Kwara State shut down schools for four local govment sake of security wahala

Wia dis foto come from, NurPhoto/Getty Image
Kwara State Govment don order make schools for four local govment areas close sake of insecurity wey dey rise for some communities.
Dis dey inside one statement wey di Nigeria Union of Teachers (NUT), Kwara State branch release, wey announce di govment decision on Wednesday.
For one circular wey dem issue on Wednesday, NUT Chairman, Yusuf Agboola, tok say schools for Isin, Irepodun, Ifelodun and Ekiti LGAs go shut down.
Agboola explain say di union dey follow strict instruction from di Ministry of Education and Human Capital Development after govment raise concern about new security threats wey dey happun for Kwara South.
"Comrade chairmen, dis message na to inform una and through una to all di schools wey dey inside di above local govments say govment don give order make all schools for dose local govments close down immediately till dem give further notice.
Dis decision come sake of di security wahala wey dey worry di area and govment dey try control di mata
On di oda hana Dr. Lawal Olohungbebe, Commissioner for Education and Human Capital Development for Kwara State also release anoda statement on Thursday. Di statement tok say di govment activate proactive security measures for schools, as part of im wider efforts to guarantee a safer environment for schoolchildren.
"Di measures dey immediately affect schools for Ifelodun, Ekiti, Irepodun, Isin, and Oke Ero Local Govment Areas, to show di determination of di govment to reduce di activities of kidnappers wey fit wan use schoolchildren as human shields from renewed security crackdowns." Di statement also tok say di measures also cover di boarding schools for Irepodun wey fit be targets of di criminals wey dey run for cover as security operations dey widen. "Di measure fit remain in place till dem dey wait for further security clearance bifor normal activities go resume" Dr Olohungbebe tok
Dis one dey come few days afta di brutal attack for one church for Eruku, Ekiti Local Govment Area of di state, wia dem kill and pack pipo wey dey worship for church.
Also on Monday bandits bin attack one secondary school for Kebbi State northwest Nigeria wia dem pack more dan 20 schoolgirls.
Times wey dem close schools sake of bandits attack for Nigeria
Di last time wey Nigeria close schools sake of bandits attack na for Abuja 2022.
Dem tell all schools make dem shut down and send children go house sake of security wahala for Abuja and Nasarawa state.
Dat time, intelligence reports say armed groups dey plan attacks for different states, including di capital city.
For some years now, schools especially for northern Nigeria don turn target for kidnapping gangs, and dem don hold hundreds of students for ransom.
For 2021, schools for northern Nigeria see increase attacks from armed criminals wey abduct hundreds of students for Katsina state.
Di kidnappers bin carry more dan 300 boys from one school for Kankara area for December, but later release dem.
Authorities for Katsina come order all public boarding schools make dem close bicos attacks for schools for north-west don increase.
For 2020, many states for northern Nigeria also order schools to close afta hundreds of pupils bin kidnap for Katsina state.
Kano, Kaduna, Zamfara and Jigawa follow Katsina close schools afta di attack.
Boko Haram, di Islamist militant group, claim say na dem do di raid.







