Offenders go chop five years for prison as Burkina Faso ban homosexuality

Ibrahim Traore

Wia dis foto come from, Stanislav Krasilnikov / RIA Novosti/Anadolu via Getty Images

Read am in 3 mins

Burkina Faso military junta don pass one new law wey criminalise same-sex relationships for di Sahel kontri.

Dis move dey come about one year afta dem adopt di draft of one amended family code wey criminalise homosexuality.

Bifor now, di Sahel nation bin dey among 22 out of 54 African kontris wey allow same-sex relations, wey dey punishable by death or lengthy prison terms for some kontris.

On Monday, 1 September, di junta bin unanimously pass di law wey ban homosexuality wey dem say be part of one wider reform of family and citizenship legislation.

Di new law wey compulsory punishments of up to five years in jail, don become part of a broader crackdown on same-sex relationships across di continent.

71 unelected members of transitional parliament wey don dey ground since two coups for 2022 for di West African nation adopt di draft law.

Justice Minister Edasso Rodrigue Bayala announce on state run media RTB say, "di law provide prison sentence of between two and five years plus fines."

E explain say any pesin wey dem suspect say e engage in homosexual or similar practices, and "all bizarre behaviour," go dey prosecuted, e add say foreign nationals go dey deported under di law.

Last year, neighbouring Mali, wey be ally of Burkina Faso, wey junta also dey rule bin adopt law wey criminalise homosexuality.

Plenty significant backlash and criticism don dey against kontris wey toughen dia anti-gay stance in recent years. Ghana, Nigeria, and Uganda dey among di kontris on di continent wey don enact laws banning homosexuality.

Of all di kontris, na Uganda adopt di toughest provisions, wey make "aggravated homosexuality" capital offence and impose life sentences for consensual same-sex relations.

Di World Bank bin pause new loans to President Yoweri Museveni govment while di US stop to dey give Ugandan goods preferential access to dia markets, afta di adoption of di legislation for 2024.

Oga Museveni bin defend di law as e say na for traditional family values, and e add say Uganda no go allow di West to dictate to dem.

For Ghana, parliament bin pass tough new bill for February wey impose prison sentence of up to three years for anyone wey dey convicted of identifying as LGBTQ+.

However, di former president Nana Akufo-Addo no sign am into law, e say im go wait for di courts to rule on im constitutionality.