Tinubu na di president of Nigeria wey don travel pass?

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don start im vacation as part of im annual leave for 2025 wey begin on Thursday.
For statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga sign, President Tinubu go spend 10 days working vacation between France and di United Kingdom.
Onanuga say, "President Bola Ahmed Tinubu go comot from Abuja on Thursday September 4, to commence working vacation for Europe, as part of im 2025 annual leave. Di vacation go last for ten working days."
"President Tinubu go spend di period between France and di UK and den return to di kontri."
Some of di trips Tinubu don make since e become president
President Tinubu dey travel well-well and dis na one of dos travels wey im dey always go since im enta office for May 2023.
Dis 10 days working vacation dey come afta President Tinubu bin take vacation for October 2024.
Na dis same working vacation and im bin spend more dan two weeks for UK and France.
Record show say President Bola Tinubu first 17 months for office, im and Vice President Shettima don make 41 trips across 26 kontri and dem spend180 days abroad.
Im latest trip na for Brazil dis August 2025, wia im meet President Luiz Inácio Lula da Silva, dis na afta e go Japan to attend di Tokyo summit wit oda world leaders..
Bifor den, di president bin don travel go United States, France, di United Kingdom, China, South Africa, Germany, Tanzania, and di United Arab Emirates.
For January 2025, Tinubu also attend di Africa Heads of State Energy Summit for Dar es Salaam, Tanzania
For May 2025, im bin travel go Rome, Italy, to attend di inauguration of Pope Leo XIV, one ceremonial visit.
For June–July 2025, im bin visit Saint Lucia for state visit to strengthen ties wit Caribbean nations.
For June–July 2025, im bin travel to Brazil for state visit to enhance cooperation for trade and agriculture.
For August 2025, im attend di inauguration of President John Dramani Mahama for Ghana, one diplomatic visit.
August 2025, im bin stopover for di UAE, like Dubai, wen im dey go Japan.
For August 2025, im bin attend di Ninth Tokyo International Conference on African Development for Yokohama, Japan, for investment and bilateral ties.
For August 2025, im bin go back to Brazil for a second state visit to advance agriculture and aviation agreements.
How oda presidents for Nigeria bin travel
Some Nigerians dey tok say President Bola Tinubu go soon becom di president wey travel pass oda presidents.
But make we chook eye for di travels wey former presidents like Goodluck Jonathan, di late Muhammadu Buhari, and Olusegun Obasanjo make.
As at May, 2023 few weeks bifor e comot we see say inside di eight years wey di late Muhammadu Buhari be president, e travel out 53 times for official assignments but e spend more time for obodo oyibo on medical trips.
During im tenure former President Goodluck Jonathan bin travel well-well even though im bin promise to reduce im trips.
Tori be say oga Jonathan bin travel at least 20 times for im first 11 months for 2012.
Former President Olusegun Obasanjo travel go 97 during im tenure as president between 1999 and 2007.
OBJ as pipo dey like to call am bin tok say im trips na majorly sake of saving Nigeria image at di time e be president.









