Nigeria military react to surprise attack by ISWAP wia Lieutenant, five sojas and 34 terrorists die for Borno

Generic foto of armed men

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Nigerian military say dem counter one planned ambush by members of Islamic State West Africa Province (ISWAP) fighters on dia troops for Sabon Gari, Borno state, Northeast Nigeria.

Inside one statement wey di military tok-tok pesin, Maj Gen Edward Buba release, e say na on Saturday members of di armed group try launch surprise attack on one military camp for Sabon Gari.

But dem no succeed as "dem take di terrorists unaware, wen troops fighting patrol return to base scata dia planned attack as soon as di ttack start."

Major Buba add say through collabo wit di troop, Civilian Joint Taskforce, vigilante as well as hybrid forces, dem bin fit overpower di attackers."

"Di air component of Operation HADIN KAI bin do air operation as di attackers dey run for dia life, " im add.

Battle Damage Assessment show say 34 ISWAP members die and six army personel die for di gun battle.

Earlier, sources bin tell BBC Pidgin say di Boko Haram sect wey dey linked to Islamic State terrorist organisation, bin invade di Sabon Gari base for Damboa local goment area, kill one one lieutenant and five soldiers.

Local media say na seven soldiers die.

Di source wey no want make we tok im name add say di attackers kill di security agents for serious gun battle - den burn di army vehicles plus weapons inside di base.

Di military say dem no go reveal di name of di men wey die for the battle "to allow dem to conclude di administrative procedures of notifying dia next of kin."

Dis na di second time in two months wey Boko Haram militants don kill sojas in Nigeria.

In November 2024, dozens of sojas die for attacks by di armed group for Kareto village in Mobbar Local Government Area of Borno State

Sabon Gari military base dey strategic as e dey located just 100km to di Borno state capital Maiduguri.