Pope Francis don die at di age 88

Wia dis foto come from, Getty Images
Pope Francis don die on Easter Monday at di age of 88 for im house for Casa Santa Marta, for Vatican City.
Na di Vatican announce di death of di Pope through im Eminence, Cardinal Farrell.
"Dearest brothers and sisters, wit deep sorrow I must announce di death of our Holy Father Francis.
"Im teach us to live di values of di Gospel with fidelity, courage and universal love, especially in favour of the poorest and pipo wey dey marginalised."
Farrell add: "Wit immense gratitude for im example as a true disciple of di Lord Jesus, we commend di soul of Pope Francis to di infinite merciful love of di One and Triune God."
Di Pope death dey comes less dan 24 hours afta im bin show face for Vatican St Peter Square for Easter Sunday.
Im bin come out wit wheelchair and wave from di balcony of St Peter Basilica to crowds wey bin dey hail am back and im say: "Dear brothers and sisters, Happy Easter."
Di pontiff death no only follow di most important calendar event for Catholics, but e fall into di special jubilee year, wey dey come around evri 25 years.
Di jubilee bin kick off wen di Pope bin open di usually ogbonge Holy Door for St Peter Basilica on 24 December, wey see millions of pilgrims come to di Vatican to pass through di doorway and seek forgiveness for dia sins.
Tens of thousands of Catholics bin gada for di Easter Mass for dis special year.
Na for March 2013 dem elect Cardinal Jorge Mario Bergoglio to lead di Catholic Church afta Pope Benedict XVI bin step down.
Wetin go happun next wen Pope die?
Traditionally, Pope burial na ogbonge affair, but Pope Francis recently approve plans to make di whole procedure less complex.
Dem bury di previous Popes for three nested coffins wey dey made of cypress, lead and oak.
Pope Francis choose a simple wooden coffin lined wit zinc.
Im also scrap di tradition of placing di Pope body for raised platform - wey dey known as a catafalque - for St Peter Basilica for public viewing.
Instead, mourners go dey invited to pay dia respects while im body go remain inside di coffin, dem go remove di lid.
Francis go also be di first Pope for more dan Century wey dem go bury outside Vatican.
Dem go bury am for Basilica of St Mary Major, one of four major papal basilicas for Rome.
Pope Francis rise from Buenos Aires to Catholic Church leader

Wia dis foto come from, Reuters
Pope Francis name na Jorge Mario Bergoglio, dem born am for Buenos Aires, Argentina, on 17 December 1936.
Na im be oldest of five children, im parents bin run comot from Italy to escape from di evil of fascism.
Im enjoy tango dancing and become a supporter of im local football club, San Lorenzo.
Im bin dey lucky to escape wit im life afta im bin get serious pneumonia, wey dem do operation to remove part of one of im lungs. E leave am prone to infection throughout im life.
As elderly man, im bin also suffer from pain for im right knee, wey im bin describe as a "physical humiliation".
Di young Bergoglio bin work as nightclub bouncer and floor sweeper, bifor im graduate as chemist.
For one local factory, im bin work closely wit Esther Ballestrino, wey bin campaign against Argentina military dictatorship. She suffer from torture, till today dem no find her body.
Im become a Jesuit, wia im study philosophy and teach literature and psychology. Ten years later dem ordain am, im win swift promotion, to become provincial superior for Argentina for 1973.
Pope Francis health challenges for im final months
For di final months of im life, di Pope ill-health see am spend several weeks for hospital.
On 14 February, dem carry di 88-year-old go Gemelli hospital for Rome for treatment for pneumonia for both lungs. Im bin dey experience difficulties breathing for several days.
Dem discharge am from hospital on 23 March.
Di pontiff bin dey particularly vulnerable to pneumonia, wey be infection of di lungs wey dey caused by bacteria, viruses or fungi, afta im bin do a partial lung removal as young man.
How African and oda world leaders take react to di death of Pope Francis
Di world dey react to di death of Pope Francis wey die on Monday at di age of 88.
For Africa, presidents and head of states don react to di passing of di Pope.
Since Pope Francis become di pontiff for March 2013, e don travel to some African kontris wey include Kenya, Uganda, Egypt, South Sudan, Democratic Republic of Congo and di Central African Republic (CAR).
Nigeria president
For Nigeria, President Bola Tinubu tok say di Pope na instrument of peace wey deeply embody di message of Christ: "love for God and love for humanity."
President Tinubu tok say di Pope "build bridges between faiths and di rich and di poor". E praise di pontiff for being advocate for developing kontris, as di Pope dey tok against economic injustice and e dey pray for peace and stability for regions wey dey troubled.
Kenya president
Kenyan President William Ruto tok say im join di Catholic Church and di global Christian community to mourn di passing of Pope Francis.
E announce say dis na big loss to di Catholic faithful and di Christian world. "We go remember Pope Francis for a life dedicated to serving di Lord, di Church, and humanity."
Senegal president
Senegalese President Bassirou Faye tok say di Pope death na major "spiritual loss to di world". E pay tribute to di Pope commitment to help di most vulnerable.
Ghana president
President of Ghana John Mahama extend im heartfelt condolences to di Roman Catholic Church and all Catholic faithful for Ghana during dis time of profound grief.
E tok say di Pope "legacy of compassion, humility and commitment to social justice go continue to inspire generations. Im leadership and advocacy for di poor and marginalisation resonate deeply".
Togo president
Faure Gnassingbé tok say di Pope na tireless architect of peace, justice and fraternity and add say im death "go leave profound mark on our humanity".
Di president tok say di pontiff "commitment to di most vulnerable and im constant call for human dignity go remain for our memories".
Ethiopia prime minister
Abiy Ahmed ontop im X page extend im condolence to di Catholic church on di passing of Pope Francis.
E tok say di "legacy of compassion, humanity and service to humanity go continue to inspire generations to come".
Tributes from oda leaders:
- Dutch Prime Minister Dick Schoof say "Pope Francis na man of di pipo".
- European Parliament President Roberta Metsola say "im contagious smile totori millions of pipo hearts across di globe".
- Israeli President Isaac Herzog hail im "boundless compassion".
- Swiss President Karin Keller-Sutter say Pope Francis na "great spiritual leader, and a tireless advocate for peace".
- Scottish First Minister John Swinney describe am as "voice for peace, tolerance and reconciliation".
- French President Emmanuel Macron call am "man of humility, wey dey on di side of di most vulnerable and most fragile".
- White House say "Rest in Peace, Pope Francis".
- Egypt President Abdul Fattah al-Sisi say Pope Francis "na voice of peace, love and compassion".










