Former Nigeria president, Muhammadu Buhari die at 82

Muhammadu Buhari lead Nigeria two times for e lifetime

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Former Nigerian President Muhammadu Buhari don die at di age of 82.

Former presidential spokesman Garba Shehu say ex-president Muhammadu Buhari die for one hospital for London.

Buhari serve as military general in di 80's and elected president twice afta di kontri return to civilian rule in 1999.

Dem bin overthrow im goment in 1985 by di den General Ibrahim Babangida.

E die two years afta e comot from office in 2023. E bin serve as president from 2015-2023.

Dem go bury di former president under di islamic rites, politicians and oda key political actors go pay dia respect to di deceased family.

President Tinubu don order Vice President Kashim Shettima to travel go United Kingdom to accompany President Muhammadu Buhari body back to Nigeria for burial.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

President Tinubu order national flags to fly at half-mast for seven days

Nigeria President, Bola Tinubu don order all national flags fly at half-mast across di kontri for seven days, from Sunday 13 July to 20 July.

E add say di Nigeria goment go give President Buhari full state honours wey befit im full contributions to di kontri.

E also say im don call for emergency Federal Executive Council session on Tuesday, to honour am.

For im tribute, Tinubu describe di former Nigeria leader as a "very core, patriot, soja, a statesman. Im legacy of service and sacrifice endure. E serve Nigeria wit unwavering dedication, first as a military leader from January 1984 to August 1985, and later as a democratically elected President from 2015 to 2023. Duty, honour, and a deep commitment to di unity and progress of our nation define im life.

"E tanda firm through di most turbulent times, leading wit quiet strength, profound integrity, plus unshakable belief in Nigeria potential. E champion discipline in public service, confront corruption head-on, and put di kontri above personal interest at every turn." President Tinubu tok for statement.

We honour im service. We reflect on im legacy. And we pray for di peaceful repose of im soul, e add.

Muhammadu Buhari profile

Foto of Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, AFP

Nigeria former president, Muhammadu Buhari na Muslim from di northern region and e bin serve as di immediate president from 2015-2023.

E also rule as military general from December 1983 to August 1985.

Dem born Buhari in December 1942, for Katsina and e be di second president wey rule twice during pre-democracy and afta democracy.

Buhari enta goment in 1976 as minister under under Olusegun Obasanjo, di former military ruler. Den im rule as military ruler from 1983 to 1985.

Before dem overthrow in goment in August 1985, and dem jail am for 40 months.

E enta politics to contest for president in di 2003 and 2007 elections but e no win until 2015 election.

E become di president in May 2015 and e serve for 8 years wey be two tenures.

World leaders pay tributes to late Muhammadu Buhari

Plenty tribute don pour in from all ova di world following di death of Nigeria former President Muhammadu Buhari.

Di Chairperson of di African Union Commission, H.E. Mahmoud Ali Youssouf, on behalf of di African Union Commission and di wider African Union family, don tok sorry to di Government and pipo of Nigeria, and di bereaved family of late President wey die on Sunday, 13 July at di age of 82.

For statement, Oga Youssouf say di African Union stand gidigba wit di pipo of Nigeria for dis period of national and collective grief.

"President Buhari go dey remembered as a principled and resolute leader wey serve Nigeria wit honour and conviction. Throughout im tenure, e remain a committed Pan-Africanist—an advocate for regional integration, good governance, and African-led solutions to di continent pressing challenges. E be ogbonge supporter of multilateral cooperation and a tireless champion of peace and stability across Africa," di Chairperson tok.

Speaker of di House of Representatives Abbas Tajudeen say di passing of former President Muhammadu Buhari na heavy blow.

Baba Buhari pass former Head of State and ex-President. E be symbol of discipline, modesty, and incorruptibility - man wey im life journey na service to Nigeria, Oga Tajudeen tok for statement.

Ecowas President

For im condolence message, ECOWAS Commission President Omar Alieu Touray, praise di legacy of Buhari, describe am as a "distinguished statesman wey get invaluable contributions to greatly advance democracy and regional integration for West Africa and across di African continent."

President Cyril Ramaphosa of South Africa

South African President Cyril Ramaphosa don also offer im "deep condolences to di family, friends, former colleagues and associates of di late President Buhari."

President Ramaphosa say: "As South Africa, we stand wit di nation of Nigeria for your mourning. President Buhari led Nigeria na patriot and a champion not only of di best attributes of im nation during im leadership, but of di future wey await im great kontri."

Mr. Ramaphosa reveal say e don work closely wit di former Nigerian leader on building relations between both kontrid and bin share numerous reciprocal visits - including during di COVID-19 pandemic.

"Dis engagements dey dedicated to increase cooperation for areas such as arts and culture, education, agriculture, trade and investment, mining, defence, immigration and science and technology," di president add.

President Julius Bio of Sierra Leone

Also, Sierra Leone president Julius Maada Bio describe Buhari death as a "devastating loss".

E extend im condolences to di late president family, incumbent President Bola Tinubu and di pipo of Nigeria.

Akinwumi Adesina

On im part, former president of di African Development Bank (AfDP), Akinwumi Adesina, tank Buhari for im "leadership, patriotism and selfless service to Nigeria".

E also tank am "for your love and support for me", praying make God comfort im wife and family.

Buhari nominate Adesina for reelection as AfDP president for 2019.

More tributes still dey come in for late Buhari.