Trump and Putin land Alaska for Ukraine toks

Trump and Putin shake hands

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Madeline Halpert, Christal Hayes and Jake Lapham
    • Role, BBC News
  • Read am in 8 mins

US President Donald Trump and im Russian counterpart Vladmir Putin don land Anchorage, Alaska, for di US-Russia summit.

Some of di US president closest allies wey join am for di attempt to broker peace for di Russia-Ukraine war na di Secretary of State Marco Rubio, White House special envoy Steve Witkoff and CIA director John Ratcliffe.

Five-member delegation wey include di Presidential aide Yuri Ushakov, Foreign Minister Sergei Lavrov, Defence Minister Andrei Belousov, Finance Minister Anton Siluanov and Russian Direct Investment Fund head Kirill Dmitriev dey accompany President Vladimir Putin go di first US-Russian leaders summit since 2021.

Trump dey expected to meet Russian President Vladimir Putin for Elmendorf-Richardson base around 11:30 local time (19:30 GMT/20:30 BST).

Dis na di first face-to-face interaction di two leaders go get since Oga Trump return to di White House for im second term.

Oga Trump tell tori pipo wey follow am on Air Force One again say im wan see a ceasefire between Russia and Ukraine "sharply".

"I no know if e go be today, but I no go dey happy if e no hapun today," e tok.

"Dis no get anytin to do wit Europe," e add. "Europe no fit tell me wetin to do but dem go dey involved for di process, obviously, as well as Zelensky."

E say US no dey spend money on di war for Ukraine, but dem dey make money - receiving "big, beautiful cheques" from Nato for supplying weapons.

"But I no care about dat," e say. "I dey chook mouth for dis to stop di killing."

Donald Trump and Vladmir Putin shake hands

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US President Donald Trump and im Russian counterpart Vladimir Putindey dey meet for Anchorage

Di venue for di high-profile meeting na Joint Base Elmendorf-Richardson - one US military installation for di northern edge of Alaska most-populated city.

White House officials tok say di base get di satisfied security requirements for hosting two world leaders. And, during di height of summer tourism, na few oda options dey for di for di sharp-sharp arrangey meeting.

Three rounds of toks between Russia and Ukraine wey hold for summer, at Trump request, no still bring di two sides any closer to peace.

Dis na wetin we know about di base, and wetin we fit expect from di meeting.

Why Putin and Trump dey meet?

Trump don dey push hard - without much success - to end di war for Ukraine.

Wen e still be presidential candidate, e bin vow say im fit end di war within 24 hours wen e enta office. E also don repeatedly argue say di war "no ever suppose hapun" if to say im bin president at di time of Russia invasion for 2022.

Last month, Trump tell BBC say Putin disappoint am.

Frustrations grow and Trump set 8 August as deadline for Putin to agree to one immediate ceasefire or face more severe US sanctions.

As di deadline hit, Trump instead announce say im and Putin go meet in pesin on 15 August.

Di meeting dey come afta US Special Envoy Steve Witkoff hold one "highly productive" toks wit Putin for Moscow on Wednesday, according to Trump.

Ahead of di meeting, di White House don reduce expectations on say di conversation between di two leaders fit result to a ceasefire.

"Dis na listening exercise for di president," White House Press Secretary Karoline Leavitt tok.

Speaking to reporters on Monday, Trump say im see di summit as a "feel-out meeting" wey di aim na to encourage Putin to end di war.

Wetin be Joint Base Elmendorf-Richardson?

A high angle shot of buildings surrounded by a lake and trees

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Joint Base Elmendorf-Richardson outside Anchorage go host di closely-watched meeting on Friday

Wit roots wey date back to di Cold War, Joint Base Elmendorf-Richardson na Alaska largest military base. Di 64,000-acre installation na one key US site for Arctic military readiness.

Snow-cap mountains, icy lakes and glaciers frame di base, wey dey regularly see temperatures as low as -12C (15F) for winter. However, di leaders fit expect fair weather temperatures of around 16C (61F) on Friday.

Wen Trump visit di base during im first term, for 2019, e tok say di troops wey dey there "serve for our kontri last frontier as America first line of defence".

More dan 30,000 pipo dey live on di site, and dat account for approximately 10% of di population of Anchorage.

Dem build di base for 1940, and na critical air defence site and central command point to stop threats from di Soviet Union during di Cold War.

For im peak for 1957, e host 200 fighter jets, and multiple air traffic control and early warning radar systems, wey earn am di nickname of "Top Cover for North America".

Di base still dey grow today sake of im strategic location and training facilities.

Map show Alaska, Canada, and Russia wit di Bering Sea in between. Anchorage dey marked in southern Alaska. Di map show how Alaska and Russia dey geographically close, na only one narrow stretch of water separate dem. One globe for di top left show di region location for di northern Pacific. E also show wia Joint Base Elmendorf Richardson dey.

Why dem dey meet for Alaska?

US buy Alaska from Russia for 1867, wey give di meeting for dat location historical significance. Alaska become US state for 1959.

Russian presidential assistant Yuri Ushakov bin tok say di two kontris be neighbours, as na only di Bering Strait separate dem.

"E look quite logical for our delegation simply to fly ova di Bering Strait and for such an important and anticipated summit of di leaders of di two kontris to hold for Alaska," Ushakov tok.

Di last time Alaska bin take centre-stage na for one American diplomatic event wey dem hold for March 2021, wen Joe Biden newly minted diplomatic and national security team meet dia Chinese counterparts for Anchorage.

Di sit-down bin later turn to gbasgbos, as di Chinese accuse di Americans of "condescension and hypocrisy".

Ukraine go attend?

Ukrainian President Volodymyr Zelensky no dey expected to attend. Trump bin tok on Monday say: "I for say e fit attend, but e don attend plenty meetings."

Trump however, tok say Zelensky go be di first pesin im go call afta di meeting.

One White House official later say Trump and Zelensky go do virtual meeting on Wednesday, ahead of di US president summit wit Putin. Several Europeans leaders go join di meeting wit Zelensky.

Putin bin request say make dem exclude Zelensky, although di White House don tok bifor now say Trump no mind to hold trilateral meeting, wia all three di leaders go dey present.

Zelensky don tok say any agreements without input from Ukraine go amount to "dead decisions".

Wetin both sides dey hope to get out of dis meeting?

While both Russia and Ukraine for long don tok say dem want make di war end, di two kontris want tins wey di oda seriously dey against.

Trump bin promise during im 2024 presidential campaign say ending di Ukraine war go dey easy plus say im go fit do am in a mata of days.

Dat promise don hang ova di American president efforts to resolve di conflict, as e don go from frustration wit di Ukrainians to di Russians since e return to di White House for January.

On Monday, Trump say im "go try get back some of di Ukraine territories wey Russia don kolobi back for Ukraine." But e also warn say e no easy as "some swapping, changes in land" fit dey necessary.

Ukraine, however, don stand dia ground say dem no go accept Russian control of regions wey Moscow don seize, including Crimea.

Zelensky tok say im no go agree to any idea of "swapping" territories.

"We no go reward Russia for wetin dem do," di Ukrainian president tok.

Wetin we call dis Video, Watch: 'We go change di battle lines' Trump on di war in Ukraine

However, for Putin, di first thing Putin e want from dis summit na sometin wey e don already get.

And dat na recognition.

Recognition from di world most powerful kontri, America, say Western efforts to isolate di Kremlin leader don fail.

Di fact say dis high-level meeting dey happun na testament to dat. Di Kremlin fit argue say Russia don come back to di top table of global politics.

Also, Putin no back down from im territorial demands, Ukraine neutrality and di future size of dia army.

Russia bin launch full-scale invasion of Ukraine, wit Putin belief say di Western defensive alliance, Nato, dey use di neighbouring kontri to gain foothold to bring dia troops closer to Russia borders.

Map show which areas of Ukraine dey under Russian military control or limited Russian control.

Meanwhile, Putin no back down from im territorial demands, Ukraine neutrality and di future size of dia army.

Russia bin launch full-scale invasion of Ukraine, wit Putin belief say di Western defensive alliance, Nato, dey use di neighbouring kontri to gain foothold to bring dia troops closer to Russia borders.

Get in touch

What questions do you have about Ukraine and the Trump and Putin meeting?

Trump administration don dey try to convince European leaders on a ceasefire deal wey fit hand ova some parts of Ukrainian territory to Russia, BBC US partner CBS News bin report.

Di agreement go allow Russia to keep control of di Crimean peninsula, and take di Donbas region of eastern Ukraine, wey dey made up of Donetsk and Luhansk, according to sources familiar wit di toks.

Russia illegally occupy Crimea for 2014 and dia forces dey control di majority of di Donbas region.

Under di deal, Russia go release Ukrainian regions of Kherson and Zaporizhzhia, wia dem currently get some military control.