Pope make first major appearance to wish worshippers Happy Easter afta serious illness

Wetin we call dis Video, Pope Francis wish Catholic faithful 'happy Easter' from Vatican city
    • Author, Hafsa Khalil
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Pope Francis di Bishop of Rome, don appear for Vatican St Peter Square to wish "Happy Easter" to thousands of worshippers.

Di 88-year-old Pope come out for wheelchair, wave from di balcony of St Peter Basilica to crowds wey dey hail am from below.

Di Pope look sick as im say: "Dear brothers and sisters, Happy Easter."

Na anoda father bin deliver in traditional Easter address.

"Peace no fit dey without freedom of religion, freedom of thinking, freedom of expression and respect for oda pipo views," di father tok, as di Pope sidon beside am.

Di Pope message na dat of hope, peace and "trust in odas".

"Wat a great thirst for death, for killing wey we dey see for many conflicts wey dey happun for different parts of di world," di Pope tok for im address.

Pope Francis mention wars around di world, remembering pipo of Gaza, in particular im Christian population, as di conflict "cause death and destruction" and create "deplorable humanitarian situation".

"I express my closeness to di sufferings... for all di Israeli pipo and di Palestinian pipo," di message say, come add im appeal to all: "Call a ceasefire, release di hostages and come to di aid of pipo wey dey starve wey want a future of peace."

Afta dem give di blessing, dem drive di Pope around di square inside one white roofless motor.

As im dey pass through di crowd wey dey hail am, im procession pause many times as pipo carry dia baby come meet di Pope to bless dem.

E don tey wey pipo don dey wait for am to appear since dem discharge am from hospital afta five weeks of treatment for one infection wey bin lead to double pneumonia.

Pope Francis speak from one balcony, on di day of "Urbi et Orbi" (to di city and to di world) message for St Peter Square, on Easter Sunday, for Vatican, on 20 April, 2025

Wia dis foto come from, Reuters

During dat time, doctors say im go need at least two months of rest for im house.

Before di Sunday celebrations, na only two times dem bin don see am dis week.

Di head of di Catholic Church wey still dey recover from im sickness, bin present "two very critical episodes" wia im "life bin dey in danger" wen im bin dey hospital, according to one of di doctors wey bin take care of am.

Dr Sergio Alfieri add say dem bin no ever put di Pope for ventilator, and always im bin dey alert and wit clear mind for hospital.

Thousands of Catholics gada for Rome

Tens of thousands of Catholics gada for Rome for Easter Mass during dis special jubilee year, wey dey occur every 25 years and wey dey witness millions of pilgrims descend on di city.

Di jubilee year begin wit di Pope opening di usually bricked-up Holy Door for St Peter Basilica on 24 December. Catholics believe say passing through dat door go free dem from dia sins.

For di first time since im become pope for 2013, im miss majority of Holy Week events, including Saturday Easter vigil for St Peter's Basilica, wia im bin assign im duties to cardinals.

But, during dat short time wey im show inside di basilica on di day, im bin pray for and give sweets to children.

Pope Francis, wey from Argentina, don suffer many health issues throughout im life, including removing part of one of im lungs at age 21, and dis one make am more prone to infections.

On Sunday morning, US Vice-President JD Vance wey be devout Roman Catholic wey convert for adult age – bin do brief meeting wit di Pope.

One handout picture wey Vatican Media provide show Pope Francis meeting wit US Vice President JD Vance on Easter Sunday for Vatican, 20 April 2025.

Wia dis foto come from, VATICAN MEDIA HANDOUT/EPA-EFE

Wetin we call dis foto, US Vice-President JD Vance briefly met the Pope on Easter Sunday

Vance land Rome on Friday and on Saturday, meet wit di Vatican Secretary of State and Secretary for Relations with States and International Organisation.

During di meeting, di two sides say dem want to continue "good existing bilateral relations", di Vatican say for one statement.

"Dem exchange opinion on di international situation, especially regarding kontris wey war dey affect, political tensions and difficult humanitarian situations, wit particular attention to migrants, refugees, and prisoners," di statement tok.