Ex-Nigerian goalkeeper Peter Rufai make im final journey home

Peter Rufai making his final journey home
Read am in 4 mins

Friends and family no fit hold dia tears as dem bury legendary ex-Nigerian goalkeeper Peter Rufai on Friday 22 August.

Na for Ikoyi Cemetery for Lagos, southwest Nigeria, dem bury Dodo Mayana as pipo dey call am.

Di legendary goalkeeper die on Thursday 3 July at di age of 61.

Rufai bin sick for some weeks, bifor e give up di ghost for one hospital for Lagos.

Super Eagles for dia post on social media hail di legendary goalkeeper say e go dey "forever in our hearts".

'I no go eva advise even my son to put im feet for dis kontri' Taribo West

For di burial, former Super Eagles defender Taribo West express anger sake of di treatment wey e say Rufai bin get wen e dey alive.

E criticise di Nigerian govment and football authorities for di kontri sake of say, according to im, Rufai family gatz beg for funds to give di former goalkeeper correct burial.

Taribo say im no go advise even im son to put im feet for Nigeria.

"For me, e dey disheartening say you get Lagos State, you get Nigeria football association, dem drop di bulk on di family. I bin feel inside my spirit, notin dey to put your life for," e tok.

Taribo say wen im mama and papa die, e no cry, but wen Rufai die, e bin get goose pimples for im bodi.

"Which kain nation be dis? Wit dis kain example wey dem don show for Shofoluwe, for Stephen Keshi, blessed memory, Thompson Oliha, blessed memory, Rashidi Yekini, I no go eva advise even my son to put im feet for dis kontri," Taribo tok.

E wonder weda Nigeria get football federation or football association for Lagos State wey be say "dis hero dis soldier, dis football evangelist gatz dey treated dis way and im family".

"You fit imagine say di family go dey cry just to solicit within our group to ask for money, dat na madness."

Photos from di burial

Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making im final journey home
Peter Rufai making his final journey home
Peter Rufai making im final journey home
Peter Rufai making im final journey home
Peter Rufai making im final journey home