Hundreds die, mountain collapse for Sudan landslide

Wia dis foto come from, SLM via AFP
- Author, Cecilia Macaulay
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
One aid worker wey dey support rescue efforts for Sudan afta di devastating landslide wey reportedly kill hundreds of pipo tell BBC say, e don make one "mountain to collapse", and na only one pesin survive so far.
"We don so far manage to recover nine bodies, "Abdul Hafeez Ali, di head of di Coordinating Council of di Tawila and Jebel Marra Emergency Room tok.
One heavy rainfall on Sunday, 31 August bin lead to di disaster, wey kill at least 370 pipo according to one UN estimate, and e "destroy di village" of Tarseen for di western Darfur region, Oga Ali add.
Di armed group wey dey in control of di area bin tok say na 1,000 pipo die, and e beg for urgent assistance.
Anoda man tell BBC Sudan lifeline programme say im still neva see many members of im family afta di landslide incident.
"So far, I don confam di deaths of two relatives: one of my uncles and im grandson. Di rest of my family members still dey miss," Ahmed Abdel Majeed, wey dey live for Uganda but originally from Tarseen and dey keep in touch wit locals from around di affected area tok.
"Di bodies still dey buried under di rubble," e add say rescue teams dey struggle to find dem sake of "massive blocks of stone and mud wey cover di area".
One initial estimate of deaths wey di group wey dey control di Marra Mountains area, di Sudan Liberation Movement/Army (SLM/A), bin tok bifor na say 1,000 fit don die.
UN deputy humanitarian co-ordinator for Sudan, Antoine Gérard, say e dey difficult to determine di exact death toll bicos di area dey hard to reach.
For one interview wit BBC Newsday radio programme, SLM/A leader Abdel Wahid Mohamed al-Nur stand by im group estimate of di number of pipo wey don die, e say many pipo don run sake of di kontri civil war go places wey dey relatively peaceful.
Di SLM/A bin dey neutral for di conflict wey don scata most part of di kontri ova di past two years.
"Pipo for ground don confam di [death toll]. We get civil authority there and dem estimate say above 1,000 pipo go don die or dem at least dey under di mud," Oga Nur tok.
E also call for emergency aid like medical supplies and food plus urgent rescue efforts.
Speaking to di AFP news agency on Wednesday, 3 September, one SLM/A official say dem don recover 270 bodies.
"Hundreds still dey trapped under di rubble wey swallow homes and farmland," Mogeeb al-Rahman Mohamed al-Zubeir tokvvia satellite phone.
Aid worker Mr Ali tok say carrying out im work dey hard sake of di conditions.
"Unfortunately, sake of limited resources, we neva fit to carry out full-scale rescue operations. Although, one support team don already land Sudan, but di ongoing heavy rains and extremely rough terrain don make access to di affected area very difficult.
Despite dis challenges, di search for di missing continue."
Oga Majeed add say to communicate wit dos for di affected area dey challenging: "I try to stay in contact wit di rescue teams, but communication dey difficult. No networks dey work for di area bicos di solar-powered systems don go down."
E say di Sunday landslide affect two villages.








