Authorities release names of 25 schoolgirls bandits kidnap from Kebbi State

Foto of di school hostel

Wia dis foto come from, Mustapha Ibrahim Maga/BBC

Read am in 6 mins

Di Chairman of Danko/Wasagu Local Government Area of Kebbi State, Hussaini Aliyu wia bandits kidnap schoolgirls on Monday don release di names of di girls wey di terrorists kidnap from Government Girls Comprehensive Secondary School, Maga.

Di terrorists kidnap 25 girls but two girls escape, wey leave dem wit 23 girls.

We no fit name dem to protect dem.

Nigeria president Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

Meanwhile, President Bola Tinubu don postpone im scheduled trip to South Africa and Luanda.

Di Nigeria leader suppose comot Abuja dis Wednesday to attend di 20th G20 Summit of leaders for South Africa and from dia, travel go Luanda to attend di 7th AU-EU Summit, but now, e don announce di postponement of dat trip afta bandits attack one church for Eruku, Kwara state, north-central Nigeria.

Dis na about one day afta gunmen kidnap some schoolgirls for Kebbi State.

For statement wey di Special Adviser to di president on Information and Strategy, Bayo Onanuga release on Wednesday, e say Oga Tinubu postpone im trip as e dey await further security briefings on di recent attacks wey don shake di nation.

"Disturbed by di security breaches for Kebbi State and Tuesday attack by bandits against worshippers for Christ Apostolic Church, Eruku, President Tinubu don decide to suspend im departure," Onanuga tok for di statement.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

President Tinubu wey tok say im dey "depressed" about di recent terrorists attacks plus di kidnap of di schoolgirls, tok say im direct security agents to get into action.

"As di Commander-in-Chief of di Armed Forces, I dey depressed wit di tragic death of our sojas and officers on active duty. May God comfort di families of Brigadier General Musa Uba and oda fallen heroes.

"I also dey depressed say heartless terrorists don scata di education of innocent schoolgirls," President Tinubu add.

On di Eruku church attack, di Nigerian leader tok say im don direct police to go afta di bandits wey attack worshippers, and don order di deployment of more security men to di area.

E say "dos wey dey threaten di safety of di citizens go face di full weight of di Nigerian state."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Three major attacks wey happun for Nigeria inside one week

Inside just one week, three bad attacks don hapun for different parts of di kontri from Northeast go Northwest, and di last one hapun for North Central.

For Borno State for northeast, pipo wake up on Monday morning to hear report say Brigadier General Musa Uba don die in di line of duty after terrorists ambush am.

Di tok about di whereabouts of di Brigadier General Uba bin make pipo begin worry, afta fotos show wia terrorists bin gbab am.

Nigerian Army for one of dia previous statement say oga Uba bin dey on routine patrol to secure communities wey dey around Wajiroko for Azir Multe, Damboa LGA of Borno State.

Dat na di last time wey dem hear anytin about am, up till wen di video of di death of Uba come dey trend.

Although di Nigerian Army no issue any statement to confam di whereabouts of Brigadier General Uba since 15 November, but statement wey di presidency release on Tuesday through im tok tok pesin Bayo Onanuga, President Tinubu say e dey depressed to hear of di death of di senior army officer.

Anoda attack wey hapun for Kebbi State for northwest Nigeria na di kidnapping of schoolgirls, but some of dem later manage escape from di hand of di bandits.

Tori be say bandits capture 25 students from di Government Girls Comprehensive Secondary School for early hours of Monday.

Di attack hapun for di school wey dey Danko/Wasagu Local Govment Area of Kebbi State, northern Nigeria.

Local sources tell BBC News Pidgin say di bandits kill one school teacher bifor dem carry di girls, and later kill one school security guard.

Di federal Govment don show deep concern and solidarity wit families of di female students wey bandits abduct from di school.

For Kwara State, for north-central region of Nigeria, anoda deadly attack for one church for di town of Eruku, wia jaguda pipo bin open fire on top pipo wey gada to pray for Tuesday evening.

Di attack hapun for di Christ Apostolic Church (CAC) for Oke Isegun, for Ekiti Local Government Are, Kwara state during di church evening programme.

Di bandits shoot di pastor of di church bifor dem round up di worshippers at gunpoint.

For dia statement, di police tok say: "As we search di area, we discover one male victim wey dem shoot die inside di Christ Apostolic Church, Oke Isegun, while we also find anoda victim of fatal gunshot for di bush.

Meanwhile, eyewitnesses say na three pipo die for di attack wey hapun contrary to wetin police tok.

Di eyewitness wey be member of di Church also say di bandits carry over 30 of dia members enta bush. E say dem no fit account for 35 of dia worshipers

Politicians, religious leaders, celebrities condemn attacks

Plenty reactions don trail dis attacks, from prominent politicians, religious leaders to celebrities, all of dem don condemn di attacks as dem call on govment to put an end to am.

Popular gospel musician Nathaniel Bassey pray for will and courage for di govment, security forces and citizens to rise and fight against di killings and abductions.

"As long as we ignore and pretend about dis evils, di destiny of dis nation go only remain a wish."

E also call on God judgement on di killers, kidnappers, bandits plus di architects of these evil systems and structures as well as dia sympathizers, e say dem "MUST BE JUDGED!".

Former Kano state Govnor, Rabiu Kwankwaso call on di authorities to take decisive action by reinvigorating di armed forces and empower di Nigeria Police Force to effectively protect and defend Nigerians from these acts of terror.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Prominent Pastors, Jerry Eze, Emmanuel Iren also comment on di mata.

Pastor Jerry Eze screengrab

Wia dis foto come from, Jerry Eze/X

Screengrab of a tweet from Apostle Emmanuel Iren

Wia dis foto come from, Apostle Emmanuel Iren/X

Meanwhile, Nigeria Vice President Kashim Shettima, don land Kebbi State on di directive of di president and currently dey for closed-door meeting wit di state Govnor Nasiru Idris sake of di schoolgirls wey dem kidnap from Government Girls Secondary School, Maga.

Di president bin make am clear say bringing di innocent children home safely na di "singular, non-negotiable priority" and dem don deploy every security asset for dia rescue, di vice president tok.