How three earthquakes hit Afghanistan, kill over 1,000 pipo in six days

Wia dis foto come from, Agence France-Presse/Getty Images
- Author, Joel Guinto
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
One magnitude 5.6 earthquake strike Afghanistan remote south-eastern region on Thursday night, na di third quake in six days, as di death toll from di first continue to rise.
Di quake hit at 20:56 local time (15:36 GMT) and send pipo for Nangarhar and Kunar provinces to begin look for shelters out of fear.
No immediate official report of casualties from Thursday night earthquake, but doctors on ground tell BBC say 17 pipo wey dem bring to Kunar Provincial Hospital injure.
Sunday quake kill 1,368 pipo and injure 2,180 odas, di UN Office for di Coordination of Humanitarian Affairs (OHCA) tok, as e refer to reports from 25 villages.
Di region rough and mountainous area continue to dey rescue and disaster relief operations, govment tok.
Di second earthquake of magnitude 5.5 wey hapun on Tuesday temporarily stop rescue operations, e stop helicopters from accessing di small villages.
"Rescue and search efforts still dey ongoing, dem don set up for pipo in various areas, and di delivery of first aid and emergency supplies still dey go on," Hamdullah Fitrat, deputy tok-tok pesin for di Taliban govment, tok on X.
Di Taliban govment - na only Russia recognise am - don beg for international help. Di UN don release emergency funds, while UK don promise £1m ($1.3m) in aid.
Afghanistan dey prone to earthquakes becos o fdia location on top of di fault lines wia di Indian and Eurasian tectonic plates meet.
For 2023, more dan 1,400 pipo die afta series of 6.3-magnitude earthquakes hit western Afghanistan, near di city of Herat.
Di year bifor dat, one 5.9-magnitude earthquake strike eastern Afghanistan, e kill at least 1,000 pipo and injure anoda 3,000.
Why di recent earthquake dey so deadly for Afghanistan?
Na stress build up from collision of di Indian and Eurasian plates cause di earthquake. About 5.9 in magnitude, according to di US Geological Surve
Dat na equivalent to 475,000 tons of TNT, or 37 times di energy release by di atomic bomb wey dem drop on Hiroshima, according to di US Federal Emergency
One of di reasons why e dey so destructive na becos e dey hapun under di surface of di earth, according to di US Geological Survey measurements.
"Dis part of Afghanistan contain di foothills of di Himalayas," Dr Brian Baptie, seismologist wit di British Geological Survey tok.
"Here, di tectonic plates no dey collide directly, but e dey partly slide past each oda. Di result of dis na say earthquakes in dis region tend to dey more shallow, and so di shaking dey much closer to di surface."
Why so many devastating earthquakes dey hapun for Afghanistan?
Afghanistan dey very exposed to earthquakes bicos di location dey on top a number of fault lines wia di Indian and Eurasian tectonic plates meet.
For October 2023, one 6.3-magnitude earthquake rock di western province of Herat, wey kill about 1,500 pipo, according to di UN.
E dey so destructive sake of say e dey shallow – e hapun at 14km (8.7 miles) under di earth surface.
Di depth of di quake on Sunday even dey shallower, at 8km.
Afghanistan residents also particularly dey vulnerable to earthquakes bicos dem build di buildings dia wit timber, mud brick, or weak concrete, wey no dey earthquake resistant.
Most of di damage from earthquakes for Afghanistan mountains also come from di landslides wey dem dey cause, wey fit flatten houses and block rivers.
Landslides dey also affect roads, wey make am difficult for rescue workers and equipment to reach remote locations.












