Kasala burst for PDP secretariat as two faction clash, govnors and party leaders collect teargas

Wia dis foto come from, Chukwunaeme Obiejesi/BBC
Na serious kasala hapun on Tuesday 18 November 2025 for di secretariat of Nigeria biggest opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) wen two faction set meeting for di same place.
For inside Wadata plaza wey be PDP secretariat for Abuja, Nigeria capital, plenti police surround everywhere while dia vehicles station for different angles.
Di kasala begin burst as police fire teargas wey disturb pipo eyes well well, for wia di party wan hold dia meetings.
All dis hapun sake of di clash between two rival factions of di PDP wey dey claim leadership of di party.
Ova di weekend, one faction of di party organise dia national convention for Ibadan Oyo State, southwest Nigeria wia dem agree to expel di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike, di national secretary Sam Anyanwu, former Ekiti State guvnor Ayo Fayose, and odas.
PDP for dia national convention for Lekan Salami Stadium, Ibadan on Saturday and Sunday bin elect Kabiru Turaki (SAN) as dia National Chairman as dem also elect Taofeek Arapaja National Secretary.
Meanwhile, di Samuel Anyanwu leadership still dey claim say im still be di party national secretary until im tenure expire.
Anyanwu show for di PDP secretariat wia di two faction bin schedule meeting for di same location.
BBC News Pidgin monitor di whole kasala as e happun for di PDP headquarters wia we see how tins turn out.

Wia dis foto come from, Chukwunaeme Obiejesi/BBC
Wetin hapun for di PDP headquarters
Early Tuesday morning, party leaders of di PDP bin dey land for di headquarters wey be di same location wia di two faction put a venue for dia meeting.
Nyesom Wike wey be FCT minister and also one of di suspended PDP members bin dey for di meeting venue but e no come down from im car.
Security personnel bin surround im vehicle while di oda drama bin dey go om.
Meanwhile, di faction led by di Govnor of Oyo state, Seyi Makinde bin enta di venue to address di press.
Also present at di meeting na Bauchi State Govnor, Bala Mohammed wey also join for di press conference.
Bala Mohammed say dem bin wan show say dem don get enough of "Wike gangsterism."
Meanwhile, Seyi Makinde on im side say e no go address individuals personally sake of say dia struggle na to save Nigeria democracy and "no allow di kontri become one party state."
According to wetin BBC News Pidgin monitor, we see say teargas even touch Seyi Makinde and Bala Mohammed.
Wen dem dey comot di venue, we see dem dey use handkerchief to clean dia eyes sake of di effect of di teargas wey reach dem.
PDP factional national chairman ask Trump to save Nigeria Democracy

Wia dis foto come from, Official PDP/X
Afta di kasala wey burst for di PDP National Secretariat settle, di Govnor Seyi Makinde faction of di PDP wey Kabiru Turaki dey lead as di national chairman bin call on US President Donald Trump to come save Nigeria democracy.
Turaki, wey follow tori pipo tok for di party headquarters tok say apart from di alleged Christian genocide for Nigeria, democracy dey under threat.
"I wan call on President Trump, wetin dey at stake no be only genocide against Nigerian Christians, make e come save democracy for Nigeria, democracy dey under threat. I dey call oda developed nations, all advanced democracies, make dem come save Nigeria.
I no fit understand how a serving minister of di Federal Republic of Nigeria, go lead armed thugs and wit di active cooperation of di police, create mayhem for di headquarters of our party."
E also call Nigeria President Bola Tinubu to call im minister to order as e accuse am, say e "lead thugs" to come scata di secretariat.
"Make di president call im minister to order. Di kain behaviour wey di minister engage imsef inside dis morning dey unbecoming. How serving minister go lead thugs to scata legally arranged meeting?" e ask.
"Now, we don drive dem out of di secretariat, and as you can see, I don enta my office. I don assume leadership as di elected chairman," e tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Wike-led PDP faction expel three govnors and odas

Wia dis foto come from, Lere Olayinka/X
Meanwhile, di National Executive Committee (NEC) of di Peoples Democratic Party (PDP) wey dey loyal to di FCT minister Nyesom Wike don expel di govnors of Oyo, Bauchi and Zamfara States, Seyi Makinde, Bala Mohammed and Dauda Lawal from di party.
Di NEC also expel di former Board of Trustees Chairman, Senator Adolphus Wabara, Senator Kabiru Tanimu Turaki, Deputy National Chairman (South), Taofeek Arapaja, plus di recently elected party National Chairman, Kabiru Turaki.
Factional acting national chairman of di party, Mohammed Abdulrahman, wey present di memo for di expulsion for one meeting wey hold on Tuesday for di party national secretariat, say na sake of anti-party activities, disregard for court judgements, plus action e say put di party in disrepute.
One communiqué from di meeting wey di National Secretary Senator Sam Anyanwu read say, "NEC don receive di report of di Acting National Chairman, Abdulrahman Mohammed, wey detail breaches of Articles 58(1) and 59(1), including anti-party activities, disobedience to court orders, and conduct wey bring di party into disrepute."
Dem also dissolve di state executive councils for Oyo, Bauchi, Zamfara, Yobe, Lagos, and Ekiti states and direct di constitution of caretaker committees to conduct fresh congress.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2









