Israeli football fans attack for Amsterdam - wetin we know

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Paul Kirby
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Officials say Israeli football fans face series of attacks for di centre of Amsterdam, riot police intervene several times to protect dem.
Prime Minister Dick Schoof condemn di "antisemitic attacks" and Israel military tok of "severe and violent incidents against Israelis". Di earlier plans to send "rescue planes" to bring Israelis home dem don cancel am.
Amsterdam mayor and authorities say even wit all di plenty police presence, Israeli fans wunjure for several parts of di Dutch capital.
Supporters of Israeli club Maccabi Tel Aviv bin travel go Amsterdam for dia Europa League match against Ajax.
Schoof say im dey follow di developments wit horror, im add say im don follow Netanyahu tok and im knack hand for ground say di "pipo wey get hand for di mata dem go track dem down and prosecute dem".
Police say dem detain 57 pipo. Tori be say wahala bin don dey for Dam Square wia dem even arrest some pipo ahead of di match wey involve Maccabi fans and pro-Palestinian protesters, and reports of supporters wey set off fireworks and tear down a Palestinian flag for one nearby street.
But di kasala kotinu to increase afta di game. Police say e no clear who take part for di riots, e tel local pipo say those wey bin dey involve bin dey wear dark cloth.
Several videos wey full social media, one show one man as dem bin dey kick and beat am for ground and anoda one show show pesin wey dey run ova . For some videos,you go hear pipo dey shout pro-Palestinian slogans, although di footage BBC neva verify am.
Israeli President Isaac Herzog speak for one "pogrom" against Maccabi fans and Israeli citizens. Dutch anti-Islam politician Geert Wilders wey dey lead di biggest party for parliament im also speak for one pogrom, say dem go hold "authorities accountable for dia failure to protect di Israeli citizens".
Amsterdam Mayor Femke Halsema bin earlier try to prevent trouble by moving pro-Palestinian protesters away from the Johan Cruyff Arena. But Dutch reports say a large group bin try to head to go di stadium, only for riot police to stopped dem.

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock
Herzog tok for X say im trust say di Dutch authorities go act immediately to "protect, locate and rescue all Israelis and Jews under attack".
Israeli officials urge citizens to remain for dia hotels and public broadcaster Kan quote di foreign ministry say e don lose contact wih three pipo.
Di US special envoy on antisemitism, Deborah Lipstadt, say she dey horrified by di attacks for Amsterdam, wey "terribly remind am of a classic pogrom" and add say she dey deeply disturbed by how long they dem las.
She say di violence bin take place two days bifor di anniversary of di Nazi progrom against Jews for Germany for November 1938.










