Wetin we know about di tourist submarine wey sink and kill pipo for di Red Sea

Tourist submarine sink for Egypt

Wia dis foto come from, Sindbad Submarines

Read am in 4 mins

At least six pipo don die, and nine odas injure afta one tourist submarine sink off di coast of di Egyptian Red Sea city of Hurghada for di early hours of Thursday, 27 March.

Moscow embassy for Egypt for one statement on dia Facebook page tok say, about 45 passengers bin dey on board di submarine, including children, and dem believe say all of dem be Russian.

One Russian official for Hurghada, Viktor Voropaev, say at least five Russians die for di submarine accident, including two children.

Voropaev - wey be Russia consul general for di Red Sea resort - bin dey follow Tass, di state-owned Russian news agency tok.

BBC reporters for Egypt say fear dey say na six pipo die.

Wetin we know so far

Ambulances don gada for Hurghada, afta one tourist submarine sink off di coast of popular resort.

Wia dis foto come from, SUPPLIED

Who: At least six pipo don die, nine injure and dem don rescue 39 pipo. Red Sea Govnor Amr Hanafy tok say 45 passengers bin dey on board di submarine, plus five Egyptians. E say di passengers come from Russia, India, Norway and Sweden. E say di six pipo wey die for di submarine accident na Russians.

What: Believe dey say na Sindbad Submarines dey operate di vehicle, and di submarine don dey run tourist trips for several years.

When: Di incident happun dis morning at around 10:00 local time, according to di Russian embassy.

Where: Sindbad, di submarine, bin sink close to di harbour in Hurghada, one popular tourist resort for di Red Sea wey dey known for dia beaches and coral reefs.

How: We neva know wetin make di submarine sink, but our teams for London and Egypt dey try find out wetin happun.

Where di submarine sink

Di tourist submarine bin sink off di Egyptian Red Sea city of Hurghada early on Thursday, di BBC understand.

E sink close to di harbour.

Di city na popular tourist destination wey dey known for dia beaches and coral reefs.

Map wey show where di submarine take sink

Wetin we know about Sindbad - Di submarine wey sink

Sindbad Submarines

Wia dis foto come from, SINBAD SUBMARINES

Wetin we call dis foto, One foto on di Sindbad Submarines website - BBC no fit confam if dis na di exact type of boat wey involve for di incident

Sindbad don dey operate tourist trips for di Hurghada area for several years.

Di company tok say dem get only two out of di "14 real recreational submarines" for di world.

Di company dey allow tourists travel 25 metres (82 feet) deep for inside di sea to explore "500 metres of coral reef and dia marine inhabitant".

For di website for Sindbad Submarines, dem write say: "Dem dey offer 44 passenger seats - two pilots' seats and one sizable round viewing window for each passenger."

Egypt Red Sea coast get history of tourist boat accidents

Dis no be di first-time tourist boats go sink for Hurghada.

For November 2024, one tourist boat wey di name na Sea Story bin sink, leaving 11 dead or missing - including one British couple, and 35 pipo survive.

At di time, Egyptian authorities bin tok say na one huge wave wey dey up to 4m (13ft) cause di incident - but BBC follow some survivors tok and dem say, safety issues dey.

For February, UK investigators tok say 16 incidents wey involve "liveaboard" vessels don happun for di area in di last five years, wey lead to deaths.