Pastor Bakare, Atiku, Bishop Kukah, knock Tinubu over high insecurity, poor leadership

Pastor Tunde Bakare and President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Latter Rain Assembly/Ministry of Information/Facebook

Read am in 4 mins

As Nigeria join pipo for all over di world to celebrate Easter, prominent pipo for di kontri don use dis opportunity to appeal to dia leaders make dem embrace di principles of charity, sacrifice and love for pipo wey dem dey lead.

Pastor Tunde Bakare wey be di presiding overseer of di Global Community Citadel Church don condemn all di attacks wey happun recently for Edo, Benue, Plateau, Zamfara, Borno and oda states for di kontri.

For im state of di nation broadcast on Sunday, e reveal say communities don dey form "unprofessional militias" as odas dey take law into dia hands bicos dem don lose faith say goment fit to keep dem safe.

E say di security situation for di kontri dey dangerous path and im call for full reform if di national security architecture.

E say di nation security kasala na bicos of fundamental structural defect wey di constitution design.

"We must to redesign our architecture by say we arrange for di formation of zonal security councils wey govnor from di zone go lead on rotating basis". E add say di zonal security councils must dey managed by non-paritsan security sabi pipo.

E also torchlight wetin dey happun for Rivers State wia di president declare state of emergency as im call di National Assembly wey approve di action as di most "spineless" for Nigeria recent history.

E also challenge di National Assembly say dem suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan bicos she bin ask for accountability from di Senate President Godswill Akpabio.

Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala hail oga Bakare tok-tok say e dey objective.

E say, "even though we no gree for some areas and position, but we respect im right to tok m mind and assure am and many Nigerians say President Tinubu dey determined to deliver im promise give di Nigerian pipo."

Bishop Hassan Kuka

Wia dis foto come from, Catholic Diocese of Sokoto

For im Vigil Mass preaching, di Bishop of di Catholic Diocese of Sokoto, Bishop Matthew Hassan Kukah, beg Nigeria President Bola Tinubu make im bring im kontri pipo from di cross of suffering wey dem dey face.

Di Bishop wey use metaphor of di cross to describe di suffer wey Nigerians don carry dia eyes see in recent years, say di kain suffer wey dey ground now, "dey marked by culture of brutality and wickedness wey eye neva see for di history of our dear kontri."

Di man of God say situation dey reach breaking point as Nigerians dey dangle and bleed on dis cross of suffering for too long.

Former Nigeria Vice President Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, @atiku/X

Nigerians need proper end to insecurity especially food insecurity, an giving dem "mere palliative" dey "diminish di dignity of citizens, im add.

For im own message to Nigerian Christians dis year, di former Vice president of di kontri and di Peoples Democratic Party candidate for 2023 general elections, Atiku Abubakar, call for national unity.

"Our strength as a pipo dey for our togetherness. Kontri wey dey united go always fit endure flourish.

"Dey guided by di principles of sacrifice, love, and charity. Na only through sincere collabo we go fit heal our divisions and renew our national hope," im tok.

Plateau state Govnor Caleb Mutfwang express confidence say di state go overcome im present security challenge and come out stronger.

"Dis na di time to rise above our differences and draw strength from our diversity in Christ. Together, let us rebuild and reclaim Plateau, a land of peace, promise, and great potential" Govnor Muftwang tok.

Presidential candidate of di Labour Party during di 2023 elections, Peter Obi for im own message bin ask Nigerian Christians to use di Easter period to pray for compassionate leaders who go share in dia pains.

E say di compassionate leaders dey always think of di pipo and di consequences of dia actions and inactions.

"Diafore, no better time to pray for tender-hearted and caring leaders for our kontri dan for Easter, wen we see in Jesus a remarkable, compassionate leader.