statement wia e ask Catholics to pray for am afta e no dey able to deliver di traditional Angelus prayer in pesin for di second week running.
And for 21:00 (20:00 GMT) on Monday, those cardinals wey bin dey Rome go gather outside St Peter's Basilica to lead prayers for di Pope, togeda wit members of di Vatican curia and clergy from di Diocese of Rome.
Dem go continue to gather each evening, from now on, to recite di Rosary.
On Monday, na Cardinal Parolin, wey be di Vatican secretary of state go lead di evening prayer.
Pneumonia dey quick catch di Pope, an infection of di lungs wey bacteria, viruses or fungi dey cause, after e catch pleurisy - inflammation of di lungs - as a young man and undergo a partial lung removal.
Di leader of di Roman Catholic church don dey admitted to hospital multiple times during im 12-year tenure, including treatment for bronchitis for di same hospital for March 2023.
From Argentina, Pope Francis na di first Latin American, and first Jesuit, to lead di Roman Catholic Church.









