In fotos: How Christians celebrate Good Friday across di world

Man dress as Jesus Christ stands at di cross during Good Friday street theatre performance by Wesley Mission volunteers at Martin Place on April 18, 2025 in Sydney, Australia.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Man dress up as Jesus Christ stand at di cross during Good Friday for Australia.
Read am in 4 mins

Good Friday na di Friday bifor Easter day. Evri year, Christians dey observe di remembrance of di crucifixion and resurrection of Jesus Christ.

Beginning from early days of Christianity, Christian believers dey observe Good Friday as a day of sorrow, day of repentance and fasting.

Dis year 2025, Good Friday fall on 18 April.

Although dis day na day of sorrow for Christians, di weekend of Good Friday na di most important weekend for di history of Christianity.

Believers of dis faith believe say na di day wey Jesus Christ die for dia sins, and dem bury am and im rise up on di third day as conqueror of sin and death.

Foto of man nailed to di cross for Bulacan province, Philippines.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Asia most Catholic nation, di Philippines observe Good Friday
Christians dey participate in di religious procession on Good Friday for India

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Women gada to celebrate Good Friday for Chennai, India
Good Friday performance for Paombong, Bulacan province, Philippines.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Good Friday public performance for Martin Place Amphitheatre for Sydney, Australia, as dem bring di tori of Jesus sacrifice to life.
Foto of di foto of one of di performer wey dem nail to di cross for Good Friday crucifixions

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Filipinos celebrate Good Friday.

Why dem dey celebrate Good Friday

Pctures of di hand of one man wey dem tie to di cross during Good Friday for Australia.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For Australia, dem tie one man to di cross during Catholic church presentation
One performer nailed to the cross in an Asian most Catholic nation, the Philippines

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Filipino Catholic demonstrate how dem nail Jesus Christ to di cross on Good Friday.
Foto of performer as dem dey nail am to di cross

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Asia most Catholic nation, di Philippines observe Good Friday.

Jesus die on di cross on Good Friday, di Bible tok, and e resurrect on Easter Sunday.

Di Bible also record say dem beat Jesus publicly and force am to carry heavy wooden cross through di streets as di crowd dey publicly shame am.

According to di Bible, dem nail Jesus to di cross by di wrists and feet, wia e die. Now, Christians see im death as sacrifice to absorb di sins of humanity and allow im followers to get relationship wit God, im papa, and access to heaven.

For Nigeria, several churches also enta di streets to demonstrate how Jesus bin suffer bifor im die.

Dem carry one performer wit stretcher afta dem nail am to di cross during Good Friday crucifixions for Philippines.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Good Friday street theatre performance for Philippines.
One performer wey dem dey whip as Jesus Christ during Good Friday rites in di village of Kapitangan For Philippines.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For Philippines, dem dey whip one performer wey play di role of Jesus Christ on Good Friday