Death toll hit 1000 as powerful earthquake hit Myanmar, trap plenty pipo for Thailand

Wia dis foto come from, Getty Images
At least ova one thousand pipo don die and anoda 2,376 dey injured, na wetin officials for Myanmar tok.
Dis na sake of di earthquake wey hit Myanmar and Thailand and tori pipo still dey tok about how e scata di Saigaing region and Mandalay, wey include buildings and temple spires wey fall down flat.
Officials tok say dem beliv say at least 15 pipo still dey alive and dem dey trapped under di rubble of one Bangkok skyscraper wey bin collapse afta di massive earthquake hit Myanmar and Thailand.
Families and friends dey wait wit panic to see weda dem fit rescue dia loved ones.
Rescuers say dem don detect signs of life and also tok wit some survivors wey dey under di 10-storey tall mountain of debris.
Plenti construction workers still dey miss for di site, as di rescue effort enta di second day.

Wia dis foto come from, EPA
Di 7.7-magnitude quake bin happun on Friday afternoon local time, wey bin kill hundreds of pipo for di centre near Mandalay, Myanmar.
Pipo wey dey far far place still feel di powerful effect for di Thai capital, dem also feel am for China and India.
For Bangkok, thousands bin experience di effects of di quake as buildings bin dey shake and water rush come out from swimming pools.
Officials bin tok say dem receive 2,000 reports of cracks wey appear for buildings.
But di effect no dey too much for di capital – except di unfinished headquarters for di auditor-general office, wey still be di focal point of di damage for Thailand.
Di building just dey across the tourist landmark Chatuchak market, di 30-storey skyscraper bin feature a gleaming tower of blue glass and steel once.
Just 12 minutes afta di first earthquake hit Myanmar, di second one strike, according to US Geological Survey.
Di second one get a magnitude of 6.4, less dan di earlier one of 7.7.
Di epicentre dey 18km (11.1 miles) south of Sagaing.
Di normal citizens wey dey help wit rescue efforts around Mandalay area bin tell BBC say dem need equipment.
E tok say, "we dey dig comot pipo wit our bare hands, e no dey enough to comot di bodi and pipo dem wey dey under di rubble."
"Pipo just dey hala,'Help me, help me' I just feel hopeless".
Meanwhile, reports say forty-three construction workers dey miss afta di powerful earthquake cause one unfinished 30-storey building for Bangkok to collapse.
Fifty pipo bin dey inside di building near Chatuchak Park, wey dey hundreds of miles away from di earthquake epicentre for Myanmar.
Seven bin escape while 43 odas still dey trapped, di National Institute for Emergency Medicine tok for Facebook post.
AFP news agency also bin report di 43 pipo wey dey miss, dem quote police.
"Wen I arrive to inspect di site, I hear pipo dey call for help, dem say help me," Worapat Sukthai, deputy police chief of Bang Sue district, tell AFP.
Di building dem plan am for goment offices.
Di Myanmar opposition wey dem dey call di National Unity Government say di earthquake don spoil many buildings wey include heritage, religious and community sites.
Dem say landslides don also happun and don affect key roads and bridges well-well.
For statement wey dem post online, e say dem hold emergency meeting and authorities dey gada reports of causalities and damage as dem dey also find pipo.
Dem also warn say, risk dey say more buildings go collapse and dam failures go happun bicos of structural cracks.
Di National Unity Government bin dey formed for April 2021 by groups wey no like di military junta wey dey in control of Myanmar afta di military coup wey happun for February dat year.
Di US Geological Survey say Myanmar get risk of liquefaction wey fit join cause more damage to buildings and infrastructure.
Liquefaction na di process wia soil wey water don soak finish lose strength and start to dey act like water for earthquakes, according to di USGS.

How big dis earthquake dey?

Geologist measure say na 7.7 on scale wey dem dey call moment magnitude.
Esme Stallard wey be climate and science tori pesin explain am say di moment magnitude scale dey measure di amount wey di plates of di upper laters of di Earth dey move for earthquake and di effort wey e take.
Di USGS wey be di science joinbodi of di US goment say earthquake wey get ova 7 for measurement na strong earthquake and get chance cause ogbonge loss of life and damages wey pass bilions of dollars.
'I panic well-well', Bangkok resident tok

Wia dis foto come from, Reuters
Bui Thu, one BBC journalist wey dey live for Bangkok, tell BBC World Service Newsday programme say she bin dey her house dey cook wen di first quake happun.
"I bin dey very nervous, I panic well-well," she tok. "I bin no know know wetin e be becos e don reach, I tink a decade since Bangkok experience really strong or powerful earthquake like dis."
"From my apartment I just see some cracking for di walls and water splash out of swimming pools and pipo just dey just shout."
Sake of aftershock, she, along wit oda pipo, run enta street.
"We just dey try to wrap our heads around wetin dey going on," she tok.
"Buildings for Bangkok no dey designed for earthquakes, so I feel say na why I think di damage go big."
Wetin we know so far
Di earthquake
- One powerful 7.7 magnitude earthquake hit central Myanmar, according to US Geological Survey
- Di epicentre na 16km (10 miles) north-west of di city of Sagaing, wit depth of 10km, di USGS say
- Thailand and south-west China bin feel strong tremors hundreds of miles away
Di damage
- Buildings dey damaged for Bangkok, and roads scata for Myanmar capital, Naypyidaw
- Buildings for Bangkok usually no dey designed to withstand earthquakes, so di damage fit serious well-well
Goment response
- Thai goment dey holding emergency meeting.
Roads crack and building scata for Myanmar
Checkout some images now from Naypyidaw, di capital of Myanmar.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Reuters
Why updates from Myanmar dey difficult to get
Na military junta dey rule Myanmar since di coup wey happun for 2021, sake of dis, access to information dey difficult. Di state dey controls almost all of local radio, television, print and online media.
Internet use also dey restricted.
Also e be like say Communication lines dey down as BBC no fit get through to aid agencies wey dey ground.
How common earthquakes be for Myanmar?
Earthquakes dey more common for Myanmar, compared to Thailand.
Between 1930 and 1956, na about six strong quakes of 7.0 magnitude near di Sagaing Fault don happun, wey run through di centre of di kontri , AFP news agency report, dem cite USGS.
Thailand no be earthquake zone and nearly all earthquakes wey dem don feel dia, wey dey rare, na from neighbouring Myanmar.
As buildings for Bangkok no dey engineered for powerful earthquakes, di structural damage fit dey significant.
'I feel di earthquake for a long time,' Yangon resident tok
Soe Lwin, for Yangon, Myanmar largest city, say im bin feel di earthquake for a "long time".
But, im say e no dey like say widespread damage dey for di downtown area of di former capital.
Im add say residents dey worried about di potential for another, bigger earthquake in di coming days.
State of emergency declared in six regions of Myanmar
Di military junta wey dey rule Myanmar since one coup for 2021 don declare a state of emergency for di regions of Sagaing, Mandalay, Magway, Bago, Easter Shan state and Naypyidaw, according to local media reports.
For one statement wey we don see, dem add say officials go investigate di damages and begin coordinating rescues for affected areas.









