Six big immigration changes under Trump - and dia impact so far

Wetin we call dis Video, Watch: See US-Mexico border for Trump first week in office
    • Author, Nadine Yousif
    • Role, BBC News
  • Read am in 7 mins

Since im enta office on Monday, President Donald Trump don announce plenty immigration-related executive orders, to clear road to crack down on undocumented migrants for US.

For more than 21 actions, Trump don move to overhaul parts of di US immigration system, including how dem go process and deport migrants from US.

White House don publicise some of these efforts. On Friday, di new White House Press Secretary share images of deportation flights wey military cargo planes carry out.

While Trump don promise "mass deportations" and arrests, e still no clear how much of im plan dem already don dey implement.

Dis na breakdown of some of di significant actions wey Trump don take on immigration for im first week, and how dem compare to past policies.

Deportation of migrants

One cornerstone of Trump immigration policy na to remove unlawful migrants out of US and di promise of "mass deportations".

To dat effect, the Department of Defence say dem go provide military aircrafts to deport more dan 5,000 pipo wey Border Patrol detain for San Diego and El Paso, Texas.

ICE statistics show say na ova 1,000 pipo dem remove or repatriate on Thursday, for day four of Trump administration.

Trump don also move to expand di scope of expedited deportations of undocumented migrants, im revive one policy under im first term wey Biden stop.

Tori be say expedited removals bifor bin dey limited to areas within 100 miles (160km) of US international borders, and im apply to those pipo wey no request asylum or fail to show a legitimate case for asylum.

With Trump changes, dis removals fit now occur anywhere for US, and e go apply to undocumented migrants wey no fit prove say dem don dey di kontri for more dan two years.

Deportations no dey unique to Trump administration.

Biden bin carry out deportations as well, im deport 271,000 immigrants to 192 kontris for 2024 fiscal year. Dis amount to around 740 a day, and e make di current preliminary figures under Trump to dey slightly higher.

In total, Biden carry out 1.5 million deportations for im four years, according to figures by di Migration Policy Institute. Dat na around di same wey happun under Trump first term.

Dat number dey lower dan di deportations wey Barack Obama's carry out for im first term, wey add up to a total of 2.9 million.

US troops amongst a maze of barbed wire for border for Texas

Wia dis foto come from, Getty Images

Fortifying di US-Mexico border

Di Pentagon announce on Wednesday say dem go deploy 1,500 active duty soja go di southern US border. Dis na in addition to 2,500 active-duty personnel wey already dey dia, officials tok – dis mark a 60% increase in Army troops for di area.

Di sojas go fly helicopters to help Border Patrol agents wit monitoring, na wetin acting Defense Secretary Robert Salesses tok. Dem go also help for di construction of barriers to stop migrants from coming in.

Salesses tok say "dis na just di beginning" and add say dem go send more sojas soon.

Officials add say a number of additional "border enforcement missions" dey dia plan, dem no provide specifics.

Biden also bin deploy active-duty soja for border, wey dem use to assist Border Patrol wit primarily administrative tasks ahead of di expiration of Title 42, one public health order wey dem use to expel migrants sharp-sharp during Covid-19.

Border crossings significantly drop for Biden's final year as president. For December 2024 – di last full month of di Biden administration – dem record about 47,330 migrant apprehension, down from a high of nearly 250,000 for December 2023.

Di figures dey lower dan di monthly averages for Trump first term, before di Covid-19 pandemic. In May 2019, for example, border patrol agents record 132,800 migrant encounters.

Construction dey happun for Mexico border wall

Wia dis foto come from, Getty Images

Trump don stop di processing of migrants and asylum seekers

For one executive order, Trump suspend di entry of all undocumented migrants to US, and give border patrol agents instruction to turn pipo away without granting dem asylum hearings.

Before di order, migrants fit arrive US border and dem get di legal right to seek asylum.

For June 2024, however, Biden administration issue dia own executive order wey bin temporarily suspend di right to seek asylum for those wey no arrive for an official point of entry, or without an appointment using CBP One, a mobile application. For September, dem tighten di asylum restrictions more.

Trump don also halt di US refugee resettlement programme. Under Biden for 2024, di US bin accept more dan 100,000 refugees - dia highest since 1995.

Im also end a major Biden-era programme wey allow up to 30,000 migrants per month from Cuba, Haiti, Nicaragua and Venezuela to fly enta US on humanitarian grounds.

Di "Remain in Mexico" policy from Trump first-term e don bring am back too. Dis force non-Mexican asylum seekers to wait for Mexico until dia asylum claims for US dey resolved. Dis affect around 71,000 pipo under Trump first term.

Di controversial policy immigration advocates bin criticise am well-well, dem say often times migrants go dey Mexico for months and sometimes criminal gangs go begin worry.

Tori be say di estimated backlog reach 3.6m cases for US immigration courts, and migrants often dey wait years. Many dey wonder whether dem go still hear those cases.

Trump don fire several top immigration court officials since im take office, however, dis fit affect di processing of those cases.

See error message for CBP One app

Wia dis foto come from, Getty Images

Cancelling existing migrants' appointments

One big change wey pipo feel almost immediately afta Trump take office na di scrapping of di CBP One smartphone app, wey migrants bin dey to use to schedule appointments wit US border patrol agents.

Di CBP One app na Biden administration launch am as a way to organise and streamline di entry of migrants wey dey run from prosecution.

Some 30,000 pipo now dey stranded inside Mexico since dem take down di app - all of dem wey bin get scheduled appointments now don cancel.

Na estimate of about 270,000 migrants dey on di Mexican side of di border wey bin dey wait to get appointments through di app, according to goment figures from CBS, BBC US partner.

Di move pain migrants wey bin travel long journeys go di border, and wey don wait months to secure those appointments.

Advocates say, wit di removal, dem no get practical pathway to protection for arriving migrants.

Di American Civil Liberties Union don file case for court to challenge against di app closure.

Construction of migrant shelters by Mexico

Mexico dey anticipate influx of migrants from Trump deportation orders, so dem don start to build giant tent shelters for nine border cities to temporarily house them.

Municipal official Enrique Licon of Ciudad Juárez – one city wit borders for El Paso, Texas - tell Reuters say dis shelters go fit house thousands of pipo and add say dem go dey ready in a few days, e call di effort "unprecedented".

Dis shelters go provide food for pipo, medical care and assistance in getting identification documents. A fleet of buses also dey ready to help transport Mexicans back to dia hometowns.

Na part a larger effort wey dem call "Mexico Embraces You", a government-wide campaign to welcome citizens who dem fit deport from US and help reintegrate dem back for dia home kontri.

Oda nearby nations - like Guatemala – dey launch similar efforts to absorb dia deportees.

But some don raise concerns about whether Mexico and odas dey ready to handle di number of pipo wey fit dey come dia way.

Many of di migrants dey also run from di political wahala or criminal violence for dia home kontris, dis raise di kwesion about whether dem go dey safe if dem return.

Mexican official erect tents to house migrants

Wia dis foto come from, Getty Images

Im expand di powers of ICE to carry out raids

Some of Trump executive orders wey im sign im plan na to expand Immigration and Customs Enforcement (ICE) ability to arrest and detain unlawful migrants for US soil.

One of dem reverse one longstanding guideline wey bin prohibited immigration raids for areas wey dem deem "sensitive", like schools, hospitals and churches.

Anoda call for expansion of one programme wey go allow ICE to delegate dia immigration enforcement duties to state and local police.

E still no clear how many raids wey don take place since inauguration day.

Cities dem prepare themselves for di large-scale raids wey Trump promise, but sources don tell US media say ICE don only conduct"routine operations" so far.

White House tok-tok pesin Karoline Leavitt say na 538 arrests dem carry out on Thursday.

For comparison, ICE detain more dan 149,700 for 2024 fiscal year under di Biden administration, dis equal an average of 409 a day.