No ceasefire, no deal - Wetin Alaska summit mean for Trump, Putin and Ukraine

Wia dis foto come from, Reuters
US President Donald Trump and im Russian padi Vladimir Putin comot for Alaska witout any agreement to ceasefire for Ukraine.
Afta almost three-hour meeting, di leaders deliva joint statement to di media bifor dem comot witout ansa to kwesions.
Make we look wetin dis one mean for di US and Russian leaders as well as wetin go happun next for di war for Ukraine.
Meeting spoil Trump image as dealmaker
"Deal no dey until deal dey," Donald Trump tok early for im post-summit remark for Anchorage.
Na roundabout way to agree say afta several hours of tok, no deal. No ceasefire. Notin beta dey to report.
Di president say dat e and Vladimir Putin make "some great progress", but wit little details about wetin dat one be, e dey left for di world to imagine.
"We no get dia," e later say, bifor e comot di room witout taking any questions from di hundreds of reporters wey gada.
Trump travel long way to only produce such bad meeting, even if America European allies and Ukrainian officials fit dey relieved, e no offer unilateral concessions or agreements wey fit help future negotiations.
For di man wey like to call imsef as peacemaker and dealmaker, e be like say Trump go comot Alaska wit notin.
E also get no indications say future summit wey go include Ukrainian President Volodymyr Zelensky dey come, Putin "next time for Moscow" tok about dia next meeting.
While Trump get less at stake during dis negotiations dan Ukraine or Russia, e go still put dent for im domestic and international prestige afta e don earlier promise say dis meeting get only 25% chance of failure.
President Trump gatz suffer standing silent as Putin start off di press-conference wey no get extensive opening remarks. E dey different from di normal routine for di Oval Office, wen di US president dey incharge while im foreign padi go dey look wit no comment.
While Alaska na American territory, Putin feel at home like wetin be "Russian America" bifor dem sell dem give US for di 19th Century.
Di big kwesion now wey reporters no get chance ask Trump for Friday na weda e go decide to impose im new sanctions on Russia as punishment.
Di president partially address for friendly manner for one Fox News interview bifor e fly out wia e tok say e go consider di move "maybe in two weeks, three weeks".
But as di president promise "serious consequences" if Russia no move towards ceasefire, such unspecific ansa fit bring more kwesion dan ansa.

Wia dis foto come from, Reuters
Putin get im moment for di global spotlight
Wen "press conference" no be press conference?
Wen kwesions no dey.
Surprise dey di hall wen President Putin and Trump comot for di podium as soon as dem deliva dia statements wit no kwesion.
Members of di Russian delegation, too, comot for di room quickly and dem no ansa any of di kwesions wey journalists dey ask dem.
Clear signs say wen e come to di war for Ukraine, Vladimir Putin and Donald Trump still get major difference of opinion.
Donald Trump bin dey push for Russian ceasefire. Vladimir Putin no give am.
E get veri different vibe earlier fordo day. President Trump bin roll out di red carpet for Vladimir Putin, as e treat di Kremlin leader as honoured guest.
Today di Russian president gte im moment for di geo-political limelight, sharing di stage wit di leader of di world most powerful kontri.
But how Trump go react to wetin happun? E still neva manage to beg Putin to end Russia war for Ukraine.
Bifor, e go threaten tougher approach to Russia, wit ultimatums, deadlines and warnings of more sanctions if Moscow ignore calls for ceasefire.
E neva follow through.
Relief from Ukraine - but fear for wetin next
Wetin just happun for Anchorage fit no dey interesting for many, but for Kyiv dem go get relief say deal no dey announced wey go cost Ukraine territory.
Pipo for Ukraine go also know say all dia key deals wit Russia don end, so even if one dey announced for Anchorage, dem no go dey sure.
Ukrainians go dey on standby. Howeva, dat joint appearance for front of di media Vladimir Putin yet again speak of di "root causes" of di conflict and say only if dem comot dem bifor lasting peace go dey.
E mean say e dey determined to pursue di original objective of im "special military operation" - wey be to scatta Ukraine as independent state.
Three-and-a-half years of Western efforts don fail to make Putin change im mind, and dat also include di Alaska summit.
Di uncertainty wey kontinue afta di meeting also dey worry. Wetin go happun next? Russia attacks go kontinue?
Di past few months see different Western deadlines wey come and go witout consequences, and threats wey dem neva carry out.
Ukrainians see dis as invitation for Putin to kontinue im attacks.
Additional reports by: North America correspondent Anthony Zurcher, Vitaliy Shevchenko, Russia Editor BBC Monitoring, Steve Rosenberg, Russia editor










