US go review visas wey Nigerians and oda citizens hold, promise to take action if dem break rules

US President Donald Trump sitting and smiling

Wia dis foto come from, Andrew Harnik/Getty Images

    • Author, Danai Nesta Kupemba
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Di United States say dem go torchlight records of more dan 55 million pipo wey dey hold US visa to know weda dem don break di conditions wey carry dem enta or allow dem stay for di kontri.

Dis na anoda level of tension for Nigerians plus all oda world pipo wey dey hold US visa.

One state department official pesin tell tori pipo Associated Press say, pipo wey dey hold US visa go dey under "constant torchlighting."

If anybody "overstay, dey do criminal activity, be threat to public safety, get hand for any form of terrorist activity, or dey provide support to terrorist organisation", dem go cancel im visa, di official say.

President Donald Trump don make anti-immigration di koko of im second term for office.

Marco Rubio man wearing a blue tie, dark suit and white shirt looks off to the right. His mouth is slightly open as he is mid-conversation. He is wearing a pin with the American eagle on his right lapel.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Secretary of State Marco Rubio don announce say dem get several measures dis year wey go help reduce immigration

From mass deportation, full travel ban on some kontris, to cancelling 6,000 student visas, di president dey fight immigration.

As part of di torchlighting, students wey dey plan go study plus visitors wey wan go US, must face social media investigate as officials of dey look for "any sign say di pesin dey hostile to dia citizens, culture, goment, institutions, or founding principles of United States".

State Department officers don also receive order to identify pipo wey dey "advocate for, help, or support designated foreign terrorists plus oda threats to national security; or wey dey di unlawful antisemitic harassment or violence".

Matthew Tragesser, one tok tok pesin for US Citizenship and Immigration Services, for one statement say: "dem no go give America benefits to pipo wey hate di kontri and wey dey promote anti-American ideas."

Im add say di immigration service dey committed to "implement policies" wey go "root out anti-Americanism".

Dis latest announcement dey come afta Secretary of State Marco Rubio say US go "immediately" stop to dey give worker visas for truck drivers.

"Di increasing number of foreign drivers wey dey operate big tractor-trailer trucks on U.S. roads dey put di life of Americans for danger plus affect job opportunities for American trucker drivers," Rubio write for one post on X on Thursday.

Since Trump enta office for January, dem don arrest several foreign students for US university campuses sake of dem follow do protests against di way wey Israel take dey do di war for Gaza Strip – wey US dey support.

Few weeks ago, US bin announce say Malawi and Zambia kontri pipo go pay $15,000 (£11,300) deposit for tourist or business visa.

Trump don also ban foreigners from 12 kontris make dem no travel go US. E also sama partial restrictions give seven oda kontri.

For May, court bin temporarily allow Trump goment to cancel di legal status of over 500,000 migrants wey dey live for US. E even swear say im go end birthright citizenship.