Tinubu confam death of Brigadier General Musa Uba - Di Army Commander wey ISWAP ambush

Foto of Nigeria President Bola Tinubu and Late Brigadier General Musa Uba

Wia dis foto come from, Presidency/Amaq

Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu don confam di death of high ranking Nigerian Army officer, Brigadier General Musa Uba wey die in di line of duty during ambush by terrorist group.

Di tok about di whereabouts of di Brigadier General Uba bin make pipo begin worry, afta fotos show wia terrorists bin gbab am.

Nigerian Army for one of dia previous statement say oga Uba bin dey on routine patrol to secure communities wey dey around Wajiroko for Azir Multe, Damboa LGA of Borno State.

Dat na di last time wey dem hear anytin about am, up till wen di video of di death Uba come dey trend.

Although di Nigerian Army no issue any statement to confam di whereabouts of Brigadier General Uba since 15 November.

But statement wey do presidency release on Tuesday through im tok tok pesin Bayo Onanuga, President Tinubu say e dey depressed to hear of di death of di senior army officer.

"As di Commander-in-Chief of di Armed Forces, I dey depressed wit di tragic death of our soldiers and officers on active duty. May God comfort di families of Brigadier General Musa Uba and oda fallen heroes.

President Tinubu send im condolences to di military ova di death of 'gallant sojas and Brigadier General Musa Uba, wey pay di ultimate price while on active duty to fight insurgents for Borno state.'

Wetin happun to Brigadier General Uba

Brigadier General Uba enta tori just few days afta di Nigeria Army say e lead troops of di 25 Task Force Brigade for Borno State.

As senior army officer, Brigadier General Uba na Brigade commander wey don lead officers of di army to different operations for Nigeria.

Nigerian Army say oga Uba bin dey on routine patrol to secure communities wey dey around Wajiroko for Azir Multe, Damboa LGA of Borno State.

Howeva, viral videos and pictures begin fly for social media wia terrorist group Islamic State West Africa Province (ISWAP) bin show footages of di Brigade Commander.

For di video wey di terrorist group bin release, dem show di face of di Brigade Commander for helpless position.

Although, di BBC no fit verify wia dem take di video and wen.

Also e bin no clear wia oga Uba dey despite ISWAP claims, until President Tinubu confam im death for 18 November 2025.

Borno State na one of di states for Nigeria wey don suffer bandits and terrorist groups attack.

For Sunday 12 January 2025, armed militia group wey be suspected Boko Haram/ISWAP terrorists attack some farmers and fishermen inside Dumba community, near Baga for Kukawa local goment area of Borno State, northeast Nigeria.

For early 2025, BBC News Pidgin report on how some local govment for Borno State dey under Boko Haram and Iswap control.

Local goments like Gudumbari, Marte and Abadam for Borno state na part of wia pipo wey dey live for dis places tell BBC News Pidgin say dem don dey under Boko Haram and Iswap control for over six years, and dem dey live inside fear evriday.

Now, di tori of Brigadier General Uba don raise plenti kwesion.

Who be Brigadier General Uba

Foto of Brigadier General Musa Uba

Wia dis foto come from, Amaq/X

Brigadier General Musa Uba na di commander 25 Brigade of di Nigeria Army.

For Nigeria Brigadier General na one-star General and e dey command Brigade or Regiment.

Dis rank dey among di Nigerian Army commissioned officers ranks. Dis na officers wey enta di military through di Nigerian Defense Academy (NDA) or di Direct Short Service Commission (DSSC).

Tori come for 15 November 2025 say terrorist groups don capture di Commander of Nigerian Army 25 Task Force Brigade for Damboa, Borno State, Brigadier General Uba.

Di report say na for Wajiroko village for Borno state di ambush happun wen e dey return from operation.

Nigeria Army confam say two sojas and two civilian task force die from di encounter wit di terrorists, but dem no mention names.

Brigadier General Uba na di highest ranking military officer wey terrorist groups go kpai since 2021.