How di new armed jihadist group Lakurawa dey operate?

Graphic foto of armed men

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Lakurawa na new group wey dey claim jihad wey don show face for northwest Nigeria.

But dem no dey operate beyond four local government areas: Binji, Gudu, and Tangaza and Silame local goment areas for Sokoto State.

Di group dey popular for di way dem dey preach give villagers and punish anybodi wey dem catch dey do any crime.

Dem dey also force pipo to pay Zakah and tax and also force parents marry off dia daughters to dem.

One source tell BBC say di members of di group enta dis areas for Sokoto from di Sahel region, wey include kontiris like Niger and Mali - dem also get pipo from different tribes from di Sahel.

But according to pipo wey dey live for dis villages, di group, wey dey carry dangerous weapons, first show face two years ago but dem no strong sake of Nigerian security forces for dat time pursue dem.

Di Defence Headquarters for Nigeria don confam di existence of di terror group.

Di Director of Defence Media Operations, Maj Gen Edward Buba, tok dis one wen e brief tori pipo on military operations on Thursday for Abuja.

E tok say di new terror group come from Republic of Niger afta di recent coup wey disrupt military cooperation between Nigeria and Niger.

According to Buba, di terrorists from di Niger Republic and Mali begin infiltrate di northern areas of Sokoto and Kebbi States afta di coup for Niger.

How di armed Lakurawa group dey operate

Dem dey preach to pipo, dey tell dem say dem no get anytin do wit police, sojas, or any politicians and goment officials, and dem no like Western education too.

Di source still tok say di armed men dey tok to pipo in different languages.

Reports show say wen dem dey preach or dey teach pipo, dem dey translate into Hausa, Fulfulde, Abzinanci, English and oda languages.

Di source still tell BBC News Pidgin say eight months ago afta security for Niger Republic push dem out of dia kontri, di group come back to Sokoto area.

In di beginning, pipo bin dey happy as di group show becos dem kill di bandits wey don dey disturb di areas of Sokoto, dem kill dem and collect dia weapons.

"For now, we no get bandits again, and we fit go farm witout fear sake of dem don chase all di bandits comot from our villages; some of di bandits even join di group and dem dey work togeda now."

E add say “Dem dey go round in villages preaching, prohibiting pipo from playing and hearing music or even change Imams dat dey lead prayers for mosque wen dem find am wit faults”

“Pipo wey dey smoke cigrate na dem dey suffer sake of beating dem go collect most becos dem fit loose dia lives if dem get caught by Lakurawa.”

E also tok say dem dey punish youths wey do hair style dat dey feel na inappropriate.

“For youths wey dey barb any kain style dem dey punish dem if dey no get rid di hair style, and dem dey instruct women to wear long hijabs.”

On how dem dey recruit pipo for dia organization be say dem dey go round villages dey tok say dem need somebodi wey go help dem go round or hold dia weapons for dem.

“Wen eva dem come dem dey announce say dem need somebodi wey fit help dem do dia work for di village, going round to find pipo wey do sometin bad and punish dem.”

E add say “Wen dey see dat person wey help dem dey good dem dey recruit am tell am say you dey in charge of dis part of di village which give di authority to punish anybody wey do sometin bad.”

Di residents say wetin dem fear pass be say dem no know wetin dis group dey up to and di kain of authority and oda dem dey give dem.

Dem tok say di worst part na di way dem start to forcefully make parent to marry off dia daughters for dem becos dem dey veri afraid for dem lives.

“At least dem don marry more dan 10 girls for our villages becos we dey fear we no fit say no to dem wen dem bring marriage proposal.”

As for Zakah wey be a practice wia a Muslim go give 2.5 per cent of im wealth, di residents tok say dem dey go round see pipo wey rich dey collect Zakah from dem, and for pipo wey no gree pay fit loose dia entire wealth.

For oda villages, BBC source say Lakurawa don start dey put tax for villages wey dem dey ask married men to bring one mudu (measure) of beans while married women go bring one mudu of millet as tax.

Di residents add say pipo dey fear di group pass sojas or oda security agencies for Nigeria becos as e dey now dia districts heads for di villages no get power at all.

Dey also tok say dis group dey rich well well and dem don pass more dan 1,000 pipo for di orgnization, and dem get modern equipment wey include phones, computers and even di way dem dey source dia electricity wey be solar.