Death for Afghanistan earthquake rise to 800 - wetin we know

Injured Afghan man receive treatment for hospital afta earthquake for Afghanistan Jalalabad on September 1, 2025.

Wia dis foto come from, AIMAL ZAHIR/AFP VIA GETTY IMAGES

Read am in 3 mins

More dan 800 pipo don die wit nearly 3,000 wey wunjure afta magnitude-six earthquake strike for eastern Afghanistan just bifor midnight on Sunday.

Dis na according to di United Nations humanitarian agency.

Most of di deaths na from Kunar province, according to officials say wey warn say di death toll fit rise significantly as entire villages don dey destroyed by di quake.

Di epicentre na for remote mountainous area, wia e make am difficult for rescue operations to dey carried out.

"Di scale of devastation dey unimaginable," one Taliban official say.

Di disaster happun as Afghanistan still dey struggle wit serious drought, aid cuts and wetin di World Food Programme describe as an unprecedented crisis of hunger.

According to di Taliban interior ministry report, di magnitude of 6.0 earthquake hit eastern Afghanistan wey cause serious deaths.

Dozens of houses dey "under rubble", sources from di Taliban govment tok, while officials don report say whole villages don dey destroyed.

Locals tell BBC say landslides don cut off areas near di epicentre, and dis one mean say e go take long time to fully assess di damage.

Dem don urge humanitarian organisations to help wit rescue efforts for areas wey dey only accessible by air sake of landslides and flooding.

Di quake, at a relatively shallow depth of 8km (6 miles), shake buildings from Kabul to Pakistan capital Islamabad, more dan 300km away.

Di Taliban govment tok on X say "Local officials and residents dey currently engage for rescue efforts for di affected pipo. Support teams from di centre and nearby provinces also dey on dia way," di statement add.

"Di numbers of di injured and di dead dey likely higher, but since di area get limited access and communication, our teams still dey on ground. Once accurate figures dey collected, God willing, we go share dem wit you," e tok.

Why so many devastating earthquakes dey for Afghanistan?

Afghanistan dey very exposed to earthquakes bicos di location dey on top a number of fault lines wia di Indian and Eurasian tectonic plates meet.

For October 2023, one 6.3-magnitude earthquake rock di western province of Herat, wey kill about 1,500 pipo, according to di UN.

E dey so destructive sake of say e dey shallow – e happun at 14km (8.7 miles) under di earth surface.

Di depth of di quake on Sunday even dey shallower, at 8km.

Afghanistan residents also particularly dey vulnerable to earthquakes bicos dem build di buildings there wit timber, mud brick, or weak concrete, wey no dey earthquake resistant.

Most of di damage from earthquakes for Afghanistan mountains also come from di landslides wey dem dey cause, wey fit flatten houses and block rivers.

Landslides dey also affect roads, wey make am difficult for rescue workers and equipment to reach remote locations.