Dangote Group, Nigerians mourn death of Phyna sister Ruth Otabor

Ruth Otabor

Wia dis foto come from, @RUTHOTABOR/TIKTOK

Read am in 3 mins

Di Dangote Group don express sadness over di death of Ruth Otabor, wey injure for road accident wey involve di company truck for Auchi, Edo State, southern Nigeria.

Ruth wey be sister to Josephine Otabor aka Phyna, wey win Big Brother Naija Season 7, die on Sunday 31 August.

Inside statement wey di company release on Sunday, dem say dem bin get arrangement to fly Ruth to India for advanced medical treatment pending medical clearance from her doctors, bifor she pass on.

"We dey deeply saddened by di passing of Ruth Otabor, wey bin dey injured for di recent road accident wey involve one of our trucks for Auchi, Edo State.

"On behalf of di entire Dangote Group, we extend our heartfelt condolences to her family, friends, and loved ones for di difficult time.

"Since di accident, our officials and insurance partners don dey by her side, covering all financial and medical costs and supporting her family," di company write for dia X handle on Sunday.

"Arrangements don dey made for her to dey flown to India for advanced treatment, pending medical clearance from her doctors. Sadly, despite dis efforts and Ruth brave fight to live, we lose her today."

Dangote Group say safety, accountability, and compassion remain for di core of dia operations.

Di company say dem remain committed to strengthen dia safety system and support dose wey dey affected for moments of tragedy.

"Make God grant her mercy and eternal rest," di statement conclude.

Phyna wey also share di passing of her sister on her social media accounts share di statement from di family lawyer.

According to di statement from Eko Solicitors and Advocate, Ruth die at 6:30Hrs on Sunday.

"With heavy heart, di family regret to announce di passing on to glory of dia daughter, sister, and mother on dis 31st Day of August, 2025 at about 06:30Hrs.

"Di family also request privacy as dem dey grieve.

According to di family, dem go appreciate private moment as dem dey grieve di death of Ruth.

"Di funeral arrangement go dey communicated to di public in due course," di statement add.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Nigerians mourn death of Ruth

Nigerians on social media dey also mourn di passing of Ruth as dem send dia condolences to di Otabor family.

Many of dose wey dey mourn di young lady on X also use di opportunity to seek justice for her.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

"Wit deep sadness, we announce di passing of Ruth Otabor . She bin fight bravely for her life, but now dey at rest. You go forever dey loved ruth.

"Make her soul rest in perfect peace and make God strengthen her family for dis time of grief," Phyna fan page account for X wit di handle @phynation_ write.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Brief background

On August 13, 2025, truck wey belong to Dangote Group hit Ruth near Auchi Polytechnic for Edo State, southern Nigeria.

Dem cut Ruth leg for hospital sake of say di truck crush her leg.

Di accident bin happun only six days afta di young lady bin graduate from Auchi Polytechnic.