Takeaways from Ukraine President Zelensky meeting wit Donald Trump for White House

Wetin we call dis Video, Reporter wey bin criticise Zelensky for February say e gbadun im suit
Read am in 5 mins

Ukraine President Volodymyr Zelensky don meet wit US President Donald Trump for White House.

Some European leaders also dey for di White House wia di meeting bin happun, to meet wit Trump.

Zelensky arrival show say im welcome no dey ceremonial like dat of Vladimir Putin for Alaska.

Na three days ago Trump bin personally greet di Russian leader Putin as e step off im plane to red carpet, while fighter jets dey move ova im head.

Zelensky arrival for Washington dey lowkey but e no mind as di Ukrainian president dey more concerned about how di war for Ukraine go end.

Takeaways from Trump and Zelensky meeting

Donald Trump and Volodymyr Zelensky

Wia dis foto come from, Reuters

Di meeting wit Trump bin go silent as Zelensky look on while di US president tok for presence of oda officials.

Trump first tank Zelensky say e come di US today wia e say dem don make "progress to put end" to di war between Russia and Ukraine.

E say e get "veri good" meeting wit Putin and e get "good possibility say somtin fit come out of am".

Wen Zelensky tok, e tank Trump for im invitation and for im "personal efforts" to stop di war.

E also tank US First Lady Melania Trump for di letter wey she write give Vladimir Putin about di Ukrainian children wey Russia bin gbab.

E give Trump letter from Olena Zelenska, Ukraine first lady. "No be for you, na to your wife," e tell Trump as dem both laugh.

Zelensky support Trump 'diplomatic solution'

Dem ask Zelensky weda e go consider to give up territory. Di Ukrainian leader say "we need to stop di war, to stop Russia".

Zelensky say Ukrainians dey strong and say dem support Trump plans to end di war for "diplomatic way".

E say e want trilateral meeting wit di US president and Russia President Vladimir Putin.

Trump continue say a lot of pipo die last week. E say e and Zelensky wan see say di war end, and e say im believe say Putin want di same.

Dem ask Trump which side between Russia or Ukraine get di beta cards.

Trump say e no want tok becos no be im war as e blame former US President Joe Biden say e no stop Russia 2023 invasion, but e want make e end well for evrione.

Trump say e hope for 'long-term' peace

Dem also ask Trump if di US go send "American peacekeepers" go Ukraine to secure peace deal.

"We go work wit Ukraine, we go work wit evribodi " to make sure di peace na "veri long term".

E say di US go work wit both Russia and Ukraine to "make sure e work".

Ceasefire no dey necessary - Trump

One journalist ask Trump if serious consequences go dey if ceasefire no dey.

"I no tink say you need ceasefire," Trump reply. Di US president say e fit good but e say e no dey necessary for peace becos e feel say one kontri or di oda fit no want ceasefire.

Trump go call Putin afta di meeting

Trump say e go get phone call wit Putin "right afta" im meetings.

Trump say trilateral meeting fit dey and e fit no dey but if e no dey di fight go continue.

US president say if di trilateral meeting happun, e go get good chance for di war to end.

"E dey expect my call wen we finish wit dis meeting," Trump tok.

Zelensky look into di air on white cloth

Wia dis foto come from, Muhammed Selim Korkutata/Anadolu via Getty Images

Dis meeting wit Trump fit likely be one of di most important for Zelensky political career.

Bifor di meting, President Trump bin say Zelensky fit end di war between Russia and Ukraine "if im want to" but im give some conditions.

Meanwhile, di conditions na say Ukraine no go join Nato as part of a peace deal and Ukraine no go fit collect Crimea peninsula back from Russia.

Di President of di European Commission, Ursula von der Leyen, also dey for White House. She bin step out of her car wia di chief of protocol Monica Crowley greet her and say e dey "good to see you again".

British Prime Minister Sir Keir Starmer bin also arrive wit smiles as e comot im vehicle and enta di White House.

President of Finland Alexander Stubb also pull up to di White House.

Nato Chief Mark Rutte also dey White House - na im be di first of di European leaders wey arrive.

Meanwhile, Italy Prime Minister Giorgia Meloni, also dey for Washington today for di White House summit.

Italy Prime Minister tok for native Italian language say she dey happy say di proposal for Nato-like security guarantee dey part of today tok.

"We dey on di side of Ukraine, we support di efforts of di President of di United States," she tell reporters.

Who Trump and Zelensky bring along to di White House meeting?

Five US officials bin dey present for di room wit Donald Trump wen Volodymyr Zelensky meet di US president for di Oval Office today.

Dem be Vice President JD Vance, Secretary of State Marco Rubio, White House Chief of Staff Susie Wiles, special envoy Steve Witkoff, and special envoy Keith Kellogg.

Zelensky go bin also accompanied by Andriy Yermak, im top chief of staff and Rustem Umerov, former defence minister and now head of di National Security and Defence Council of Ukraine.